Why US impose visa ban on South African officials?

Wia dis foto come from, Getty Images
Di US don announce visa restrictions wey dey target pipo wey dem accuse say dem dey discriminate against South Africa white minority.
Dis na di latest of di escalation of tensions between di two kontris.
Donald Trump administration don criticise South Africa ova several issues, wey include policies wey dey aim at addressing racial inequality.
Trump say dis policies dey discriminate against Afrikaners, particularly descendants wey be Dutch and French settlers.
South Africa don repeatedly deny di claim.
"Di South African govment neva adequately address previously concerns wey dem lay out," Secretary of State Marco Rubio say for statement wey announce di restrictions on Tuesday.
E say di visa restrictions go target dos wey promote "race-based discrimination, incite violence, or enable land confiscation witout compensation for South Africa."
Rubio no immediately name any individuals wey dem target by di restrictions.
For November 2025, Donald Trump don announce say US no go attend di G20 summit for South Africa on top di widely discredited claims say dem dey oppress white pipo for di kontri.
Di US president tok say, na "total disgrace" say South Africa dey host di meeting, wia leaders from di world largest economies go gada for Johannesburg later dis month.
South Africa foreign ministry describe di decision of di White House as "regrettable".
Howeva, no South Africa political parties - including those wey represent Afrikaners and di white community in general – don claim say genocide dey for South Africa.

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin dey happun between South Africa and US
Di relations between di two kontris don carry nose enta ground since President Donald Trump return to office early last year.
Trump first cut aid, send away South African ambassador and offer "refuge" to white South Africans wey dey run away from "persecution."
But di South African govment don repeatedly reject allegations say e dey persecute white pipo or confiscating dia land.
SA tok say di claims of white genocide dey widely discredited and e lack reliable evidence.
South Africa latest crime statistics no indicate say more white pipo don fall victim to violent crime daan oda racial groups.
Trump offer refugee status to Afrikaners last year afta South African President Cyril Ramaphosa sign law wey allow di govment to seize land witout compensation.
For May 2025, Some white South Africans wey comot from dia kontri on Sunday don land for di United States.
Na one private charter plane carry dem afta di US give dem refugee status.
President Trump administration under di new program bin announce for February 2025 say dem go give di White Afrikaners refugee status.
Meanwhile, President Ramaphosa don call one group of 59 white South Africans wey japa go US to resettle say dem be "cowards", say "dem go come back soon."
Di group of Afrikaners land for US on Monday afta President Donald Trump give dem refugee status, say dem dey face racial discrimination.
But Ramaphosa tok say na pipo wey no happy with di way dem dey try fix wetin apartheid cause na im dey run comot, and e call di relocation "sad moment for dem".
"As South Africans, we dey strong. We no dey run away from our problems. We need to stay and solve our own wahala. Wen you run, na coward you be, and na real "cowardly act" e add.
Di legislation go allow di state to seize property in public interest and in some cases dem fit pay di owner zero compensation. But di law also require authorities to first try to reach agreement wit property owners, and disputes also fit dey decided by court.
Land ownership na still highly sensitive issue for South Africa more dan three decades afta di end of apartheid wen dem bin collect light from di black majority and deny dem plenty of dia basic rights.
Di govment tok say land reform dey necessary to address di historic inequalities and dem maintain say di new law no be simply to dey seize pipo land anyhow.
Plenty of di private farmland dey owned by white South Africans, who make up just ova 7% of di population.
For one separate social media post on Tuesday, Rubio accuse di South Africa govment say dem dey pursue "racial grievance against di Afrikaner minority" and say di pipo wey dey responsible for di injustices "no get any place for di United States".
Rubio say di South African govment fail to adequately address US concerns about wetin Washington bin describe as "govment-sponsored discrimination" against Afrikaners and oda minorities.
"Di United States no go allow such behaviour to go unchecked," e tok.
Di South African govment neva respond to di US restrictions.
Di US embassy for Pretoria tok say Washington bin tink say dialogue wit South Africa don end and dem accuse di African kontri say dem no demonstrate commitment to strong bilateral relations.
"Dis visa restriction policy na only di first step out of plenty escalatory measures wey go show America firm resolve for dis matter," di embassy tok.
South Africa bin make efforts to calm down di tensions wit US, as Ramaphosa bin visit di White House last May wit plenty delegation wey include white members of im coalition govment and also popular white South African golfers.
But Trump ambush di meeting s e claim say dem dey persecute and kpai white South African farmers - producing evidence wey don dey widely discredited.
Oda efforts by South Africa to repair di relationship don fail, and in August, di Trump administration hit di kontri wey be di largest economy for Africa, wit 30% tariffs on goods wey dem dey export to di US - di highest rate for sub-Saharan Africa.
Di latest visa restrictions dey imposed under one provision of US immigration law wey allow di secretary of state to prevent foreign nationals who e consider say dia entry into di US fit damage dia foreign policy interests.









