IS claim responsibility for Adamawa attack wey kill 29 pipo

One of di pipo wey lose loved ones for di attack for Guyaku community for Adamawa State on April 26, 2026

Wia dis foto come from, Adamawa State govment

Wetin we call dis foto, One of di pipo wey lose loved ones for di attack for Guyaku community for Adamawa State
Read am in 4 mins

Di Islamic State group (IS) don claim responsibility for di attack for Adamawa State on Sunday evening wia at least 29 pipo kpai for Guyaku community for Gombi Local Government Area of di State.

Iswap post di video on top telegram on Monday, according to Reuters.

Residents narrate how di attack bin hapun around 5pm for evening as pipo gada dey watch one football match, as di gunmen just arrive and start to dey shoot evriwia. Dem also burn houses, places of worship and motorcycles.

Adamawa State Governor, Ahmadu Umaru Fintiri visit di area on Monday to console di pipo wey dey affected.

Fintiri describe di attack as act of cowardice and "affront to our humanity", as e promise say di attackers no go go unpunished.

Di "atmosphere for di community remains tense, wit grief and fear evident", Fintiri tok tru one statement by im tok-tok pesin. Many families "don abandon dia homes over concerns of further attacks".

Govnor Fintiri also post for im X handle say: "We dey intensify security operations immediately to restore peace and make sure say evri resident go feel safe for dia home again."

Adamawa State get border wit Cameroon and e don witness plenty attacks by local criminal gangs and affiliates of IS for recent years.

Also, Amnesty International wey be ogbonge human rights group for di world, don strongly condemn di attack on Guyaku community wey dem describe as atrocity, although dem tok say na Boko Haram carry out di attack.

"Apart from shooting pipo for close range, Boko Haram also burn-burn churches, classrooms and motorcycles. Survivors and witnesses tok say dem see dead bodies spread around di village, (and) older pipo wey no fit run away bin dey slaughtered for inside dia homes," di group tok.

"Di fact say such atrocities remain commonplace show say more needs to be done to protect civilians and ensure say families of victims dey receive reparation and justice."

Adamawa State Govnor, Umaru Fintiri visit Guyaku community wia terrorist attack bin kpai 29 pipo

Wia dis foto come from, Adamawa State Govment

Wetin we call dis foto, Adamawa State Govnor, Umaru Fintiri visit di community on Monday to take im eyes see wetin hapun

Dis attack dey come on di same day wen gunmen attack one orphanage for Kohi State, for di north central region of Nigeria and kidnap 23 children plus di owner of di facility.

Kingsley Fanwo wey be di State commissioner for information tok dis one for on Monday as e add say police later recover 15 of di children wey di jaguda pipo bin kidnap, but eight still dey miss.

No group don claim responsibility for dat attack, but security sources bin don confirm say Kogi state get functional Boko Haram cell, and several violent attacks bin don hapun dia recently.

Earlier dis month, di Nigeria govment bin secure convictions for almost 400 pipo during mass trials, sake of dia links wit Boko Haram and dia rival splinter groups like di Islamic State West Africa Province (Iswap).

Since 2009, Boko Haram don launch ogbonge insurgency for di north east region of Nigeria, causing di death of thousands of pipo and more dan two million odas don run comot from dia homes, according to aid groups.

Di jihadist conflict don also spread to neighbouring Niger, Chad, and Cameroon.

Nigerian govment dey unda seriour pressure to stop di rising insecurity for di kontri, wey be di most-populous nation for Africa, and all eyes for di international community dey on di kontri now sake of dia general elections wey dey come up by January of 2027.

On Christmas day of 2025, di US govment bin launch "powerful and deadly" airstrikes against some militants wey get link to IS for Soko State, north west Nigeria.

Hia na some of di videos of di Guyaku attack:

Inside one of di churches wey di jaguda pipo burn for Guyaku community for Adamawa State on April 26, 2026

Wia dis foto come from, Adamawa State Govment

Wetin we call dis foto, Inside one of di churches wey di jaguda pipo burn