Jude Okoye wife react to 'manipulated tori' for Psquare brothers fight

Foto of Paul, Jude and Peter Okoye during di MTV Awards for Abuja, 2008

Wia dis foto come from, Gareth Cattermole/Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Di kasala wey dey happun for di family of Nigeria musicians Paul and Peter Okoye popularly known as P-Square and dia elder broda wey be music executive Jude Okoye don enta anoda dimension.

Di family wahala wey surround music and royalties during dia time as P-Square bifor dem separate don show face again as dem dey accuse and counter accuse one anoda.

Now, di wife of Jude Okoye, wey be Ifeoma Okoye, don chook mouth for di mata as she react to di accuse wey dey go on between di brodas for years as dem drag her name inside.

Ifeoma Okoye share her side of di story for her official Instagram page on Tuesday, 4 August afta her broda inlaw wey pipo sabi well-well as Petersquare or Mr P, release anoda episode of im videos on di mata.

For Mr P videos, e explain wetin dey cause kasala wit im elder brother, Jude and im twin broda, Paul.

E say na di management and ownership of assets wey dey linked to dia former music group, P-Square dey cause dia katakata.

Ifeoma Okoye

Wia dis foto come from, Ifeoma Okoye/Instagram

For di video, Mr P claim say im elder broda Jude bin try to transfer ownership rights of one of di properties wey P-Square get to Ifeoma.

E also claim say im reject di move afta e discover documents wey carry her name.

Di wife of Jude Okoye respond to di accuse, but she no mention any of dia names.

Ifeoma say she know about di claims wey dey fly upandan about her but dem no go fit drag her to begin confront anybody for public.

"I no get desire to defend myself bifor pipo wey dey committed to misunderstand me. Truth no need manipulation to prevail, and I trust God to vindicate wetin dey right," she write for di post.

She tok say even though she decide to keep quiet, e no mean say she dey weak or she dey fear.

She add say she don decide to leave di mata for God instead of to dey drag each oda for public.

She pray for forgiveness, healing and restoration, as she ask God to repair di relationships wey don spoil, make God make hearts soft and guide di pipo wey dey involved to di truth, humility and peace.

"My prayer no be for judgment, but for mercy. May God bring conviction wia e dey needed, healing wia brokenness dey, and peace wia unrest dey. Make Him soften hardened hearts, restore wetin don dey damaged, and lead us all into truth, humility, repentance, and Im perfect love," she add.

Di musical twin brothers wey bin make up P-Square, one of di best Afrobeats groups for Africa bin break-up for 2017 sake of dis same family wahala.

Dem later reconcile for 2021 and celebrate dia 40th birthday togeda, and announce to dia followers say dem don comeback togeda.

Di brodas bin make waves for Africa wit dia music and dem win different awards wey include di Artist of di Decade by MTV Africa for 2015.

Some of dia hit songs na Do Me, Chop My Money and Bizzybody, wey bin make dem popular well-well for Africa and abroad.

Since dia second separation, Mr P dey sing solo and don release im own song, while im twin broda Paul wey im stage name na Rude Boy, dey also do im own songs wit dia elder broda Jude Okoye.

Di brodas don drag diasefs go court and di Economic and Financial Crimes Commission EFCC start di prosecution of dia former manager.

Okoye dey on trial togeda wit im company Northside Music Limited wey dey charged wit seven counts wey dey border on money laundering of 1.38bn naira ($809, 000.

One of di counts na say for 2022, e buy landed property for Parkview Estate wit money wey im know or suppose know say comot from unlawful act wey dey against wetin Section 18 (2) (d) and dey punishable under Section 18 (3) of di Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022.

Jude Okoye plead not guilty to all di charges.