ISWAP Chief finance officer, im two sons and 46 odas surrender to di Nigerian Army

Wia dis foto come from, Nigerian Army/X
Di Chief finance operative of di Islamic State West Africa Province (ISWAP) wey be key senior officer of di terrorist group don surrender to di military, Nigerian Army tok.
Di Acting Military Information Officer of di Theatre Command, Captain Mohammed Goni, announce dis informate for statement on Sunday.
E say preliminary profiling show say di terrorist dey serve as di Chief finance operative of di ISWAP enclave for Jubillaram, wia e dey responsible for managing di group financial activities and logistics.
"E surrender alongside two male children," Capt. Goni add.
"Di terrorist surrender to sojas of 3 Battalion under 24 Task Force Brigade at about 6:45 a.m. on 25 July 2026 along di Ladari–Jegarawa–Tunokalia axis on di Gamboru–Wulgo Main Supply Route.
"Im decision to lay down im arms follow di recent series of coordinated and decisive land and air offensives wey Operation HADIN KAI carry out against terrorist enclave," di statement read in part.
Captain Goni say apart from di chief finance operative, anoda 46 terrorists plus dia family members don voluntarily surrender to di Nigerian Army in recent times.






