Nigeria longest reality show return wit new twist

Two pipo pose for di launch of BBNaija season11

Wia dis foto come from, Big Brother Naija/Facebook

Published
Read am in 3 mins

Popular Africa reality show, Big Brother Naija alias BBNaija don return wit di 11th season.

MultiChoice Nigeria announce say dis new season go start on Sunday, 26 July wit di theme, "Everything is for di taking."

Di organisers say di theme mean say housemates go need earn "evri task, evri alliance, evri vote, and evri decision to remain for di house and di housemates wey understand dat from di first night go be di ones wey go still stand wen e mata di most."

Dis season winner go walk away wit record breaking price of ₦160 million-naira grand prize, wey include a cash sum of ₦100 million plus one brand-new SUV.

Di prize na di highest for di show history, and don raise di stakes for wetin dey expected to be anoda ogbonge season, di organisers tok.

BBNaija na one of di most anticipated television shows for Nigeria. Dis na sake of di category of pipo wey dey watch am pass - most of which na young pipo.

Di show dey usually dominate conversations for social wen e start up until di end.

Speaking ahead of di new season, di Executive Head, Content and Channels, West Africa, MultiChoice, Atinuke Babatunde say di show go build on dia legacy wit bigger surprises.

"Season 11 go build on dat legacy wit even bigger stakes, fresh twists plus exciting mix of housemates wey go keep audiences engaged from premiere night through to di finale," Babatunde tok.

On who di housemates of BBNiaja season 11 go be, di organisers neva unveil dem. But dem reveal Ebuka Obi-Uchendu as di returning host for di show.

Preparations for di new season bin start earlier dis year wit physical auditions wey hold from 22 - 24 May for Lagos, Abuja and Enugu, afterwards dem invite applicants wey dey shortlisted.

Participation dey free and open only to Nigerians wey dey di age of 21 and above wit valid means of identification.

Di new season follow di success of BBNaija Season 10, wey end on 5 October 2025, as Opeyemi Ayanwale, wey pipo sabi well-well as Imisi, beat 28 other contestants to win di prize package worth ₦150m, wey include ₦80m in cash plus SUV.