BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Appeal Court for Finland reduce Simon Ekpa six years sentence
Simon Ekpa bin dey sentenced to six years in prison for September 2025, but e launch appeal to di judgement as e claim say im actions bin no get terrorism intentions.
All you need to know about new Suicide (Prevention) Bill Nigeria senate dey consider
Di Nigeria Senate President bin cause tok-tok for social media sake of im comment durin di debate ova one new bill to decriminalise attempted suicide for di kontri. But wetin dis bill dey tok?
Suspected scammers for Nigeria, Ghana chop arrest for joint operation across West Africa
Authorities say dem arrest 19 pipo for Ghana and nine for Nigeria. Dem also seize 356 electronic devices plus identify at least $11 million in potentially recoverable funds.
Pope Leo XIV get lung cancer, Vatican tok
Pope Leo surgery to remove one lower lobe of om right lung dey success, di Vatican tok.
Wike, Soludo, Adeleke and Amosun make list of APC presidential campaign council - who else dey?
Di All Progressives Congress release names of dia campaign team on Tuesday and dem go do di inauguration on Wednesday 13 October, 2026.
Wetin to know as former DR Congo President Joseph Kabila bicom leader of new rebel movement
Di announcement of dis new rebel joinbodi movement for DR Congo na di clearest indication so far say Joseph Kabila get hand for di armed opposition for di kontri.
Why court strike out Nigerian govment criminal charges against 'fake' agency DG Adeniyi Adeyemi
Di reason be say dem bin wan carry di case go di High Court of di Federal Capital Territory make dem run am from beginning.
Price of fuel across Nigeria for govment filling station
Di Nigeria govment announce 66 naira discount on petrol pump price for govment owned retail stations, but checks show say situation on ground dey different.
Special Tori
Five types of phones NCC say go stop to dey work for Nigeria
NCC explain say di new system na part of dia plan to improve di standards for verifying communication devices, so as to stop di spread of fake phones and protect di safety of pipo wey dey use dem for Nigeria.
More dan 30 children die for Pakistan afta school roof collapse
Rescue officials fear say more pipo dey buried under di debris for di north-western city of Peshawar.
Three reasons why dem dey marry out girl pikin for northern Nigeria
Di problem of early marriage of small small girls wey no pass di ages of 12, 14 and 15 don dey rise.
Nigeria demand answers as anoda citizen kpai for police custody for South Africa
Dis death dey come among oda recorded cases wia Nigerian citizens allegedly kpai for di custody of South African security personnel.
Ex-gang boss wey plan Tupac Shakur murder chop 40 years prison sentence
Dem find Davis guilty last month ova im role for di late rap superstar death for one drive-by shooting for 1996.
Nigerian face charges of possession of item wey belong to late South Africa runner Elizabeth 'Tsontso'
South Africa police don charge three suspects to court on top accuse say dem tiff and sell one smartwatch wey belong to Elizabeth 'Tsontso' Moselakgomo
Why pipo dey para about party activist wey Ghana President Mahama appoint to kontri electoral commission?
Ghana president swear-in two new deputy chairpersons for di kontri electoral commission, but di appointment of Emelia Afi Agbenyo wey be NDC activist dey make pipo para.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.















































