South African police arrest suspects wey dey linked to one of di deaths of women for Gauteng Province

Wia dis foto come from, SAPS/X
Police for South Africa don arrest three suspects in connection wit one of di murder cases dem dey investigate for di Eastern part of Johannesburg.
Di police for statement on Monday, 21 September announce say dem arrest one man and two women dem suspect say get hand for di body of di ninth woman wey dem kill and dump her body for Dawn Park.
D three suspects currently dey for custody and dem dey expected to appear bifor Boksburg Magistrates' Court to ansa charges connected to di murder today.
Detectives from di Gauteng Murder and Robbery Unit say dem arrest dem ova di weekend.
Acting National Commissioner Lieutenant General Puleng Dimpane tok say all di nine cases dey receive priority attention and dem dey work to uncover more details about di circumstances surrounding di killing.
South Africa Justice, Crime Prevention and Security don also identify seven out of di nine women.
Na on Thursday, police confam say dem discover di deadi body of di ninth woman, wey be di latest victim for Dawn Park.
Dem find her just like di rest of di victims, half naked and dem wrap her wit sheet for di side of di road.
Di discovery bin follow di deaths of eight oda women, wey dem find dia bodies since July across Ekurhuleni, one major urban area of Johannesburg.
Dem find most of di women partially clothed and wit injuries, but police tok say dem no fit establish weda all di deaths dey connected or weda na serial killer dey responsible.
Victims of di femicide for Ekurhuleni in order of dia discoveries
- First victim - Busisiwe Mahlangu - dem find her for Kempton Park on 15 July 2026
- Second victim - Itumeleng Kekana - dem find her for Kempton Park on 3 August 2026
- Third victim - Nomfesane Mjobo - dem find her for Kempton Park on 26 August 2026
- Fourth victim - Unknown body - dem find her floating for Clayville river for Olifantsfontain on 7 September 2026
- Fifth victim - Gracious Nkomo - dem find her for Kempton Park on 10 September 2026
- Sixth victim - Elizabeth Moselakgomo - dem find her for Kempton park on 12 September 2026
- Seventh victim - Name withheld — dem no fit reveal her name yet until dem inform her family. Dem find her for found for Olifantsfontein on 14 September 2026
- Eight victim - Dineo Motapane - dem find her for Kwa-Thema on 15 September 2026
- Ninth victim - Jabulile Ntimba - dem find her for Dawn park on 17 September 2026
Elizabeth "Tsontso" Laid to Rest
Ova di weekend, dem lay one South African runner Elizabeth "Tsontso" Moselakqomo, di sixth victim to rest for one service wey dey marked by grief.
Mourners gada for large numbers, some put on dia running gear wey connect dem to her.
Di saddest moment na wen her eight-year-old daughter, deliver one poem wey describe how she fit still feel her mother love.
Fellow runners bin line up for road and run alongside di hearse as e carry Tsontso go her final resting place.
Elizabeth na one of di nine women murdered for Eastern part of Johannesburg. She bin go for her afternoon run and no ever come back home.
President Cyril Ramaphosa don vow say "im no go leave any stone unturn" in finding dos behind di killings, wey e tok say dey "cause fear and uncertainty for our communities".
Police don assemble one multidisciplinary team of detectives, intelligence officers, forensic experts plus oda specialists to investigate di deaths and establish weda links dey between di cases.
Dem also dey pursue persons of interest.
Authorities don offer 400,000 rand ($24,000; £18,000) reward for information wey fit lead to arrests and dem don appeal to families wit missing relatives to help identify di remaining victims.
Di discoveries don cause widespread alarm for Ekurhuleni, particularly around Kempton Park, and e dey come against di backdrop of longstanding concern about high levels of violence against women in South Africa.
Police say dem no dey link di deaths to a serial killer at dis stage, but dem dey investigate di possibility say na group of pipo dey behind di killings.









