Wetin we know about students attack on headmaster sake of ritual allegations for Ghana

Heavy police presence on campus

Wia dis foto come from, OBUASI SHTS

Wetin we call dis foto, Students destroy cars, furniture and oda tins for di school campus during di chaos
Published
Read am in 4 mins

Some students of di Obuasi Senior High Technical school don allegedly attack dia headmaster for Wednesday dawn.

Dis na afta dem accuse am say im dey do rituals for di night on campus.

Some of di students bin tok say dem see am when im dey do some tins wey resemble rituals, at midnight.

Inside one viral video on top social media, some students bin dey hit di man, some dey shout, odas dey threaten to harm am.

Di man even injure for head wey im dey bleed as di students continue to attack am.

For im blue jalabia im try to dey explain sometin to di students, but dem no dey listen.

According to tori, police bin enta di school campus to rescue di headmaster from more attack wey dem bin calm di situation.

Di head of security for di school campus for one interview wit local blogger PN Media, tok wetin im see during di chaos.

"I bin dey inside di room wey I hear loud noise, na so I comot to see wetin dey happun. I see plenty students wey dem dey shout; some dey carry machete and sticks, dem even destroy some school property."

"I bin dey lucky say dem no harm me, I get only small wound for my elbow. But I bin lock di school gate at dat time, dem no fit comot. But dem throw stones, and oda tins for some time bifor dem comot to dia dorms," di security man explain.

Im also add say "about four police patrol teams bin arrive for hia but by dat time, dem don destroy di headmaster im house.

Di students also smash some cars, scata bags of cement and destroy school furniture during di chaos.

Sources for di Ghana Education Service (GES) say di mata don come to dia attention wey dem dey chook eye for di case.

Heavy police presence bin dey di campus.

Student attacks for high school campus dey happun often

Di latest incident dey come at di time di kontri dey battle wit indiscipline and oda tins for Senior High Schools.

For March dis year, one Circuit Court bin fine three students afta dem assault one teacher for di West Africa Senior High School for Adenta.

Di court also order di students to sign bond of good behaviour.

For May, di Ghana National Association of Teachers (Gnat) raise wahala about military attack on three teachers for Tarkwa for di Western Region.

For 2024 some students of Christian Methodist School bin attack da teachers afta dem write dia exam; dem accuse di teachers say dem be "too strict" during di invigilation for di exam.

Only for 12 June, di Director General for di Ghana Education Service bin condemn di indiscipline for high schools.

Professor Ernest Kofi Davis tok say di recent incidents of student misconduct dey worry.

Di Education service last month say dem go roll out tougher punishment for student indiscipline including possible jail term.