Trump suggest new tok-tok wit Iran on Monday as crude prices drop
- Author, Bernd Debusmann Jr
- Role, White House reporter
- Reporting from, Air Force One
- Author, James Chater
- Published
- Read am in 4 mins
US President Donald Trump don tok say new tok-tok wit Iran go start on Monday, afta e bin call off wetin e tok say suppose be "massive" strikes for di kontri.
E tell tori pipo for Air Force One on Sunday say, "dem bin know di kain attack bicos dem see am as e dey form. We dey follow dem tok as one kain negotiations. E go start tomorrow afternoon".
Bifor for Truth Social, Trump tok say Iran and US allies for di Middle East bin ask am to "hold off" on any attacks as dem don gree for di "perimeters" of a deal.
Iran neva tok about wetin Trump say. Dis na as di US president don repeatedly promise say negotiation to end di war dey close only for am to turn to do-me-I-do-you strikes..
For Air Force One, Trump tok say im no go give deadline for any deal wit Tehran. Im add: "We go just see how e be. We ready to go any time we want... I no wan kpai pipo."
Trump tok say Saudi Arabia Crown Prince Mohammed Bin Salman - plus US partners like United Arab Emirates and Qatar - bin beg am make im no carry out di strikes for weekend.
"We bin don set to go," Trump talk. "Di reason dem ask be say tink say dem don get deal," na so im talk. "Get deal for Hormuz, and e go get deal for nuclear too."[dem]
Global oil price fall for Monday morning during Asia trading afta Trump announcement. Brent Crude oil drop by 4.5% go $83.98 (£62.26), while US-traded oil drop by 4.6% go $80.74 (£59.85).
Energy price don dey up and down since di war start on 28 February as traders dey react to wahala wey dey shipping through Strait of Hormuz.
Around 20% of di world crude oil and liquefied natural gas (LNG) dey pass through di strait every time.
Iran semi-official Mehr news agency deny say Tehran ask US to hold off further military action. Dem say Trump claims na "nothing but new lie".
For Sunday, Iran Foreign Minister Abbas Araghchi talk say negotiations wit Oman on deal about Strait of Hormuz "dey on track to finish", according to Iran media.
Di US president never talk where di talks go hold for Monday, or who go attend.
While im dey talk for Air Force One, Trump say di planned strikes for don be "di biggest attack since World War II", and e for spoil chance to end di months-long war wit negotiation.
Trump refuse to answer if im plan to strike Iran energy infrastructure, wetin international law experts talk say fit be war crime.
Iran acting Defence Minister Majid Ibn al-Reza talk earlier say Tehran dey see every threat from dia enemies as "real and credible" even if na psychological warfare.
"We no go allow dem catch us unaware and we no go just dey quiet," im add.

US president don dey give Tehran apocalyptic warnings before, only for am to later tok say dem dey give diplomacy chance.
For im post on Saturday, im tok say US "locked and loaded and ready to go against di Islamic Republic of Iran, for Military Terror, Strength, and Power level wey nobody don see since World War II".
But im add say dem cancel di attack "for di future benefit of di world and, same way, for di survival of successful and prosperous Iran".
For 7 April, di US president warn say "whole civilization go die tonight" if Iran no gree enta peace talks. For dat time too, im threaten say im go destroy civilian infrastructure and power plants.
Dat threat lead to historic face-to-face tok-tok for Pakistan, wey Vice-President JD Vance lead. But those negotiations no go anywia.
Trump administration don also dey dismiss data wey show say di war - and di economic impact - no dey popular with Americans at all, including many Republicans.
Polls wey show say people no dey happy wit how dem dey handle di war don cause alarm for some conservative strategists wey dey reason di November midterms wey dey come.
With additional reporting from Peter Hoskins.










