You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Late Tielemans extra time penalty comot Senegal for World Cup Round of 32
Anoda heartbreak for Senegal for extra time as Belgium sama di Teranga Lions 3-2 for dia Round 32 clash for Seattle.
Senegal bin take 2-0 lead for di 51st minute afta Habib Diarra bin score for di first half.
At dat time, di game bin dey di control of Senegal, but Belgium fight back to equalize 2-2 late for regulation time to carry di game enta extra time.
Substitute Romelu Lukaku wey be di all-time top scorer for Belgium wit 91 goals, pull one back for di 86th minute when im connect wit anoda substitute Meunier im cross from di far side.
Belgium now begin to put pressure and pepper wey dem score again for di 89th minute through dia captain Yuri Tielemans.
Di Aston Villa man rise to use im head meet one cross inside di Senegal area when di keeper fail to catch di ball.
Dat second Belgium goal bin sink Senegal – as dem tink say dem bin do enough to win di game bifor.
For extra time, Senegal lose dia shape we Belgium begin to put more pressure to score.
Substitutes Moreira, Raskan and Lukebakio wey enta di game for di second half to replace Jeremy Doku, De Bruyne and Vanaken, pepper di Senegalese until de, win last-minute penalty for extra time.
Senegal midfielder Lamine Camara bin foul Yuri Tielemans inside di box when im try to connect wit one cross.
Afta long VAR check, referee bin award di penalty – wey dia captain Yuri Tielemans score to win di game.
Dat last-minute penalty for Senegal and many fans around di world na dejavu for dia 2025 Afcon final when Morocco bin win last-minute penalty against Senegal.
Di only difference dis time be say Belgium bin score am unlike Morocco wey miss am thru Brahim Diaz.
Wit dat 3-2 result, Belgium qualify for di R16 for di competition, wey dem go jam wit USA or Bosnia.
For Senegal, dat result boot dem out of di competition for di R32.
Heartbreak for Senegal, joy for Belgium and di tournament dey continue.
Senegal join DR Congo wey also bin lose last-minute 2-1 to England and Ivory Coast wey bin lose 2-1 to Norway, to comot di tournament.
For now, four African kontris out of di 10 now comot di tournament.
Second Half Extra Time
FULLTIME FOR EXTRA TIME. Belgium 3-2 Senegal
Pape Mata Sarr play di freekick ova di bar and refreee don blow whistle for di end of di game.
120+11" Senegal go fit take advantage to score?
Freekick to Senegal for di edge of di Belgium area. Big Chance for Senegal to equalize now.
120+10" Courtois bin catch di ball.
120+9" Senegal get last chance to put di freekick into di Belgium area. Dem play am but di red devils don defend.
Senegal still get di ball. Mbaye, Pape Sarr dey try to pass dia way for di Belgium area.
120+8" Senegal get di ball, dem dey try to attack to find di late equalizer.
120+7" Onana bin dey ask im teammates to relax and hold di ball to waste some more time.
120+6" Senegal try to attack right afta. Pape Mata Sarr blast di ball way ova di bar from outside di box.
120+5 "Goooal! Yuri Tielemanns carruy di ball wey im score. Belgium lead 3-2
Bifor dat, Senegal players bin dey want make refree book Moreira for one off-di-ball incident.
120+3" Lukaku na di pesin to take dis pressure penalty. Im fit score?
Dejavu!
Who go take di penalty now? Dis bin dey resemble di Afcon final last-minute penalty when Senegal jam wit Morocco.
120" Afta di referee check di monitor, im decide say na penalty to Belgium!
Referee Said Martinez don go to di monitor to check.
118" VAR bin dey check for possible penalty now. Senegal players dey surround di officials.
117" Di Belgium players dey call for penalty, afta Camara foul on Tielemanns.
CHANEC! Lukebakio get one chance wit di goal, im strike di ball wey im crash over di crossbar when e dey easy to score.
116" Moreira drive di ball for di flank wey im play one ball inside di Senegal box for Lukaku, di big strike no fit connetc wit dat ball, goalkeeper Diaw don catch am
115" 5 more minutes to go. Who go fit get di goal?
Tielemanns im long ball beat everybodi, Lukebakio no fit reach am.
114" Diouf bin play di corner, Courtois catch am las las.
113" Nicolas Jackson drive into di Belgium box wey im dance around and win corner.
Tension now dey rise again as di game dey go on. Anybody wey ,ake mistake for hia, na di enend be dat
112" Ndiaye strike one shot from outside di box, Courtois catch am easy.
111" Belgium get di ball now, dem dey try to pass am around, Senegal win throw-in.
110" Afta treatment Moreira don look like im dey okay. But im gatz comot di park for one minute.
109" Freekick to Belgium for di Senegal half, afta Moreira fall for ground for one aerial ball.
Amadou Onana don enta di game to replace Leandro Trossard.
108" CHAAAAANCE! Senegal tink say dem win di game now. Mbaye wit im left-foot shot dey inches wide.
Senegal dey control di ball now till dem cross di ball inside di Belgium box, but dem don clear am.
107" Freekick to Senegal for di center circle. Belgium dey try to make anoda last substitution.
106" Senegal dey too quick to begin to attack, dem win throw-in but dem bin lose di ball. Raskan no fit connect wit di Belgium cross. Chance don vanish
105" Senegal don pass di bal to begin di second half for extra time.
At dis time players don taya well well.
15 minutes more to find di winner for dis game, odawise na penalty shootout go determine am.
First Half Extra Time
105" HALFTIME FOR EXTRA TIME
104" Chance! Belgium miss ogbonge chance. Trossard hit di shot wey e don bounce off di Senegal defender bifor anoda Belgium player hit one shot wide.
103" Throw-in for Belgium, Nicolas Jackson carry head touch di ball.
Senegal for di last 20 seconds bin dey pass di ball among diaserf.
102" Trossard bin carry di ball give Mbaye as christmas gift; Senegal no fit use di ball to create danger.
100" Chance! Belgium try to create anoda chance - Lukaku im leg miss di ball by inches.
99" Belgium hassle to collect di ball for Senegal dia hands. Trossard try to use backeel to pass di ball to Lukaku but Seneegal defender read am well.
98" Freekick to Senegal in front of dia own box afta Belgium try to win di ball.
97" Di Red Devils bin dey pass di ball around to allow Senegal to comot and tackle
96" Freekick to Senegal, goalkeeper Diaw play di ball inside but Belgium get possession now.
95" Di game don calm down now. Nobody dey rush to create chances so far.
Pape Thiaw carry young players enta di game now to try and find di winning goal.
94" Iddrisa Gana Gueye don comot for Ndiaye.
Nicolas Jackson already try to reach one long ball ova di top but di Belgium keeper collect di ball.
93" Di game don restart. At dis point whoever go score again get chance to win am.
Bifor dat, dem bin dey make changes for Senegal. Sadio MANE don dey comot, jakobs also comot. Diouf and Nicolas Jackson don enta.
92" Freekick to Senegal.
Lukaku tink say im win freekick afta dem push am but referee say play on
91" Belgium get possession now, di defenders don dey pass di ball amond diaserf
90" Senegal try to begin di attack early for dis first half extra time.
Di game don resume as extra time start. Which of di teams go find di winning goal.
Second Half
FULLTIME!
90+7" Senegal get throw-in for di left side of di Belgium box.
90+6" Gana Gueye shoot from way outside di box afta some patient passing by Senegal, di ball go wide. Courtois bin cover im pole well.
90+5" Senegal try to create sometin, Mbaye lose possession wey Belgium clear dia lines.
90+4 Senegal try to cfreate one attack for diaserf. Dem reach di box wey dem carry di ball go back to dia midfield., Time bin dey go.
Lukaku try to connect wit one ball, Belgium try to create anoda chance but referee blow whistle for offside
90+3" Freekick to Senegal afta Belgium player block di keeper when im try to play di goalkick.
90+2" Diaw comot to catch one cross to reduce di pressure on Senegal.
Belgium now dey put pressure to find di winning goal. Dem win corner from one counter attack.
+7 mins
87" GOOOAL! Yuri Tielemanns head Belgium equalizer into di net. Di Keeper comot but miss di ball.
85" GOOOOAL! Romelu Lukaku score for Belgium. Munieir bin cross di ball into di box for Lukaku to score im 92nd goal for im kontri
84" OFFSIDE! Referee don blow whistle for offside many seconds afta Sadio Mane collect di ball wey im shoot for goal; Courtois bin make igbionge save, bifor di ref later call for offside.
83" Chance! Tielemanns strike di ball inches wide off di crossbar.
82" Chance for Belgium! Castagne head one Lukebakio cross wide.
81" Lukebakio don misplace anoda pass for throw ball for Senegal.
80" Moreira bin dance around wit di ball for many seconds , im now try to use di outside of im boot to pass di ball to im teammate for defence, but im rather foul di Senegal attacker, Freekick for di edge of diu Belgium box.
79" Lukabakio dash di ball to Sadio Mane for di Belgium area wey dem begin to attack but Thomas Meunier don block di ball
ThomasMeunier don enta di ga,e to replace Ce Cuyper.
77" Chance! Lukabakio get chance to shoot from di edge of di box, in left footed shot miss di post by inches.
76" Senegal block anoda Belgoum attack and try to start one quick counter attack but di ball be too hard for Sadio MANE
75" Belgium bin dey prepare anoda substitution to try and find di goal.
74" Lukabakio lose possession in front of di Senegal area, im sit for ground as Senegal begin to attack
72" Habib Diarra di first goal scorer comot, Pape Mata Sarr don enta. Also Ilimann ndiaye comot for Mbaye
Senegal gat 20 minutes plus added time to qualify for di R16, Belgium gatz 20 minutes to rescue dia World Cup campaign.
WATER BREAK!
68" Senegal keeper Diaw catch di ball wey bounce for air afta im defender balloon di ball
66" Pape Gueye don comot wey dem replace am wit Lamine Camara. Di midfielder wey no chop up to one minute for di park, chop yellow card for foul on Trossard.
65" OFFSIDE! Trossard bin try to reach one ball wey Lukaku don hold up, di Arsenal man foul im marker but referee already raise hand for offside.
63" Brandon Mechele chop yellow card for foul on di goalscorer Ismaila Sarr.
62" Vanaken don comot, Moreira don enta di game for Belgium
61" Belgium bin dey create more chances now, Lukabakio get anoda chance to shoot afta Lukaku put di ball on top plate for am, but Senegal defend well.
60" Corner to Belgium. Tielemanns bin shoot on target to try and catch di Senegal keeper for di first post. Di subsequent corner be poor. Senegal clear dia lines.
59" Belgium chance. But Senegal defenders put dia bodies for di floor to block di shot from Lukabakio.
57" Diatta bin win freekick afta Raskan don foul am minutes afta im enta di game.
Senegal dey attack for di far left side and almost create anoda goal chance.
56" Raskan and Lukabakio don enta di game. Make we see if dem fit inspire any comeback.
54" Belgium dey for serious trouble now. Doku dey try to dance around im markers but no end product. In fact dem don comot am and De Bruyne for di game now.
GOOOAL! Brilliant goal by Ismaila Sarr. Di striker collect one ball ova di top for im chest, wey im smash di ball into di net. 2-0
50" Chance! Senegal nearly score dia second goal. Habib Diarra bin miss di chance afta Sadio Mane pass di ball to am inside di box.
48" De Cuyper misjudge one pass wey di ball comot for thrwo-in.
46" Belgium begin di second half wit poor passes for midfield, Senegal take advantage to now keep di ball
Chance! Ilimann Ndiaye get big chance to score afta small Senegal pressure, but im left-foot effort go wide, im no test Courtois.
45" Referee don blow whistle for di second half to start. Senegal don pass di ball.
Belgium carry dia all-time top-scorer Lukaku dey enta di game to try and find di goal. Im dey replace De Ketelaere.
Belgium dey struggle to breakdown di Senegal defense, dem fit do am for di second half?
45+5" HALFTIME!
45+4" De Cuyper shoot di freekick straight for di wall. Di chance don waste.
45+3 " Freekick to Belgium for di front of di Senegal box wit seconds to halftime.
45+1" Senegal get counter attack - di ball fall to Iliman Ndiaye, im hold di ball too long wey di chance vanish.
Dem don announce five additional minutes for di first half.
+5 mins
44" Chance! De Cuyper bin shoot from outside di box afta di short corner, Morv Diaw bin make unbelievable save dia.
Corner to Belgium now!
43" Chance for Belgium. De Bruyne find Doku, but afta di Manchester City attacker dance inside di box, im shot dey deflected into di hands of Morv Diaw di keeper.
42" Belgium recycle possession afta Senegal try to play on elong ball to dia striker.
41" Freekick to Senegal, Diatta say De Cuyper bin foul am. Im dey for ground.
40" Belgium dey pass di ball around di Senegal box dey try to find space, De Cuyper carry di ball go di far left wey im put one low cross inside di box - Senegal clear am.
39" Long cross into di Senegal box, easy catch for Morv Diaw.
37" Doku still dey try to create sometin for Belgium, im dance around bifor passing di ball to di box, De Bruyne no fit reach di ball, Senegal now clear dia lines bifor Trossard go reach dat ball.
35" Senegal dey knock for di Belgium door. Mane enta di box afta some fine play by Gana Gueye but di shot dey weak for Courtois.
34" Throw-in to Belgium for di far right, Doku nd De Bruyne try to play di one-two wit Doku but Senegal block di ball.
32" Mane try to collect one long ball ova di top, but im no fit reach dia. Goalkick for Belgium.
Senegal get 5 shots wit 2 on target and one goal, Belgium get only 2 chances wit one on target.
31" Senegal coach Pape Thiaw dey give im players sign say make dem use dia head and calm down.
Belgium go hope to get quick equalizer but ref don stop di game again. Some intruder don enta di park.
30" Game don restart.
WATER BREAK!
26" Dat Senegal goal na one wey dem deserve sake of na dem create di beta chances for dis first 20 minutes
24" GOOOOAL! Habib Diarra score for Senegal. Mane bin cross di ball, Courtois no fit catch di header, di ball hit di post back into play wey Diarra tap inside di net.
23" Senegal dey maintain di ball well for di last one minute, Belgium dey struggle to block dem.
22" Teranga Lions dey pass di ball around very well, Belgium no fit collect, dem win thorw ball for dia effort.
20" Di pressure don calm down small, Senegal dey try to maintain possession small bifor dem go try to attack.
19" OFFSIDE! Mane dey offside - Senegal begin to counter afta De Bruyne im pass towards di striker no reach am. But bifor Mane go collect di pass, dem don raise flag for offside.
18" Corner to Senegal. Mane play one cross-field to Diatta. Di fullback bin dey ready to cross di ball into di Belgium box, but dem defend dia lines
16" Gana Gueye shoot from outside di box afta Senegal break for di counter attack. Im shot dey simple for Courtois.
15" Theate don clear one dangerous ball for Ismaila Sarr from Sadio Mane.
14" Sadio Mane dey tok im teammates to calm down and use dia head as di game don dey become end-to-end.
12" Chaaance! Ismaila Sarr bin miss ogbonge chance. Courtois almost dash Senegal goal for dia. Di keeper palm di ball straight in front of Ismaila Sarr but di striker im soft touch carry di ball go wide.
11" Di game bin dey settle but Tielemanns don dash ball to Senegal for midfield.
Senegal bin cross di ball from di far right but nobody fit apply di touch to score.
10" Senegal try to counter quick quick but Belgium man foul di attacker, Ref don blow whistle.
8" Chance for Belgium! Trossard shoot on goal but Diaw catch am easy, afta De Ketelaere fail to play di shot when im get di chance.
7" For di last 40 seconds di two teams bin dash possession to each oda under no pressure.
6" Sadio Mane win freekick inside di Senegal half. Dem play am short, wey dem begin to pass am among diaserf for defence.
5" Chance! Belgium drive forward wit Castagne, di defender cross di ball inside di box but bifor im go find im teammates, Senegal don clear am.
4" Senegal dey play some fine combination for di front of di Belgium box, Ilimann Ndiaye and Sarr combine but di final pass don miss.
Throw-in to Belgium but dem carry di ball give Senegal, di Teranga Lions no fit progress
3" Doku try to twist and turn inside di Senegal box for dia first attack bifor di defenders clear di ball.
2" Senegal begin to drive down di flank - Sadio Mane reach di line wey im cross di ball, Belgium clear dia lines
Belgium begin to pass di ball among doaserf bifor dem lose possession to Senegal. Di Teranga Lions also try to string some passes togeda.
1" Afta di fans countdown for di stadium, referee Said Martinez don blow whistle for di game to start.
All players and staff form around di circle wia dem sing di two national anthems.
Wit di cheers from di fans, di players waka comot di tunnel wey dem enta di park.
Belgium bin dey wear dia sea blue and white jersey, Senegal dey wear dia green jersey.
VAR referee na Guillermo Pacheo from Mexico, assistant VAR Rodolpho Toski from Brazil and Carlos Del Cerro Grande from Spain.
Fourth official and reserve assistant referee comot Colombia – Andres Rojas and Alexander Guzman.
Center referee for di game na Said Martinez from Honduras wit assistant 1 and 2 all from Honduras – Walter Lopez and Christian Ramirez.
Di weather dey perfect for dis R32 game as di Red Devils and Teranga Lions wan qualify to di R16.
Holaaaa! Welcome now to di Seattle Stadium for di US as for di first time neva, Senegal and Belgium dey jam each oda.
First Half
Welcome to dis ogbonge match between 2021 Afcon winners Senegal and di Red Devils of Belgium – di last of di 'golden generation'.
Di Teranga Lions go hope to become di second African kontri to qualify for di R16 afta Morocco.
Two oda African kontris – Ivory Coast and DR Congo now don join Tunisia to comot for di tournament.
But wit di way Senegal take qualify for dis R32 (as one of di best third-place teams), dem go hope say tins go work for dia favour.
For di Red Devils, dia last game against New Zealand wen dem sama dem 5-1 give dem confidence say dem fit win dis game.
But afta 90 minutes and maybe 120 minutes, we go find out which of di two teams go qualify.
E go be di Teranga Lions or di Red Devils?
Only time go tell.
Make we check di lineups for di two teams as Pape Thiaw and Rudi Garcia prepare to jam each oda.
Senegal XI: Morv Diaw (GK); Pathe Ciss, Niakhate, Kreptin Diatta, Ismail Jakobs, Gana Gueye, Pape Gueye, Habib Diarra, Sadio Mane ©, Iliman Ndiaye, Ismaila Sarr
Belgium XI: Courtois (GK); Castagne, Theate, Mechele, De Cuyper, Vanaken, Tielemans ©, De Bruyne, Trossard, Doku, De Ketelaere
Make you join us at 8PM GMT (9PM WAT) for live commentary for dis game for di Seattle Stadium for di US.