South Africa discova eighth bodi, authorities offer $25,000 reward to find killers

South Africa police back di camera

Wia dis foto come from, Brenton Geach/Gallo Images via Getty Images

Published
Read am in 6 mins

Police authorities for South Africa don discova anoda body on di side of di road for KwaThema, Springs, in Ekurhuleni area on Tuesday.

Dis na di eighth body police go discova around Ekurhuleni Municipality, Johannesburg South Africa.

On Tuesday, high-level govment officials meet investigators for Gauteng afta dem discover di eighth woman body.

Di meeting, hold for South African Police Service (SAPS) Gauteng Provincial Head Office for Parktown, wia dem tok about di effort wey dem dey carry on to investigate di matta and identify di criminals.

Acting national commissioner of di South African Police Service (SAPS), Lieutenant General Puleng Dimpane, tok say dem don arrest one suspect in connection wit one of di body wey dem find for July.

She tok say dem dey offer $25,000 (R400,000) reward for information wey fit lead to di breakthrough in dia investigation of wetin cause di deaths of eight women for Ekurhuleni.

"E get one case we successfully investigate for July and di pesin dey behind bars, we get one arrest and one pesin wey we dey pursue. We acknowledge say communities get a role on a way dem fit assist us, we dey offer R400,000 on di table to assist our investigation.

"We dey call upon families make dem come tok about any family members wey dey miss and assist us in di information."

"I don tok to di minister of police and di acting national police commissioner, dem don brief me on di investigation. I don direct dem make dem prioritise di case and leave no stone unturn to bring pipo wey dey responsible to justice," di president tok.

Also, South Africa acting Minister for Police, Firoz Cachalia, show serious concern as im send im condolences to di victim relatives on Tuesday.

Di acting minister say to dey find multiple women dead for Kempton Park area dey worry dem but dem no go stop investigation into di mata.

Dem say Tsontso bodi go make am di fifth bodi dem go discova for Kempton Park, especially for Rhodesfield area for Gauteng, in di past two months.

"Di discovery of multiple women wey dem murder for di Kempton Park area dey deeply disturbing. While di investigation gatz establish weda di cases dey linked, di possibility say di perpetrators fit dey target women demand our urgent and determined attention," Cachalia tok.

Wen police discova di deadbodies?

On July 15 - dem discova di first victim, 37-year-old woman, for Kempton Park. Police arrest di suspect two days later.

For August - dem discova di second and third body for Kempton Park

September 10 - Dem discova di fourth body, di body dey naked and e don decompose wen dem discova am for Kempton Park.

September 12 - Dem discova di fifth victim, one 38-year-old Elizabeth Moselakgomo body around in di Kempton park

September 14 - Dem discova one woman body on di side of di road for KwaThema, Springs, in Ekurhuleni.

September 15- Dem later discova two bodies for Ekurhuleni Municipality, Johannesburg South Africa.

Wetin South Africa police dey do about di murder of women

As part of efforts to look into dis mata, di acting minister tok say acting national commissioner of di South African Police, General Puleng Dimpane, go meet wit di investigating team dis afternoon to get more detail on di progress of di investigation.

E tok say di meeting wit di investigating team go provide opportunity to look into di progress of di investigation and ensure say dem provide all necessary resources and operational support.

E say dem go do correct investigation wey go make dem establish di possible links wey dem need, identify dose wey dey behind and bring dem to justice.

"Di safety of women na priority. Di SAPS go continue to dey work wit communities and oda stakeholders to identify risks, strengthen policing response, and ensure say credible information get attention."

However, inside one interview by local media SABC TV, one woman bin tok say di sixth bodi wey authorities find for di area fit be her missing daughter, but local media neva confam di identity of di sixth bodi wey authorities discova on Tuesday morning.

"We appeal to anyone wit information wey fit assist di investigation to come forward through di appropriate police channels. We also urge di public make dem no circulate unverified information or make accusations witout evidence" police tok.

Di police condone wit di affected families

National Police tok-tok pesin, Athlenda Mathe tell tori pipo on Tuesday say dem see di sixth bodi for Katema area of di province on Tuesday morning and she look like pesin wey dey for her 30s.

"But dis bodi don dey decompose already, and dem dump am for dis area dis morning. As police, we neva reach dia yet. Di experts still dey analyse di dockets, di victim profile, and di behaviour of di suspect or suspects," she tok

She tok say dem still dey investigate weda dem dey deal wit one perpetrator or group of men wey dey kill dis women but dem no get any link, so dem no go fit rush di investigators becos dem go allow dem do "thorough job."

"Dis investigation no be wetin you fit rush, e dey quite complex. E involve a lot of women wey dem kill, and fit involve multiple perpetrators. But make we leave am for di detectives, becoa we want dem to give us di real perpetrators. If we put pressure on dem to speed up di investigation, we fit make mistakes, and we no wan catch di wrong pipo."

Who be di victims of dis killings?

Elizabeth “Tsontso” Moselakgomo

Wia dis foto come from, SA Justice, Crime Prevention and Security

Di first victim na one 37-year-old woman wey authorities discova her bodi near R21 on 15 July.

Police neva confam her identity yet, but dem say dem find her naked and e be like say she bin dey restrained wit cable ties.

Justice, Crime Prevention and Security say dem don arrest one suspect and e dey for custody.

"For dis case, our investigators don already make progress, and one suspect currently dey for custody. Dem arrest di suspect on 17 July 2026. Di investigation into dis mata dey continue."

On 24 August, authorities discova di second bodi, one 32-year-old woman, near di R21. Dem also find her partially clothed.

Di third bodi na dat of one unidentified woman wey dem discova on 10 September 2026.

Police say di bodi bin dey advanced state of decomposition and dem find her naked. "At dis stage, we neva fit formally establish her identity. Di identification process dey go on," police tok.

Di fourth bodi na dat of one 38-year-old woman wey dem discova on 12 September for Rhodesfield for di back of one hotel for di area.

Di woman bin dey wear sports clothing and dem find her partially clothed.

Her identity still dey subject to formal confirmation by di family through di mortuary identification process, authorities tok.

Di fifth bodi na dat of 38-year-old Elizabeth "Tsontso" Moselakgomo. Police say her family identify her on Monday for di Germiston mortuary.

Moselakgomo bin go missing afta one afternoon run on 9 September for Rhodesfield, Kempton Park.

Her disappearance bin raise concerns for di area, as authorities bin put out resources to search for her.

Tributes don dey pour in for di ogbonge runner wey pipo sabi well well as "Tsontso" afta police confam her death.

South Africans also share di fear and anxiety women dey always feel for di kontri.

Advocacy group Women for Change say di discovery of dis bodis dey make dem vex.

"Wetin be di purpose of having a protective service like di police if we gatz make sure… we dey [protect] oursefs," Merlize Jogiat from di group ask.