Top health benefits of Achi soup thickener wey dey protect heart

Achi seeds
    • Author, Karina Igonikon
    • Role, Reporter
    • Reporting from, Port Harcourt
  • Published
  • Read am in 4 mins

You wan make light soup wey dey filling and delicious with few ingredients like meat, dry fish, periwinkle, pepper, uziza leaf, crayfish, palm oil and onion with salt to taste and seasoning, di thickener many dey often go for na achi and kpam-kpam-kpam, soup don done.

Di next day, just add small water for di soup warm am and di soup go get body and pesin fit take am survive like dat for some days and each day, na so di taste dey sweeter wit dat rich unami taste.

Achi seeds wey di scientific name na Brachystegia eurycoma na local seeds wey dem dey commonly use cook, especially traditional meals for south eastern Nigeria. Di soup dem use achi cook dem dey call am achi soup.

Di seeds dey flat, round, and dry, and dem often dey grind am into powder and use am thicken soups. But achi na more dan just a soup thickener, as e be nutritious food wey dey support good health.

Ibrahim Abdulsalam Bichi wey be dietician say achi seeds contain important nutrients like protein, healthy fats, fiber, carbohydrates, vitamins, and minerals. Dis nutrients dey help di body grow, stay strong, and work properly.

Health benefits of Achi seeds

Bichi di dietician give done health benefits of Achi to include di following:

1. Achi dey help to build and repair di body

Achi seeds contain protein, wey dey help di body build muscles and repair damaged tissues. E get protein wey also dey important for growth, especially in children. Achi fit help:

  • Children grow well
  • Adults stay strong
  • Sick pipo recover faster as e get protein wey dey help di body heal and stay healthy.

2. Achi dey give di body energy

Achi seeds contain carbohydrates and healthy fats, wey dey provide energy for di body. Dis energy naim dey help us do our daily work, study, walk, and play.

Eating foods wey dey give energy dey help to reduce tiredness and keep di body active.

3. Support good digestion

Achi seeds contain fiber wey dey help food move easily through di stomach and intestines.

Fiber fit help to:

  • Prevent constipation
  • Improve digestion
  • Keep di stomach healthy
  • Support regular toilet movement
  • E dey also help you feel full after eating.

4. Achi dey support heart health

Di fiber and healthy fats for achi seeds fit help to lower bad cholesterol for di body. Dis fit can help to keep di heart healthy and improve blood flow.

A healthy heart dey help di body work well.

5. Achi dey help to control blood sugar

Achi seeds fit help to slow down how sugar dey enter di blood becos e contain fiber. Dis fit help to prevent sudden rise in blood sugar after meals.

Dis one me dey helpful for pipo wey dey live wit Diabetes wen dem eat am in di right amount.

6. Achi dey help to build strong bones

Achi seeds contain minerals like calcium and phosphorus wey dey help to build strong bones and teeth.

Strong bones dey important for:

  • Growth in children
  • Strong body movement
  • Bone health in adults

7. Achi dey help to make healthy blood

Achi seeds contain iron, wey dey help di body make blood. Blood na im dey carry oxygen to all parts of di body.

Wen di body get enof iron, e fit help prevent weakness and tiredness.

8. Achi dey support healthy weight

Becos achi seeds contain fiber and protein, e fit help pesin feel full for a longer time. Dis fit help to reduce overeating and support weight control.

9. Achi dey protect di body

Achi seeds contain natural plant nutrients wey dey help to protect body cells from damage. Dis one dey support overall health and help di body stay strong.

'Clean and process achi seeds properly '

Ibrahim Abdulsalam Bichi di dietician warn say “achi seeds supposed dey properly cleaned, processed, and cooked bifor eating to make am safe, easy to digest, and better for di body to use di nutrients.”

E emphasize say achi seeds na healthy local seeds wey dey do more dan thicken soup as e dey provide nutrients wey dey help to build di body, improve digestion, give energy, support di heart, strengthen bones, and help control blood sugar.

Wen you eat am as part of a balanced diet, achi seeds fit be a healthy food for both children and adults.