You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ghana govment condemn killing of citizen during South Africa anti-immigration protests
Di Govment of Ghana don condemn di fatal shooting of one of dia citizens for Cape Town, South Africa during di anti-immigration protests on 30 June 2026.
Inside one statement, di foreign affairs ministry confam say dem identify di deceased as 40-year-old Bashiru Isak, wey di shooting happun for Khayelitsha for Cape Town.
Authorites for South Africa neva comment on di killing.
Di latest information dey come afta reports of looting of shops and attacks on African migrants for South Africa bifor and during di 30 June nationwide protests.
Di kontri say plans dey underway to repatriate di body of di deceased to im family for Ghana for burial, as di govment also report di mata to di police and oda agencies for South Africa…
Details of di shooting incident and wetin Ghana govment dey do
Di kontris foreign ministry say di report don shock dem well well, especially afta many African kontris don demand protection for dia citizens by South African authorities bifor, during and afta di 30 June nationwide anti-immigration protests.
But reports of looting, attacks and harassment for some areas dey vex dis African kontris – especially Ghana, Nigeria and Malawi.
Ghana govment say those wey dey responsible for dis latest killing gatz face di law.
"On di instruction of di foreign ministry, di kontris High Commission for Pretoria don file protest for di department of international relations and cooperation wey dem also file complaint wit di South Africa police," di statement tok.
Ghana authorities say dem bin notify di family of di deceased, wey di govment demand for autopsy wey South African authorities don do.
Di foreign ministry say "Ghana dey demand full-scale investigation and arrest and prosecution of pipo wey dey responsible for dis killing."
Di 40-year-old victim according to tori na tailor wey bin dey stay for South Africa for 20 years.
Local media network for Ghana, JoyFm don report say di deceased bin die afta dem shoot am for im shop.
"Dem bin reportedly shoot Bashiru for im shop during di protest, im get three children – di eldest one reportedly dey 10-years old."
Ghana govment say plans dey underway to repatriate im body to im family for Ghana for burial.
"Di ministry dey extend dia condolences to di family of Bashiru Isak for dis tough time."
Meanwhile govment say dem dey work to evacuate more than 900 citizens wey register for voluntary repatriation.
Di High Commissioner Benjamin Quashoe tok say di process of screening and registration by di South African authroities bin delay di process.
"About 900 pipo don write dia names wit us, if you add dat number to di almost 1,000 pipo we evacuate already, dat na nearly 2,000 pipo."
Im add say "we don put some of dis Ghanaians for some accommodation wia we don tok police wia dem dey so say dem go protect dis location against attacks."
E neva dey clear when di evacuation of di 900 pipo go happun, but wit di latest report of di killing of 40-year-old Bashiru, tension go dey rise again, especially as anti-immigration vigilantes and groups say dem go continue dia protests every Thursday until dia govment fix dia economy, illegal migration crisis and odas.
Meanwhile Ghanaians wey decide to continue to stay for South Africa dey advised to remain vigilant and avoid high-risk places.
Dem also dey advised to contact di Ghana High Commission 24-hour emergency numbers for help.
Ghana say dem go "continue to pursue diplomatic, consular and multilateral channels to protect lives and welfare of citizens abroad."