Who be Presley Gerber? - model and son of Cindy Crawford wey die at age 27

Presley Walker Gerber wear black in front of one pink and purple backdrop e attend di World Premiere of "Infinite Icon: A Visual Memoir" at AMC The Grove 14 on January 20, 2026 for Los Angeles, California

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Presley Gerber bicom model like im mother and sister
    • Author, Chris Graham
  • Published
  • Read am in 3 mins

Presley Gerber, di son of supermodel Cindy Crawford, don die at di age of 27.

Gerber, wey be model, die for one rehab facility on Sunday, according to records wey di Los Angeles County Medical Examiner file.

Dem no list di cause of death.

Allie Jenkins, one representative for Crawford and her husband Rande Gerber, tell BBC US news partner CBS: "Di family dey ask for privacy during dis very difficult and painful time."

Gerber bin work as model like im mother and younger sister Kaia. E make im runway debut for Italian label Moschino at di age of 16.

Presley Gerber dey for foto for May dis year for Los Angeles alongside sister Kaia Gerber, mum Cindy Crawford and dad Rande Gerber

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Gerber (left) na model and e don tok about im close relationship wit im family

E bin go on to model for brands wey include Burberry, Dolce & Gabbana, and Bottega Veneta.

Im father Rande Gerber, a well-known businessman bin co-found di Casamigos tequila brand wit George Clooney.

In recent years, Gerber don tok openly about im mental health challenges and drug use.

For 2023, e tell Studio 22 podcast say: "Having struggled wit mental health, depression and some oda things wey come along wit am, I tink say weda I help one pesin or a hundred pipo comot dat place wey I bin dey at one point in my life, dat na all I need to do."

And for dis month American Vogue, Kaia bin discuss her brother struggles wit addiction. She say: "Wen something like dat happun for family, e get how e go level evribody.

"I tink say dat na why I start to dey self-identify as di easy one and no ever wan ask for help."

Gerber bifor now don tok of im close relationship wit im family, including sister Kaia, wey dem dey togeda for one campaign for Calvin Klein for 2018, and pesin wey e tatoo im name on im hand.

E tell People Magazine dat year: "We be close family, especially me and my sister, so e dey definitely cool.

"We dey travel togeda half of di time, so e make am a lot less lonely."

Gerber also feature alongside im mama for Pepsi 2018 Super Bowl commercial, 26 years afta Crawford first appear for her famous 1992 advertisement for di brand.

"We be really tight family, so e be like going to work wit one of your friends. E dey fun, and easy," e bin tell People Magazine at di time.

For July, Crawford share two childhood photographs of her son on Instagram to mark im 27th birthday.

"I dey so proud of di man you don bicom, but I go always see you as my little boy! Love you," she write.