Fotos of how stars and fans turn up for Taylor Swift and Travis Kelce wedding
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Swift don describe herself as "a long time Hugh Grant stan", and e invite di British actor wit im wife Anna Elisabet Eberstein
Published
Read am in 5 mins
Taylor Swift and Travis Kelce wedding bin take ova New York City on Friday, as plenty A-list celebrities and sports stars attend di star-studded ceremony for di Madison Square Garden, while dozens of fans gada outside.
Selena Gomez, Camila Cabello, Hugh Grant, Gracie Abrams, Ellie Goulding, Graham Norton, Dakota Johnson and Benson Boone dey among di big names on di guest list.
Dem neva release any official pictures from inside di venue, and many of di estimated 1,000 attendees bin enta without being photographed, but some of dem bin dey spotted on dia way in and out.
Wetin we call dis foto, Singer Camila Cabello, one friend of Swift, bin dey photographed for New York bifor di ceremony
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Actor Ethan Hawke bin show for di video for Swift 2024 single Fortnight
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Supermodel Karlie Kloss bin bicom close friends with Swift more dan ten years ago
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Former US football player Abby Wambach and author Glennon Doyle dey pictured as dem dey land
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Singer Benson Boone support Swift on her Eras Tour
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, NFL player Isiah Pacheco (left) na one of Kelce team-mates for Kansas City Chiefs
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Swift childhood friend Abigail Anderson dey among di guests
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Ted Lasso actor Jason Sudeikis bin also dey in attendance, two years afta e use one comedy event to ask Kelce wen e "go make an honest woman" out of Swift
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Seattle Seahawks player Cooper Kupp and im wife Anna Marie Kupp
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, US television presenter Jimmy Fallon don interview Swift on im Tonight Show
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Model Gigi Hadid and actor Bradley Cooper dey pictured leaving di venue
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Irish actor Andrew Scott dey among di odas pictured as dem dey comot di stadium afta night of celebrations
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Actors Jessica Alba and Danny Ramirez pictured as dem dey comot di event
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Plenty of fans no mind di hot weather as dem gada behind barricades surrounding di stadium
Wia dis foto come from, Getty Images
Wia dis foto come from, EPA
Wetin we call dis foto, Dozens of police officers dey deployed to patrol di stadium and dia surroundings
Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Wetin we call dis foto, Di couple nuptials dey confirmed outside di stadium at around 19:30 local time, wit one announcement wey read: "JUST&T MARRIED!"
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Outside di stadium, plenty shouts of excitement dey up as onlookers react to di wedding announcement
Wia dis foto come from, EPA
Wia dis foto come from, EPA
Wetin we call dis foto, One fan vow to chant Taylor Swift name outside di venue 100,000 times and stream am live on YouTube