African Mahogany seed (Akparata): Soup thickener wey dey give blood and help manage weight

- Author, Karina Igonikon
- Role, Reporter
- Reporting from, Port Harcourt
- Published
- Read am in 4 mins
African Mahogany seeds wey di scientific name na Afzelia africana dey commonly known as Akparata for Igbo language.
Dem dey use dis local seeds to cook some traditional foods in Nigeria. Di seeds dey valued no be only for food but also becos dem contain important nutrients wey dey help di body stay kampe, healthy and strong.
To process di akparata seed, dem go first roast am, crack and grind am, come use am as soup thickener.
Di pipo of Enugu and Ebonyi state for south-eastern Nigeria get one special soup wey dem dey use akparata seed cook, dem dey call di soup “ofe akparata” dem dey cook am for special occasions.
Ibrahim Abdulsalam Bichi, wey be dietician, tok say African Mahogany seeds dey rich in nutrients like protein, healthy fats, fiber, carbohydrates, vitamins, and minerals.
Dis nutrients e say dey help di body grow, repair itself, and stay active.
Health Benefits of African Mahogany Seeds (Akparata)
Bichi list some health benefits of akparata seeds to include:
1. E dey help to build and repair di body
End of Di one wey oda users dey read well well
African Mahogany seeds contain protein, wey dey help di body build muscles, repair damaged tissues, and support growth.
Di protein e dey give dey important for:
- Growing children
- Pregnant women
- Breastfeeding mothers
- Pipo wey dey recover from sickness as e dey help di body heal after injury.
2. E dey give di body energy
Dis seeds contain carbohydrates and healthy fats, wey dey give di body energy for daily activities like to waka, work, learn, and play.
Energy from food dey help di body stay active and strong throughout di day.
3. E good for digestion
African Mahogany seeds contain fiber, wey dey help food move properly for di stomach and intestines.
Fiber dey helps to:
- Prevent constipation
- Improve digestion
- Keep di stomach healthy
- Support regular bowel movement
- Help pesin feel full after eating.
4. E dey support heart health
Di healthy fats and fiber for dis seeds fit help to support a healthy heart. Dem fit help to reduce bad cholesterol and improve blood flow. A healthy heart go help to pump blood well around di body.
5. E dey help to control blood sugar
Becos di seeds contain fiber, dem fit help to slow down how sugar dey enter di blood after eating. Dis fit help to manage blood sugar levels, especially for pipo wey dey live with Diabetes.
6. E dey strengthen bones and teeth
African Mahogany seeds contain minerals like calcium and phosphorus, eye dey help to build strong bones and teeth, wey dey important for body movement and growth.
7. E dey help to make healthy blood
Dis seeds contain iron, wey dey help di body make healthy blood. Iron also dey help to carry oxygen to all parts of di body. Wen di body lack iron, pesin fit feel weak, tired, or dizzy.
8. E dey support healthy weight
Di protein and fiber for African Mahogany seeds fit help a pesin to feel full for longer period, so e no go quick dey chop-chop any how. Dis fit help to reduce overeating and support healthy weight management.
9. E dey protect di body
African Mahogany seeds contain natural plant compounds eye fit help to protect di body cells from damage. Dis dey support good health and strong body function.
‘Akparata seeds need proper processing and cooking’
Di dietician Ibrahim Abdulsalam Bichi give caution say di African Mahogany seeds suppose dey properly processed and cooked before eating.
“Raw or poorly prepared seeds fit dey hard to digest or fit contain natural substances wey fit reduce nutrient absorption. Proper cooking dey make dem safer and easier for di body to use.” E tok.
African Mahogany seeds (Akparata) na healthy local seeds wey dey provide important nutrients for di body, and e dey help with growth, digestion, energy, heart health, strong bones, healthy blood, and weight control.
Wen prepared well and used to make beta soup as part of a balanced diet, na ogbonge food for both children and adults.













