South Africa find ninth woman bodi for Dawn Park - timeline of discoveries and who dey behind dis killings?

Police officers gada
Published
Read am in 5 mins

Police don confam say dem discova anoda deadi bodi for Dawn Park wey dey east of Johannesburg on Thursday.

Dis go make am di ninth deadi bodi wey di police dey declare say dem don see in di last two months.

Dis particular woman, dem find am half-naked and covered wit cloth for road side.

Dem also add say dis ninth woman wey dem find dey believed to be in her 30s and dem see say dem don cut her throat.

"Police discova di bodi of ninth woman on Thursday 17 September 2026) morning for Dawn Park, Boksburg," police statement tok.

Ova di last two months, police don find eight oda women wey don die and some dia bodis bin dey around di Ekurhuleni municipality area.

Plenti of di oda women wey dem find na around Kempton Park, like 30km away from wia dem find dis one.

Dem find di 38 year old woman bodi on Saturday, 12 September.

Di South African Police Service don gada multidisciplinary team to investigate wetin cause di deaths.

But till now, police still neva confam weda na serial killer dey kpai dis women abi na more dan one pesin dey kill all dis pipo.

Timeline of discoveries

July 15: Police discova di first victim bodi near R21 on 15 July. Na 37-year-old woman. Dem find her naked and e be like say she bin dey restrained wit cable ties. Justice, Crime Prevention and Security say dem arrest one suspect in connection to dis case and e dey for custody.

August 24: Authorities discova di second bodi on 24 August near R21. Di bodi na dat of one 32-year-old woman. Dem also find her partially clothed.

September 10: Dem discova di third bodi on 10 September. Police say di bodi bin dey advanced state of decomposition and dem find her naked.

September 12: Dem find di fourth bodi on 12 September for Rhodesfield for di back of one hotel for di area. Na di bodi of one 38-year-old woman. Di woman bin dey wear sports clothing and dem find her partially clothed.

September 12: Police find di fifth bodi wey be dat of 38-year-old Elizabeth "Tsontso" Moselakgomo. Moselakgomo bin go missing afta one afternoon run on 9 September for Rhodesfield, Kempton Park.

September 15: Police find di sixth bodi on 15 September for Katema area of Gauteng Province and dem say she look like pesin wey dey for her 30s.

September 7: Police find di seventh bodi dey float inside river for Clayville, near di Mall of Tembisa, for Ekurhuleni on 7 September, but dem announce am on 15 September

September 14: Police find di eighth bodi for Olifantsfontein on 14 September.

September 17: Police say dem find di ninth bodi for Dawn Park wey dey east of Johannesburg on 17 September.

Who dey behind South Africa women murders?

E get wide belief say dis recent murders for di area dey committed by serial killer but police neva confam yet.

Na only three of di victims families so far don identify dia loved ones as di killings near Kempton Park and surrounding areas don spark public outrage and fear.

Sake of all of dis killings, dem say make women no waka or run alone and avoid silent places.

Di South African Police Service (SAPS) for di North West say message wey dey circulate for social media about "Serial Killer" neva dey confamd.

Dem say dem no fit confam if na one pesin dey do all dis killing or na group of pipo wey de linked togeda.

Some pipo dey fear say di suspect dey move from one province to di oda, but di police say make pipo no panic, say dem neva confam dat kain tin.

"At dis stage, di police neva find official report or complaint confaming di specific claims contained in di circulating message, including di alleged relocation of suspect to Potchefstroom."

Di police don beg community pipo make dem share any information wey go assist wit di investigations so dem go fit catch dose wey dey behind di killings.

Missing pesin picture

How South African dey react to dis murders

Dis mata don lead to plenti tok-tok among South Africans and e don also raise di issue of gender-based violence for di kontri as dem hala say "we no dey safe again for di dis kontri of South Africa as women."

Some pipo dey reason solution on di mata as pipo don dey hala say make road blocks full di whole Ekurhuleni till tins settle down even as dem dey ask di military to chook mouth for di mata.

Dem argue say di police no dey do dia work for dat area even to di extent of accusing officials say dem dey in bed wit criminals.

Meanwhile, di biggest politically non aligned trade union for South Africa, Fedusa don call out di govment plus pipo wey dey employ workers, to find way for workers to fit dey safe wen dem dey comot from work late.

Dem tok for statement for X say, "Following di growing worry about di safety of women wey dey go house afta late shifts for Kempton Park, Fedusa and oda bodis dey ask for urgent action to address di risks wey workers dey face wen dem clock out afta dark."

Dem torchilght say di safety of workers no end afta dem comot from office.

Fedusa say make "govment, employers, and organised labour work togeda to find practical measures wey go protect workers beta wey include tins like beta transport arrangements for di pipo wey dey work late".