Five new tactics wey bandits dey use carry out dia attack

Five new tactics wey bandits dey use take dey attack pipo

Wia dis foto come from, Social Media

Wetin we call dis foto, Bandits
    • Author, Muslim Muhammad Yusuf
    • Reporting from, BBC Hausa
  • Published
  • Read am in 5 mins

As security agencies for Nigeria dey kontinu to try stop bandits attacks, di attackers sef dey kontinu to change dia style and dey create new ways to carry out attacks.

For recent times, dia attacks no dey target only ordinary pipo again, dem don begin attack military camps and oda security personnel too.

Even though say security forces dey sometimes succeed chase di attackers comot, di way bandits dey change tactics dey increase fear and dey make di work of security agencies harder.

Sake of dis, many communities dey live for fear bicos dem no know which style bandits go use for dia next attack.

Dis situation sef dey threaten farming activities for dis year rainy season bicos insecurity don bicom more serious for different parts of di kontri.

BBC don chook eye inside some of di new tactics wey bandits don begin use recently to carry out attacks.

Dem dey first attack security pipo bifor dem attack villages

One of di new tactics wey bandits don adopt na to first surround or overpower security personnel before dem launch attacks on communities.

Instead make dem attack village directly, dem go first surround security camps or where security personnel dey stay so dat dem no go fit respond or send reinforcement once di attack start.

One recent example na di attack for Kasuwar Daji for Kaura Namoda Local Government Area of Zamfara State, wia di attackers first launch attack on soldiers wey dey stationed for di area and even kill four soldiers.

Afta dem don make sure say di security personnel don focus on defending dia camp, oda attackers enter di town, kill residents and kidnap more than 50 ppipo.

However, Nigerian Army tok say only one soldier and one police officer lose dia lives while dem dey repel di attack, according to Operation FANSAN YAMMA.

For July, wen bandits attack Tsamaye village for Sabon Birni Local Govment Area of Sokoto State, residents tok say di attackers first surround di security personnel wey dey inside di village and open fire on dem, wey stop dem from coming out to defend di residents.

From dia, di attackers begin go house-to-house dey kill pipo, steal property and kidnap residents.

Security experts tok say dis tactic dey give bandits chance to operate freely for hours witout anybodi stopping dem quickly.

Burn pipo alive inside dia houses

Anoda new tactic wey bandits don begin use na to lock pipo inside rooms or dia houses bifor dem set di buildings on fire.

Security experts tok say dem no dey use dis method only to kill pipo, but also to spread fear among communities and force dem to leave dia villages.

Recently, during one attack for one village for Sokoto State, bandits kill at least 12 pipo and kidnap women and children. Residents tell Reuters say six members of one family burn to death afta di attackers lock dem inside dia house and set am on fire.

Afta dat, di attackers steal livestock and loot oda residents before dem run away.

Similar attacks don happun too for parts of Zamfara, Katsina and Kebbi states, wia bandits dey burn houses and food stores afta dem don loot property or kidnap pipo.

For some cases, dem dey also burn houses of people wey refuse to pay ransom or people wey try escape.

Dis na anoda method wey bandits dey use to spread fear and force villagers to run from dia communities.

Dem dey plant landmines

Bandits don dey increase di way dem dey use landmines or Improvised Explosive Devices (IEDs) for roads wey lead enter and comot from villages. Dis one mean say anybodi wey wan escape, or security personnel wey wan come rescue pipo, fit fall into dia trap.

Dis tactic dey stop residents from escaping quickly during attacks because dem dey fear say dem fit step on explosives. E dey also delay security personnel from reaching di place until dem don examine di roads.

Bandits use similar tactic on 25 July 2024, when at least seven Nigerian soldiers die afta dia vehicle hit one IED for Monguno-Baga road for Borno State.

Di explosive explode while di soldiers dey patrol, according to Reuters.

For June 2026 too, reports tok say four soldiers die afta dia patrol vehicle hit one IED wey dem plant for Bargaja road for Isa Local Government Area of Sokoto State. Di report tok say di explosion destroy di military vehicle completely.

Dey begin dey attack judges

Witin less dan one week, bandits attack two judges for northern Nigeria. Dem kidnap one, while di second one narrowly escape afta armed men invade di court wia e dey hear case.

On 26 July, bandits kidnap Kebbi State High Court judge Faruku Hassan for Bunza Local Government Area. Reports tok say di kidnappers demand N200 million ransom.

Few days later, armed bandits invade one Sharia Court for Gwarjo village for Matazu Local Government Area of Katsina State, dey fire gunshots while asking, "Wia Judge Mohammed Muktar dey?"

Security experts believe say attacks wey bandits dey launch against judges no be only because of ransom money.

According to dem, attacks like dis fit be one way to intimidate judicial officers and send dem message of fear so dat dem no go fit do dia work independently.

7Security expert Dr Kabiru Adamu tok say bandits fit dey try stop judges from handling cases wey concern dem or prosecuting dia members whenever security agencies arrest dem.

"E possible say bandits dey try send message to judges make dem fear. To attack judges fit also be one way of taking revenge bicos of court judgments," Kabiru Adamu tok.

Ambush to kill pipo wey dey run

Bandits dey usually divide dia selves into different groups bicor dem attack. While one group dey attack inside di village, oda groups go hide for escape routes or inside forests wey surround di village.

Once frightened residents run comot from dia houses dey look for safety, di ones wey hide go open fire on dem or kidnap dem.

Dis one dey reduce pipo confidence to run.

For many attacks across Sokoto, Zamfara and Katsina states, villagers tok say di attackers block all escape routes before dem enter di communities. Some people wey try run fall into di bandits' ambush, while odas dem kidnap.