How America vote in maps and charts
- Author, Wesley Stephenson
- Role, Data Journalist
- Published
- Read am in 2 mins
Na ogbonge night for di Democrats so far for di US midterms elections.
Dem don take control of di Senate, and projections show say dem fit also win control of di House of Representatives, according to BBC partner, CBS News.
If dat happun, Democrats go control both chambers of Congress, wey fit make am easier for dem to push dia laws and policies.
For im reaction, Trump tell Fox News say di Democrats "try well-well", as e add say: "im dey a little surprised".
Senate
Di result for Senate pass wetin many Democrats expectations. Dem bin dey hopeful say dem fit win North Carolina, but victory for South Carolina come shock many pipo.
Even more surprising na say Kansas, wey neva elect any Democratic senator since 1932, now don return one Democrat go Senate.
Texas, Iowa, Ohio, and Maine don also turn blue. E still get one important Senate seat wey remain undecided for Alaska, and even Mississippi now dey on di edge, according to CBS News.
Polls bifor di election see say South Carolina dey follow Republican. Na deep red seat for many years, di last time dem get Democratic senator na for 1998.
End of Di one wey oda users dey read well well
House
BBC partner CBS News project say Democrats go win control of di House of Representatives shortly afta 03:00 GMT on Wednesday (22:00 EST Tuesday).
Democrats dey make di gains wey dem need to take ova di House, but dem no just wan win small, dem dey aim for one much bigger and historic victory.
Two important House seats for Florida, District 14 and District 25, still remain for Democrats hand. Dis one na setback for Republicans wey bin try redraw di electoral boundaries to favour dia party.
Afta di redrawing, both districts move from areas wey majority of voters support Kamala Harris for 2024, go areas wey majority vote for Donald Trump.
Anoda district, Florida 22, wey dem also redraw to favour Republicans, still end up for Democratic victory.
Hispanic voters turn to Democrats in Florida
Hispanic voters appear to be one of di key groups wey dey decide dis elections for Florida.
One big poll of voters show say 55% of dem support di Democratic Senate candidate, Angie Nixon, while 44% back di Republican candidate, Angie Moody.
Dis na turnaround from di estimated 55% of Hispanic voters wey back Donald Trump for 2024.
Di poll also ask wetin be di issues wey dey worry most voters. E suggest say for di kontri, di economy na di biggest issue, followed by di state of democracy.
Wen dem ask voters if Donald Trump policies affect economic conditions, di poll suggest more say two-thirds believe believe say dem make things worse.
Produced by Wesley Stephenson, Christine Jeavans, Daniel Wainwright, Becky Dale, Libby Rogers, Jess Carr, John Walton and Rob England.



















