How former minister of power Saleh Mamman go serve im 75 years jail term in absentia

Published
Read am in 4 mins

Di judgement by di Federal High Court, Abuja, Nigeria wey sentence former minister of power Mamman Saleh go 75 years imprisonment sake of corruption and fraud still dey cause tok-tok.

Court sentence am on Wednesday afta Justice James Omotosho for di judgement say di anti-corruption agency successfully establish say di former minister dey guilty beyond reasonable doubt.

Di charges against am include illegal diversion of public funds wey reach 33.8 billion naira, criminal breach of trust unto funds wey Nigerian govment release for di Mambilla and Zungeru Hydroelectric Power Project, among odas.

Court bin convict am convict am on May 7 on 12 count charges wey border on fraud and money laundering wey di EFCC file against am.

Court give di judgement even though im bin no showface by imsef for court.

Afta court give judgement say im must pay back di balance of 22 billion wey dey linked to di Mambilla and Zungeru power project, di Judge also say im go serve im sentences at di same time.

Pipo dey ask how im go take serve dis 75 jail term as im no showface for court and police neva still arrest am?

How Mamman Saleh go serve im jail term as police bin no arrest am?

Justice Omotosho say even though im bin no showface for court, im jail term go begin count anyday wey dem arrest am.

Di judge order all security agencies, plus international police (Interpol) to arrest Mamman anywia wey dem see am.

Di judge also say if dem see am make dem hand am ova to di Nigerian Correctional Service sharp-sharp to start in jail term.

Court rule say na anytime dem arrest am, im jail term go begin count.

For di judgement, Justice Omotosho rely on di provisions of di Administration of Criminal Justice Act, 2015 in agreement wit di EFCC counsel, Rotimi Oyedepo (SAN), dem sentence am even though im no showface for court.

Court give judgement few days afta Oga Mamman pick form to contest for govnorship for Taraba State ahead of di 2027 general elections under di All Progressives Congress (APC).

As e be so, Mamman wey bin serve as di minister of power under di late former Nigeria President, Muhammadu Buhari dey try to becom di govnor of Taraba State despite dis big corruption mata.

Wit dis judgement and wit di order wey court give security agencies to arrest am anywia wey dem see am, e mean say im political career and ambition for di 2027 election fit dey on hold.

Why corruption and power sector na five and six

Corruption na one of di biggest issues for Nigeria and govment afta govment, evri administration dey promise to remove or reduce corruption for di kontri.

Di tok-tok about how corruption dey affect almost all sectors for govment no dey make citizens enjoy beta infrastructure. E be like say tins dey worse wit evri administration.

Di power(electricity) sector na one wey most politicians for Nigeria dey use for dia campaign promises yet most part of di kontri dey in darkness.

Govment dey bring out money for power projects , dams and oda tins, but till now di national grid neva still balance.

Nigerians dey hope say time go come wen di largest kontri for Africa go at least get steady power supply.

Nicknamed 'Generator Republic' Nigeria dey suffer power outage for many years wey dey affect dia businesses and di economy even though dem dey supply electricity to oda neighbouring kontris.

Electricity tariff dey increase steady but pipo no dey see beta light,na dis tins dey vex pipo yet ministers no dey chop money for projects wey 2fit make light dey stable.

Apart from Mamman Saleh, di anti-corruption police for Nigeria EFCC bin invite Director -General of di Energy Commission of Nigeria (ECN) Director-General, Dr Mustapha Abdullahi, for mata wey dey related to corruption too.

EFCC bin also declare former Minister of Power and Steel, Dr Olu Agunloye wanted for corruption and forgery.

Dem bin accuse am of billion dollars fraud for di Mambilla hydropower contract. Tori be say im bin allegedly award di contract witout approval from di Federal Executive Council.

Im bin serve under former president Olusegun Obasanjo from 1999 to 2003.

Former President Obansanjo bin accuse say e mismanage power project during im tenure.