President Tinubu condemn killing of schoolteacher wey bandits kidnap for Oyo, order immediate rescue

Wia dis foto come from, KOLA SULAIMON/AFP via Getty Images
President Bola Tinubu don condemn di death of one of di teachers wey dem kidnap from Esiele community for Oriire Local Government Area for Oyo State.
Dis dey come afta Oyo State Govnor, Seyi Makinde confam say gunmen don kill di mathematics teacher wey dem kidnap among oda seven teachers and schoolchildren wey dem abduct for one school for Oriire Local Government Area.
Inside one statement by di presidency, di president tok say security operatives go rescue all di remaining victims while e charge di national assembly make dem do quick enact di law for di creation of state police.
On Friday, gunmen attack three schools for Ahoro-Esinele, Ogbomoso, Oyo State, southwest Nigeria.
Di terrorists wey ride motorcycle attack enta di community kidnap schoolchildren and teachers from Community High School, Ahoro-Esinele, and Yawota Baptist schools.
Local tori tok say dem kidnap 46 pipo, wey include seven teachers and 39 schoolchildren.
During one meeting wit tori pipo on Sunday evening, Govnor Makinde tok say terrorists don kill one of di seven teachers wey dem identify as mathematics teacher afta one video show di incident.
"Wetin we know right now be say dem don abduct seven teachers. Unfortunately, we get one video dis morning say di terrorists don kill one of di teacher, I understand say na di maths teacher, dis morning. Our prayer dey wit di family," di govnor tok.

Govnor Seyi Makinde tok say di dem go start to use both kinetic and non-kinetic approach to respond to di situation, and security agencies dey under pressure to rescue di remaining victims.
Di govnor beg di community leaders and religious bodies, including Baptist Convention, wey dey among di school wey dem attack.
"We don decide say we go use no be only kinetic approach. Some leaders, elders and religious elders especially from Baptist, wey dey among di school. I wan make appeal. We no take dis matta lightly. I dey appeal to everybody, citizens, residents, especially di local govment and di rest of Oyo States," Seyi Makinde tok.
"I wan make appeal say we go do everytin wey dey within our power to make sure say we resolve dis matta quickly and we go bring our children safely. But e no dey easy and e dey challenging," e tok.
"Abeg, we fit no get quick fix but we go kontinue to push ourselve beyond di limit to resolve di issue. We go dey brief tori pipo about dis matta eveery evening."
Govnor Makinde announce say di state govment go start daily press briefing to update di public and press on wetin dey happun until dem rescue di victims.
Teachers protest afta kidnapping for Oyo school
School teachers for Oyo State dey protest afta gunmen attack three schools and kidnap seven teachers and some school children on Friday.
Di protest happun for Monday for Ogbomosho and na members of di state Teaching Service Commission (Tescom), di Nigeria Union of Teachers (NUT) and oda labour groups.
Di teachers dey demand for betta security and dem dey show support for dia colleagues wey di bandits don hold captive since Friday.
One of di protest leaders, Bolaji Folashade Eunice, tell BBC: "We dey protest becos of our colleagues wey dem hold for captivity by pipo wey we no sure if na bandits or Boko Haram, and we hear say one of our members don die."
No group don take responsibility for di attack.
State authority tok say dem don arrest six suspects and three oda pipo wey dey onnection to di incident.
Oyo state govment close down some schools
Inside one video wey bin dey circulate online, one teacher wey dem identify as Mrs Alamu Folawe dey beg govment make dem rescue di kidnapped victims.
Oyo State Police Command tok-tok pesin, DSP Ayanlade Olayinka, tok say di kidnappers attack di school between 8am and 9am on Friday.
"Gunmen enta Ahoro-Esinele area, Oriire Local Govment Area, Oyo State. Dem abduct one school principal and unknown number of students, e tok.
Afta di news break, di Oyo State Universal Basic Education Board (Oyosubeb) close all primary schools for di neighbouring communities on Friday.
According to Oyosubeb for dia sttaement, dem tok na temporary measure to prevent any secondary incidents and allow security agencies to thoroughly stabilise di area.
"Di Oyo State Universal Basic Education Board, Oyosubeb, express profound sorrow and deep concern ova di unfortunate attack on LA School, Ahoro-Esinele, and Community Grammar School, Ahoro-Esinele, Oriire LGUBEA, wey bin result in di killing of one teacher and di kidnapping of some pupils.
"Dis na dark and painful moment for our education family for Oyo State, and our hearts dey wit di affected parents, teachers, and di entire community," di statement tok.
Di state govment don annouce make some school for di neighbouring community make dem reopen on Monday.
Tinubu order for immediate rescue of Oyo kidnap victims

Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/X
President Bola Tinubu don condemn di death of one of di teachers wey dem kidnap from Esiele community for Oriire Local Government Area for Oyo State.
Inside one statement by di presidency, di president tok say security operatives go rescue all di remaining victims while e charge di national assembly make dem do quick enact di law for di creation of state police.
"Di National Assembly go accelerate di enactment of di law wey go create state police", di president tok.
Di president describe di incident as "barbaric" and expressed sympathy to di families wey dey affected and di state govment.
"I dey sad about di killing of one of di teachers wey dem kidnap by di gunmen wey invade di community. I sympathise wit di govnor Seyi Makinde and I dey commend di steps wey e don take on top dis matter. I sympathise wit di families of di victims wey dem kidnap," di statement tok.
Di president tok say dem dey work wit Oyo State government to rescue all di victims while e praise di inspector-general of police and di police commissioners for Oyo and Kwara States for dia quick response and the deployment of tactical team and di ntelligence Response Team (IRT) to go rescue di victims.
Tinubu tok say wit di high cases of kidnapping wey dey happun e don clear say need dey to set up state police to manage some areas wey no get enough security
"Di IGP, base on my instructions, dey lead di tech-driven operation. We dey expect breakthrough soon. Dem go catch di bandits and all dia local collaborators and dem go face di law," di president tok.









