Wetin we know about di US-based Ghanaian professor wey die afta im wife allegedly shoot am

Jackson County attorney say the accused had a history of false allegations against her husband

Wia dis foto come from, BETTY AKAMANI/LINKEDIN/SOUTHERN ILLINOIS UNIVERSITY

Wetin we call dis foto, Di accused pesin Betty Akamani (L) also be academic wey dey pursue PhD for psychology for di Capella University
Published
Read am in 4 mins

Wife of one Ghanaian professor for di Southern Illinois University dey face murder charges for court.

Betty Akamani dey accused say she shoot her husband many times wen im dey inside car afta im drop off dia two children.

Apart from di murder charge, di 35-year-old woman also bin dey face charge of endangering di life of a child.

Dr Kofi Akamani die for di Carbondale hospital afta di fatal shooting for 19 September.

Di death of Dr Akamani don shock many pipo home and abroad as di couple bin dey go through divorce.

Information for court show say di two bin dey separated for two years wey dem bin dey try to finish dia divorce.

E neva dey clear wetin be di disagreement between di two academics wey dey teach for di Southern Illinois University.

Di court don deny Betty bail sake of dem say she fit be "threat to di public."

Jackson County state attorney Marsha Cascio-Hale say di alleged shooting happun afta Dr Akamani im planned visit to see im two daughters for Betty im house.

"We understand say Dr Akamani don dey carry im children go im wife house afta im carry dem comot, when dem shoot am inside di car."

Jackson County office also allege say di accused pesin get history of manipulation and false allegations against di deceased.

Betty Akamani go dey for di Jackson County jail and appear for her next court hearing for 6 October.

Profile of Dr Kofi Akamani wey be di Forestry professor for Southern Illinois University

the couple are believed to have been in the middle of a divorce

Wia dis foto come from, SOUTHERN ILLINOIS UNIVERSITY/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Professor Kofi Akamani die from multiple gunshot injuries on 19 September according to Jackson County Police

Kofi Akamani be professor of Forest Recreation and Conservation Social Science for di department of forestry for di Southern Illinois University.

Im dey do research for rural communities for Ghana and di US for areas like forests, water resources and climate change.

Professor Akamani bin dey teach for di Southern Illinois University for more than 10 years.

Di 48-year-old reach di rank of full professor for 2024 wia im serve as director for graduate studies.

Bifor im death, Professor Akamani bin dey teach at least five classes.

Im get im first degree from di Kwame Nkrumah University of Science and technology (Knust) for Ghana for 2003, bifor im get MPhil for Culter and environmental Sustainability for University of Oslo for 2006.

For 2011, im get PhD for Natural Resources for di University of Idaho.

Im publish plenty research papers, on top di Southern Illinois University website, dem list more than 30 publications.

Betty Akamani wey bin dey face murder charge also be research analyst for di Illinois Network of childcare resource and referral agencies (INCCRRA).

She also be applied research associate and part-time consultant for Illinois since 2020.

She bin serve as research assistant for di Southern Illinois University wey she dey pursue PhD for psychology for di Capella University.

Di forestry department for di Southern Illinois University bin dey pay tribute to di 45-year-old since im death.

"We dey grieve di loss of one of our beloved forestry professors Dr Kofi Akamani. Di forestry family bin love am for di University and across di world," di department write on top dia social media page.

Dem add say "im get gentle and kind demeanour wey he get dedicated work ethic and positive attitude."

"We go dearly miss Kofi. Our hearts dey go out to all di pipo wey love am."