Death toll from Nepal heavy flash floods rise to 903 as 4,247 pipo still dey miss
- Author, Phanindra Dahal and Laura Bicker
- Reporting from, Kathmandu and Beijing
- Published
- Read am in 6 mins
Number of missing pipo for Nepal don rise to 4,247 since flash floods hit di kontri last Wednesday.
Authorities say number of confirmed deaths na 903 so far as rescue operations continue five days afta di incident.
Out of di total number of missing pipo, 3,655 na Nepali citizens, while about 592 na foreigners wey dey unaccounted for.
Di incident happun for Nepal border wit Tibet.
Inside Tibet, official death toll na 16, while missing pipo na 546 according to Chinese state media.
Tori be say hundreds of di missing pipo na employees of Nepal hydropower sites, some of dem bin dey work inside tunnels wen di incident happun.
Di flash flood bin wash away villages and destroy roads and infrastructure.
Di army tok-tok pesin bin tok say dem don rescue 50 foreign nationals, including 30 Indians, eight Chinese, eight Koreans, two Americans and two Italians.
End of Di one wey oda users dey read well well
South Africa foreign ministry don confam say six of dia citizens dey among pipo wey miss afta di heavy flood wey happun for Nepal.
Di South African govment say dem don contact di families of di missing pipo, although dem neva confam dia identities officially. More details about di six pipo wey dey on holiday for Nepal go come out later.
Di US Geological Survey say na "glacial collapse and debris flow" trigger di floods.
Authorities don set up relief camps to support pipo dem rescue. Dem set up camps for rescue workers too wit relief materials.
Nepal PM visit area wey dey affected by flash floods

Wia dis foto come from, PMO Nepal
Nepal Prime Minister Balendra Shah don visit some areas wey dey affected by di flash flood, including Bidur and nearby communities for Nuwakot district.
During di visit, e meet local officials, security agencies and community representatives to check di level of di damage and discuss di response effort.
Di prime minister tell authorities say make dem provide immediate help to di families wey di flood don displace, reopen blocked roads, and fix di damaged infrastructure as soon as possible.
Shah say im dey left wit "heavy heart" afta di kontri fatal flash floods.
"Di whole nation dey shocked and deeply distressed" by di loss of life and damage to property, e tok for one social media post, as e call di disaster "sudden" and "massive".
Di flood happun for di early hours of Wednesday for Rasuwa, just north of Nepal capital Kathmandu.
Initial information suggest say na earthquake wey trigger one avalanche wit melted snow wey dey pour into di Bhote Koshi river cause am.

Wia dis foto come from, Shaktimaya Tamang

Wia dis foto come from, Reuters
Several areas downstream of di Bhote Koshi river, wey dey flow from Tibet to Nepal, dey on high alert and roads, communications and power for di region also dey affected. Authorities don close di main road to Kathmandu.
Verified videos from Nepal show as water carry one bridge comot and as multi-storey buildings collapse by di force of floodwaters - one town wey also get many buildings destroy.
BBC Verify don locate di clips to di town of Trishuli Bazaar area of Nuwakot District for Bagmati Province, about 25km (16 miles) to di north-west of Kathmandu.
Di video show as di river Trishuli suddenly swell by plenty amounts of water, wey appear to don significantly increase in volume and speed and filled wit sediment.
Di second verified video, wey dem feem from di same location, show di destruction. Di river level don rise well-well, and di water clear trees and many buildings wey dey visible for di earlier video.
One new video wey dem feem from inside one bus for Trishuli show as many pipo dey try run as flash flood rush down di valley.
Pipo fit hear as di passengers dey cry, as di bus drive along di road wey follow di river.
Climate change contribute to di glacier collapse?
E still dey early and scientists dey try put togeda wetin really dey happun. Satellite imagery and seismics analysis show di huge avalanche of ice and rock wey don crash into di valley and cause flood.
E still dey too early to determine
E dey too soon to determine di role wey climate change dey play, although researchers tok say e fit don contribute.
Temperature dey rise, dey cause mountain glaciers for evriwia to dey move back and permafrost (di frozen ground for below) dey start dey melt - potentially destabilising steep slopes by weakening di ice wey help bind fractured rock togeda.
Scientists tok say dis kind high-mountain hazard don become big concern across di Himalayas.
'Water carry my family members away... for front of my eyes'
Some survivors of di flash flood follow BBC tok.
"Flood sweep my family members away for front of my eyes," Kalpana Malla from Nepal Nuwakot district tok.
She say di flood clear her papa, mama, sister and her sister children away.
"Dem no fit escape di flood; no chance at all," she tok. "Dis flood take evritin except my son and I climb di rooftop of one house and survive but I no fit explain how."
Her son, Sugam Malla, say im pull im mama hand to save her.
Anoda woman, Goma Pandit, tok say she lose her buffaloes and all her oda cattle.
"My farmland don go. Ten sacks of mustard seeds, tons of corn and rice paddy evritin don go. Notin remain."
Nepal Army tok-tok pesin Rajarm Basnet tell BBC say efforts dey go on to rescue 115 pipo from di village of Mailung.
Nepalese Ministry of Home Affairs say huge loss of life go likely dey for Timure, Syabrubesi and Betrawati. Flooding don also cause damage to di Trishuli hydropwer project.
Di extent of di damage on di Tibetan side neva dey clear but BBC tok to Guan Daoxuan for Sichuan province wey tok say im lost contact wit im wife on Wednesday morning.
Nepal disaster management authority don ask pipo wey dey live near river banks for vulnerable areas to remain alert and take precautions.
Nepal Foreign Affairs minister Shishir Khanal tell parliament say 26 police personnel, nine armed police officers and 44 members of di military dey miss.
E say earthquake at 08:37 local time bin trigger avalanche and preliminary information say na wetin cause di flash flood.
Rasuwa bin see deadly flooding last year wey kill 18 pipo afta glacier burst on di Chinese side of di border.















