Waec release result wit 61.54% pass rate

Nigerian students dey write during class for Lagos school.

Wia dis foto come from, James Marshall

Published
Read am in 3 mins

Di West African Examinations Council (Waec) don release di results for di 2026 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) for candidates wey write di exam.

Josiah Dangut, di head of Waec for Nigeria, tok say total of 1,200,514 candidates, wey be 61.54%, get credits and above for at least five subjects, including English and Mathematics, out of di 1,950,726 candidates wey sit for di examination.

Di number of candidates wey get credits for five subjects, including English Language and Mathematics, drop by 2.26 percentage points wen you compare am wit di 1,239,884 candidates, representing 62.96%, of di pass rate from di 2025 WASSCE.

Dangut tok say dem don release result for 1,834,695 candidates, about 94.05%, but dem neva process di result of 116,031 candidates, wey be 5.95%.

E tok say 1,213 candidates wey dey live wit disabilities register for di exam, including 137 wey no fit see, 491 wey get hearing problem, 55 wey dey spastic and mentally challenge, also 41 wey dey physically challenged.

E tok say dem fit withold result of 167,486 candidates, wey be 8.59%, becos of examination malpractice.

Dangut tok say di number dey 1.11% points lower dan di 9.7% wey dem record for 2025.

E tok say di council withold di results becos of di examination malpratice, including di way people dey use mobile phones for exam hall despite di ban and organised cheating for some schools.

How to check Waec result?

To check your Waec result, visit www.waecdirect.org and log in.

You go need Waec scratch card to check your result.

Login to WAEC Result Checker Website www.waecdirect.org.

Enter your Examination Number

Select Examination Type e.g May/June

Select Exams Year e.g 2026

Click on Check Result.

Who dey mark Waec results

No be Waec dey mark students examination paper, na examiners Waec dey appoint to mark di scripts.

Dis examiners na sabi pipo for di education sector wey sabi classroom work well-well.

To ensure say mago-mago no dey for di grading system, Waec dey set up committee of experts wey go come up wit di marking guide.

Dem dey organise di examiners into small groups and each of dem go dey supervised by one highly experienced examiner wey be di Team Leader.

Na di Team Leader dey check and vet di group members marking progressively to make sure say dem dey follow di guidelines. Dem kon also get Chief Examiner.

Wen dem don mark finish, Waec go still employ anoda group of pipo - dose ones dem dey call dem Checkers.

Wetin to know about Waec?

Di West African Examination Council na international exam for senior secondary school student wey dey happun evri year.

Kontris wey dey write Waec na Nigeria, Ghana, Gambia, Liberia, and Sierra Leone.

Na for 1952 dem establish am. According to information on top dia website, di vision of di West African Examinations Council na to be world-class examining body wey dey add value to di educational goals of im stakeholders.

Waec na West Africa ogbonge examining board wey dey established by law.

Dia work na to set, conduct di examinations and to award certificates wey dey comparable to dat of equivalent examining authorities internationally for di English-speaking West African kontris.