Wetin dey happun for Osun as Govnor Adeleke cry out to Tinubu

man on yellow cap wit red mic and blue cloth look front, and man wey wear cap fold hand dey im side.

Wia dis foto come from, Ademola Adeleke / Bola Tinubu

Published
Read am in 4 mins

Di political tension for Osun State dey grow day by day as di govnorship election dey draw close wit major aspirants trading words and accusation including security breakdown, but wetin really dey happun?

Current Govnor Ademola Adeleke under Accord party dey call on Nigeria President Bola Tinubu to chook eye for di situation wey dey go on for di state.

Govnor Adeleke say Osun dey bleed and some sets of pipo dey try intimidate di pipo ahead of di election.

"Di loss of innocent lives for Osun gatz stop. All we dey ask for na simply free and fair election."

Dat na wetin Govnor Adeleke tok wit loud voice wen e dey address im pipo for Osun state.

"We no go gree for rigging for Osun. We want free and fair election. I be di Chief Security Officer of Osun State, President Tinubu, Osun no go gree for rigging, we go come out to vote."

In recent days for Osun State, different breakdown of law and order don happun, wey include attacks on individuals and destruction of properties.

"Mr. President gatz act as di father of dis nation and help safeguard di democracy wey e fight for."

Wetin dey happun

Di race na between di top three candidates Najeem Salaam of di African Democratic Congress (ADC), Ademola Adeleke of Accord and Bola Oyebamiji of di All Progressives Congress (APC).

Salaam of ADC dey backed and get support of former Osun govnor and former Nigeria minister of Interior, Rauf Aregbesola- wey also be di national secretary of di ADC.

Adeleke on di oda hand na di incumbent govnor wey enta under di Peoples Democratic Party (PDP) but later decamp to Accord party.

Oyebamiji get di backing of di ruling APC and di former govnor of Osun State and current Minister of Marine and Blue Economy, Gboyega Oyetola.

Dis big names for di contest don make di election race get more interest, but also wit various attacks wey we no fit identify and independently verify who dey attack who.

On 30 July, 2026, di Peace Accord signing ceremony take place for di state capital wia political stakeholders, security agencies, Inec, and civil society organisations, dey present.

Na dia di political parties sign say dem go dey peaceful during di election and dem no go allow violence.

For July, Osun govment under Adeleke bin announce ban on all activities of di National Union of Road Transport Workers (NURTW) for motor parks across di state.

Dat directive cause kasala for di state as di motor parks pipo and driver oppose di ban by di govnor.

SSG house raided, commissioners attacked

Osun State govment for July 2026, raise alarm ova invasion, attacks and bursting of homes of some top govment officials by police.

Dem accuse police say dem enta di house of di Secretary to di State Govment (SSG) witout search warrant.

"Di operations on di SSG residence follow similar raid and arrest for di residences of about six commissioners and oda top functionaries of di govment."

Di state govment say di police bin also raid di house of some commissioners for di state and destroy properties.

Di Nigeria Police announce Commissioner of Police Elections for di state. Dem say di announcement na to ensure peaceful election.

Police deploy CP Samuel Erale Etaifo, to Osun State as CP Elections, for di forthcoming govnorship election.

"Di deployment na part of di Force comprehensive election security strategy to ensure peaceful, secure, and credible electoral process."

Police say na di CP election go oversee and coordinate election operations and security across di state.

Despite tok say dem don change di Osun State Commissioner of Police, di police say CP Ibrahim Gotan, go still remain in charge of di State Command.

Few days ago, di APC say some pipo launch attack on di convoy wey dey carry di wife of dia govnorship candidate Shekinat Oyebamiji.

APC say dem attak di convoy for Ede wen dem go for campaign visit, in company of oda members of di party

Dem say make Osun State Commissioner of Police conduct investigation into di attack and make sure say dose wey dey involved face di law.