University of South Africa condemn xenophobic attacks on oda Africans as Nigeria evacuate more citizens

Anti-migrant protesters

Wia dis foto come from, PER-ANDERS PETTERSSON/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Di March and March movement say dis fresh deadline na for leaders to 'fetch dia pipo' from South Africa
Published
Read am in 4 mins

Di University of South Africa don condemn di xenophobic attacks wey dey happun for South Africa.

South Africa dey for news about di way dem dey attack oda Africans wey dey stay and do business for di kontri. But South African authorities say na illegal migrants dem dey pursue from dia kontri.

For one statement on Friday, 18 September, di Senate of di university condemn xenophobia for South Africa and evriwia wey e dey happun.

"Di university Senate wey be di highest academic decision-making bodi for di University according to di Higher Education Act 101 of 1997 (as amended) and Statute of di University of South Africa, don deliberate on di issue of xenophobic violence for South Africa.

"We condemn xenophobic violence and di targeting of African migrants and foreign nationals for South Africa and evriwia for di world.

"For Unisa, our institutional identity and intellectual responsibility neva eva dey confined to one single national border. We belong to di African intellectual community wey dia strength dey come from di movement of ideas, pipo, knowledge and experience across di African continent," di statement tok.

Di university say na ontop Ubuntu/Bothon dem dey anchor dia world and di values of di African Union human rights architecture, di South African Constitution, di Universal Declaration of Human Rights and related international principles.

Di university para well-well as dem say xenophobia and Afrophobia dey undermine di intellectual future of Africa and di ideals of continental cooperation.

"Pan-Africanism come from di recognition say you no go fit understand only di political, intellectual and economic liberation of African pipo through colonial borders alone."

Dem say xenophobia and Afrophobia dey undermine di project as e dey replace solidarity wit division and suspicion.

"Dis time wen Africa dey face challenges like climate change, inequality, unemployment, technological transformation, public health concerns and economic development, we must treat fellow Africans as partners instead of enemies.

"Higher education benefit from di mobility of scholars across di continent. Make South African institutions support both local academic development and appropriate recruitment of critical skills wey go strengthen scholarship and research," di statement tok.

Foto of 33 Nigerians wey return from South Africa wey include men , women and children.

Wia dis foto come from, Bianca Ojukwu/X

Wetin we call dis foto, Foto of 33 Nigerians wey return from South Africa

Meanwhile anoda batch of 33 Nigerian citizens don comot from South Africa sake of di xenophobic incidents for di kontri.

Di Nigerian citizens na from Delta, Ogun, Imo, Lagos, Enugu, Oyo, Edo, Ondo and Bayelsa states.

For post on her X handle on Friday, 18 September, di Nigeria Minister of Foreign Affairs, Bianca Ojukwu say, "Di situation for South Africa no dey improve. Dem don kpai two Nigerian citizens dis month for South Africa - James Uchechukwu Nwankwo and Bishop Taiwo Michael Fakunle."

She say di Nigerian govment condemn dis killings wey dey targeted as she continue to call on di South African authorities to investigate and bring di perpetrators to justice.

Nigeria National Assembly don also suspend official visits to South Africa and also boycott any legislative activity wey South African govment dey host.

Madam Bianca add say na private business group fund di evacuation of 26 out of di 33 pipo wey return.

Dem bin don fund evacuation of 83 citizens, den anoda 67 from South Africa wey bring di total to 176 Nigerian citizens from South Africa.