US authorities jail nine Ghanaians for 50 years ova romance fraud and oda scams

Published
Read am in 6 mins

American authorities announce say dem gbab two Ghanaian brothers and anoda woman sake of dem allegedly dey part of one criminal network.

Dis group allegedly dey responsible for plenty romance fraud wia dem use style to collect money from Older American victims for di US.

Inside one statement from di US attorney office for Northern District of Ohio, di two Ghanaian brothers be Jamal Abubakari (aka Jamal Abubakar aka Arrangement, 22) and Kamal Abubakari (aka Kamal Abubakar aka Lancaster, 22).

Di third pesin dem gbab wey be woman be Amanda Joy Opoku-Boachie (aka Amanda Joy Glum, aka Amanda Joy Kessei Bierman, 53).

Di indictment wey dem open for di US bin charge dis three pipo wit conspiracy to commit wire fraud and money laundering.

Dem arrest all dis three pipo for Virginia wey dem dey for custody ahead of dia court proceedings.

According to di allegations inside di indictment, di three pipo target older Americans on top dating websites and social media wey dem engage for romance and fraud schemes, from July 2024 to April 2026.

"Di defendants bin collabo wit odas to use fake identity to create personal romantic relationship wit victims wey dem dey use fake stories to collect money from dem thru wire transfer to dia financial accounts – dem send some to dia conspiracy members for Ghana and oda places," di US Attorney office explain.

Jamal Abubakari (aka Arrangement) and Kamal Abubakari (Lancaster) be socialites for Ghana wey dey popular sake of dem dey flaunt money and oda luxury properties.

Dem also release some songs as dem begin career as musicians.

Dem go soon appear bifor court to defend diaserf for di US.

US authorities confam say one US District Judge dey handle cases wey dey related to dis one, wey involve many Ghanaians wey fraud older American victims.

Dem dey put dis pipo for trial wey dem go soon sentence some of dem, but dem jail nine oda pipo up to 50 years for dis same crimes.

Di latest arrest of dis Ghanaians dey come days afta authorities for Netherlands arrest and detain one lawmaker Ohene Kwame Frimpong ova some fraud allegations.

Im lawyers and leadership for Ghana parliament dey work to find how dem fit secure im release from detention for Netherlands.

E no dey clear di specific charges but tori bin dey say im dey allegedly involved for fraud and oda scams for di US, na so district court for Illinois issue bench warrant for di 40-year-old.

Who be di Ghanaians wey dem jail for 50 years

For one popular case – di US v Frederick Kumi (aka Abu Trica) and Daniel Yussif (aka Denteni), dem charge dem wit conspiracy to commit wire fraud and money laundering conspiracy for December 2025.

Ghana authorities dey work to extradite dem to di US to face charges, but dia lawyers bin dey challenge di process since dem arrest dem.

Di lawyers say di kontri no get case against dia client to extradite dem wey dem allege say FBI officers wey go arrest am, torture am wey dem abuse im human rights.

But di court for Ghana still dey sit on top dis case wey dem give di suspects time to file dia documents against di extradition request from US authorities.

For anoda case – US v David Onyinye Abuanekwu et al, di defendants already dey jail afta dem plead guilty to conspiracy to commit wire fraud and money laundering conspiracy.

  • Dwayne Asafo Adjei, 29, chop 71 months imprisonment; three years of supervised release; wey dem order am to pay $372,943 for restitution.
  • Nancy Adom, 30, of Akron and Columbus, Ohio, chop 71 months imprisonment; three years of supervised release; wey dem order am to pay $1,079,559 for restitution.
  • Eric Aidoo, 46, of Columbus, Ohio, chop 71 months imprisonment; three years of supervised release; wey dem order dem to pay $668,228 for restitution.

Anoda defendant Nader Wasif, 31 also currently dey serve 12 months for jail sake of im plead guilty say im obstruct justice.

Im also dey under one year supervised release; wey dem order am to pay $172,644 for restitution.

For di case - US v Otuo Amponsah et al, di defendants dey prison afta dem plead guilty to conspiracy to commit wire fraud and money laundering conspiracy.

  • Otuo Amponsah 34, of Columbus, Ohio, chop 108 months imprisonment; three years of supervised release; wey dem order am to pay $3,324,675 for restitution.
  • Portia Joe 28, of Columbus, Ohio chop 51 months imprisonment; three years supervised release; wey dem order am to pay $2,035,438 for restitution.
  • Anna Amponsah 35, of Columbus, Ohio, chop 108 months of imprisonment; three years of supervised release; wey dem order am to pay $1,444,639 for restitution.
  • Dwayne Asafo Adjei, 29, citizen of Ghana, chop 71 months imprisonment; three years of supervised release; wey dem order am to pay $372,943 for restitution.
  • Hannah Adom, 27, of Akron and Columbus, Ohio, chop 71 months imprisonment; three years of supervised release; wey dem order am to pay $278,894 for restitution.

US authorities say dem dey pursue many more pipo to face justice

Apart from dis pipo wey bin dey jail for America, authorities say dem dey pursue many more pipo make dem face justice.

In fact US state Attorney office confam say one oda man Abdoul Issaka Assimiou, 37, of Cleveland, Ohio don plead guilty to conspiracy to commit wire fraud and money laundering conspiracy wey im dey wait im sentence by di court.

Dem tok say di FBI Cleveland Division wey lead investigations to dis indictments wey di justice department office for international affairs bin assist.

US Attorney David Toepfer say dem get national and international partners wey support dem for dis cases – including Ghana Attorney General office, di Economic and organized Crime Office (Eoco) and di Ghana Police Service.

Odas be di Ghana cybersecurity authority, di narcotics control commission, di Ghana immigration service and di financial intelligence centre as well as di Ghana National intelligence bureau.

Oda Ghanaians dey face trail for America ova similar charges.

Between last year and dis year alone, Ghana don send more than eight pipo to di US to face fraud charges and oda crimes.