Ex-husband of woman wey kpai dia three children explain why e forgive am
- Author, Chris Graham
- Published
- Read am in 4 mins
Warning: Dis story get disturbing details and discussion about attempted suicide
Patrick Clancy, wey be former husband of one US woman wey dem accuse of killing dia three children, don say say e for dey “eaten up inside forever” if e no forgive her for di deaths of dia children.
For one interview wit CBS, e also say e do di best wey e fit do as im den-wife, Lindsay Clancy, dey struggle wit mental illness for di months bifor di day wey she strangle dia children.
Lindsay no deny say na she kill dem, but her lawyers argue say dem no suppose hold her legally responsible bicos she dey suffer from severe mental illness.
One judge declare mistrial for di case earlier dis month afta di jury say dem no fit reach unanimous decision on weda she guilty of murder.
Prosecution allege say on January 24, 2023, Clancy intentionally strangle all her children - Cora, 5, Dawson, 3, and Callan, wey be eight months old - for dia house for Duxbury, Massachusetts.
Clancy, wey now dey 36 years old, later bicome paralysed afta she jump from window for second floor. She attend di trial wit wheelchair.

Wia dis foto come from, Reuters
Patrick Clancy testify during di trial about how im ex-wife mental health dey get worse afta she give birth.
Clancy team say she get postpartum psychosis, one rare condition wey fit make women wey just give birth experience mania, depression or mixture of both.
“I no know how to manage postpartum illness. I tink mental illness get dis ability to tragically deceive person,” e tell CBS, wey be BBC US news partner.
Na her mental health make Patrick Clancy later decide to forgive her.
“I see headlines wey tok say, you know, ‘Killer Mom’, ‘Baby Murderer’, ‘Monster’. And none of dem correct,” e say for di interview.
“I believe say na her mental illness cause am. So I share dose words. And I tink when e come to forgiveness, I also feel say if I no reach dat point, e for eat me up inside forever.”
When dem ask am weda e feel say e fail in any way during di period before di killings, e say: “I tink I do di best wey I fit do wit wetin I get at dat time. And I dey live wit di outcome. I dey live wit am evri day.”
Living wit im grief for di weeks afta di tragedy bicom difficult, and e admit say e get thoughts of killing imsef.
“I no tink say I go live to see my 35th birthday. And I dey completely okay wit am,” e tok.
During di seven-week trial, pipo online target Patrick wit plenty harsh criticism and accusations of cover-up.
Some pipo claim say e somehow responsible for di murders. Afta e suddenly bicom centre of public attention, tabloids take pictures of am as e travel and as e dey wit im new wife, Rachel Danis.
Di 36-year-old say di speculation dey “deeply harmful to di legacy of my children. E dey distract pipo from wetin really matter hia, wey be perinatal mental health.”
E also say e “painful to see” di situation personally.
“And e dey make am difficult to dey public, and e possible say some of dose pipo, afta dem see lie afta lie after lie, dem go start to believe am, and na dat one we go remain wit,” e tok.
Di intense attention make am move from Duxbury go New York City as e try to get some privacy.
Now, e dey start family wit Danis and dey look forward to telling im future children about dia brothers and sister.
“I tink evri parent fit agree, you get different relationships wit your children, but all of dem na your children. And I no fit wait to tell dem about dia brothers and sister.”
Di mistrial mean say di case never reach final conclusion. Prosecutors never say weda dem go ask for anoda trial.
Di next court hearing dey scheduled for September 29 for Plymouth Superior Court for Massachusetts.











