Burkina Faso enta Global Civic Freedoms Watchlist ova serious abuse of civic rights

Burkina Faso junta leader Captain Ibrahim Traore

Wia dis foto come from, Alexandr Kryazhev/RIA Novosti/Pool/Anadolu via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Burkina Faso don join di international watchlist of kontris wia civic freedoms dey go worse.

One rights group, Civicus, wey add dem tok say na becos govment dey increase crackdown on political opposition, civil society organisations and pipo wey dey criticise govment politics and actions.

Burkina Faso enta Global Civic Freedoms Watchlist

Dem also add di West African kontri to dia latest Watchlist, togeda wit Bahrain, Ecuador, Georgia and India to di list.

Civicus monitoring tracking civic space

Wia dis foto come from, Civicus

Civicus tok say di Watchlist highlight kontris wia serious decrease dey in freedoms of expression, association and peaceful assembly.

Di group say Burkina Faso military authorities don dissolve all di political parties for di kontri, suspend or shut down more dan 1,100 civil society organisations plus intensify measures against critics, wey include arrests, censorship and alleged enforced disappearances.

"Di scale of dis assault on civil society neva happun bifor," Pierre-Claver Akolly Amegnikpo of di West African Human Rights Defenders' Network tok. "Authorities dey use restrictive law and unclear administrative measures to dismantle organisations."

Di organization add say junta formally dissolve di political parties wey dem suspend dia activities afta di military seize power for 2022 for January 2026.

"Di dissolution of all political parties represent extraordinary attack on political pluralism," Akolly Amegnikpo tok. "Combined wit di targeting of civil society groups and critics, e point to systematic effort to silence independent voices."

Civicus also add say religious leaders wey criticise military authorities also dey face intimidation and attacks for di kontri.

"Dem arrest Imam Kindo on 26 May 2026 on top accuse say e publicly criticicise one proposed restrictive religious freedom bill wey go ban di establishment of places of worship within public services."

Burkina Faso military govment neva respond to Civicus report.

Di military don dey rule di kontri since Captain Ibrahim Traoré seize power inside one coup for September 2022.

E bin promise to improve security as Burkina Faso dey battle one long-running Islamist insurgency wey dey linked to al-Qaeda and di Islamic State group.

Large parts of di kontri still no dey under govment control and millions of pipo dey displaced sake of conflict.

Di latest report dey come weeks afta di United Nations announce plans to permanently close dia human rights office for Burkina Faso for November, move wey go end di independent international presence of di organisation wey don monitor alleged abuses since 2019.

Burkinabe govment bin suspend di UN office for February, shortly afta UN High Commissioner for Human Rights Volker Türk urge di authorities to end wetin e describe as di repression of civic space and to abandon plans to ban political parties.

On 30 June, Burkina Faso Foreign Minister Karamoko Jean Marie Traoré accuse international organisations say dem dey act like "super police" and say dem don overstep di kontri sovereignty.

Di closure of di UN office mean say no independent international body go dey for di kontri again dey document alleged human rights violations as di fight-fight continue.

Earlier dis year, Human Rights Watch bin accuse all sides for di conflict say dem dey commit war crimes and crimes against humanity. Di organization also accuse di govment say dem dey carry out ethnic cleansing against members of di Fulani community.

Burkina Faso authorities bin don previously accuse say dia forces dey carry out abuse.

Di Civicus report dey come as Burkina Faso, alongside Mali and Niger, dey prepare to comot di International Criminal Court (ICC), one move wey human rights groups don warn say fit further weaken accountability for alleged abuses by state forces and armed groups, both within di three countries and across di wider Sahel region.