You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Erling Haaland late goal break Ivory Coast World Cup hopes
Ivory Coast don comot from di 2026 World Cup afta dem lose 1-2 to Norway wey qualify for di Round of 16.
Di Elephants fight from start to finish but dem no dey sharp for dia attack as dem no fit score for di first half wit all di beta chances dem get.
Antonio Nusa of Norway score Norway first goal for di 39th minute afta Odegaard give am ball.
Amad Diallo of Ivory Coast come from di bench for second half to score dia first goal for di 74th minute wen Pepe pass ball di am.
Ivorian fans bin dey happy bifor Erling Haaland fire di second goal to break dia heart for di 86th minute.
Ivory Coast hustle for di last minutes but dem no fit score di equalizer.
Norway qualify for di Round of 16 for di Fifa World Cup for di first time.
Match Highlights
Second Half
Full Time
Norway progress to Round of 16
Ivory Coast 1-2 Norway
90+7 Referee blow whistle match don end.
90+6 Freekick for Ivory Coast Amad Diallo play am straight into di net but Norway goalkeeper stretch im hand and body to save di ball wey don almost enta net.
90+4 Kasala don burst for field as tension dey build up for di match sake of how Sangare of Ivory Coast and one Norway player jam head.
90' Referee add 7 minutes
89' Norway miss anoda chance to make am three as Ivory Coast dey hustle for goal.
87' SUBSTITUTION for Ivory Coast Pepe don comot
Ivory Coast 1-2 Norway
86' GOALLLLLLLLLLLLL! for Norway! Erling Haaland score Norway second goal.
80' Amad Diallo wey get injury bin comot from di match for one minute but im don enta back.
77' Di match don hot afta dis Ivory Coast goal, Norway don comeout to attack more while Ivory Coast players dey defend.
Ivory Coast 1-1 Norway
75' Stadium vibrate as Ivory Coast score, afta Amad Diallo fire di ball from corner enta net.
75' GOALLLLLLLLLLL! FOR Ivory Coast, Amad Diallo wey come from bench don score.
71' SUBSTITUTION for Norway, Goalscorer Antonio Nusa don comot e already get yellow card so e beta to change am.
68' Norway get chnace to score but Ivory Coast defenders balance for ground. Dem don go water break.
64' Norway dey press Ivory Cost to find second goal but e neva work.
60' SUBSTITUTION for Ivory Coast, Bonny and Christ Inao Oulai don comot Amad Diallo and Elye Wahi enta.
58' Ivory Coast just save dia sef as dia goalkeeper catch ball wey Norway bin wan score.
55' CHANCE for Ivory Coast, Diomande play di first shot defender block am, di next shot goalkeeper leg block am. Ivory Coast dey play well but den need beta luck for dis match.
54' Norway carry ball run enta Ivory Coast goal area but e ball no reach anybody, evan as Sorloth and Haaland bin dey wiat for di ball.
53'Norway don collect ball from Ibory Coast and dem dey dominate di midfield now.
49 Ivory Coast player pass ball wey corss Norway 18 yard box, corner for Ivory Coast, dem play am but Norway defence clear am.
48' Ivory Coast start dis second half wit beta ginger again as dem dey try create chances.
47' Freekick to Ivory Coast afta Norway foul Ivory Coast player.
46' Second half don start
First Half
Half Time
Ivory Coast 0-1 Norway
45+4 Referee don blow whistle for half time.
45+3 Ivory Coast dey play well for dis first half but dem neva see goal, Norway just see half chance and dem score.
45+1 YELLOW CARD! Antonio Nusa of Norway don collect Yellow card afta e foul Ivory Coast player. Antonio Nusa na im just score Norway goal.
45' Referee don add 4 minutes
44' Ivory Coast don get plenti corner kick chnaces but all dia attempt dem neva bring any goal.
42' Norway dey put pressure on Ivory Coast since dem score, Norway don miss three chances just now, one of dem na Sorloth wey pass ball to Haaland but Haaland no too balance as e head di ball to corner.
Ivory Coast 0-1 Norway
39' GOALLLLLLLLLLLLL for Norway! Antonio Nusa score for Norway as e fire di ball from outside di goal area straight inside di top right corner of di goal post afa Martin Odegaard pass ball give am.
38' Odegaard of Norway pass ball to Sorloth wey pass di ball to Odegaard but Ivoey Coast defence too storong dem black all di shots.
37' Sorloth of Norway pass di ball to Haaland wey head di ball towards goal but di header no get power as Ivory Coast goalkeeper catch di ball.
36' Ivory Coast dey lead di ball possession but di difference no too big for Norway.
34' Diomande of Ivory Coast play dia corner kick, dem use di ball dey dance around Norway defence untill e hgo out of play.
33' Norway don collect ball from Ivory Coast hand and dem dey play short-short passes for di midfield to dray Ivory Coast come outside.
32' Nicolas Pepe of Ivory Coast dey give teammates beta passes but dem neva still find di net till now.
30' Ivory Coast do beta counter attack as dem dey make attempt to score but e enta corner kick. Dem play am but e go corner kick again.
28' MISS! Beta chance for Ivory Coast, Nicolas Pepe get chnace to fire straight shot inside net but e pass am give im teammate wey play am go meet Norway defender wey clear di ball go corner kick.
27' Dem don return from water break and match don continue.
23' Corner kick for Norway dem play am but Ivory Coast defenders clear am comot but in di process Yao Diomande collide wit Norway player, referee blow freekick, but time don reach for water break.
21' Ivory Coast get chance to score but di player afta e delete di defenders wey dey im front, e put di ball for di side net.
20' Norway try enta Ivory Coast goal area but defnder clear am.
18' Ivory Cost dey worry Norway for di last two minutes for dia goal area, Ivory Cost hold di ball but Norway defender force di ball go out of play for danger zone.
15' Corner kick for Ivory Coast but Norway defence clear di ball.
13' Alexander Sorloth of Norway carry ball dey run go Ivory Coast area but Ivory Coast young defender tiff di ball from im leg , Sorloth fall for ground.
10'Ivory Coast no dey give Norway chance to play dia game as dem dey follow Norway players neck to neck.
9' Pepe of Ivory Coast play di corner kick wit beta cross but e no meet any of im teammates wey for fire am enta goal.
8' Ivory Coast get chance for Norway goal area but defender no let am pass, corner kick for Ivory Coast.
7' Norway fans full evriwai for di Dallas stadium dey ginger but Ivory Coast fans even though dem no plenti still dey show diasef.
5' Norway dey control di ball now as dem dey do short-short passes., dem dey try build up from back.
3' CHANCE for Norway, Erling Haaland head di ball for Ivory Coast goal aread but e land fpr defender body wey laster clear di ball to safety.
2' Ivory Cost start di match wit beta ginger as dem hold ball ball Norway don collect ball from dia leg.
1' Match don start
Starting Line up
Ivory Coast : Y. Fofana; Doue, Kossounou, Agbadou, Konan; Oluai, Sangare, Kessie, Y. Diomande; Pepe, Bonny.
Norway: Nyland; Pedersen, Ajer, Heggem, Wolfe; Odegaard, Berge, Berg, Sorloth, Haaland, Nusa.