Nigeria Super Falcons vs Female Pharaohs of Egypt Wafcon match preview

Nigeria and Egypt players

Wia dis foto come from, Reuters, EPA/Shutterstock

Published
Read am in 3 mins

Nigeria Super Falcons go face Female Pharaohs of Egypt on Wednesday for di Group C final match for di ongoing Women African Cup of Nations (Wafcon) 2026 for Morocco.

Di match go kick off 9pm Nigeria time for Rabat, Morocco.

If di Falcons lose di match, dem go comot for di tournament and e go be huge blow to dia dream of participating for di 2027 Fifa Women's World Cup.

Di Super Falcons go enta di match witout defender Tosin Dimehin wey collect red card for dia last match and midfielder Jennifer Echegini wey also dey serve suspension sake of double yellow card for dia last two matches.

Dem don score three goals so far, di first na from Captain Ajibade via penalty, di second na from Uchenna Kanu while Asisat Oshoala score di third goal.

Egypt on di oda hand don play two matches and score only one goal for dia 3-1 loss to Malawi. Dem bin don chop 6-0 from Zambia during dia first match.

Di group still dey open until di end of di matches dis night.

So far, Nigeria wey be di defending Champion get only 3 points from two matches. Dem lose 2-3 to Malawi for dia first match and beat Zambia 1-0 for dia second match.

Malawi dey lead di group wit six points. Zambia also get three points while Egypt don lose dia two matches so far.

If Zambia beat Malawi for dia Wednesday evening match and Nigeria beat Egypt, na im be say Malawi, Nigeria and Zambia go get six points each for group C.

Dem go now need to look at di head-to-head records of di three teams to determine who go enta di next round.

Di two best teams for each group go proceed to di quarter finals and from dia to di semi finals.

Di four semi finalists go automatically qualify for di 2027 Fifa Women's World Cup for Brazil.

Nigeria Super Falcons na ten times winners of di Women African Cup of Nations.