You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Carter Efe sama Portable wetin no good for ring - why celebrity boxing dey gain ground for Nigeria
Content creator and streamer Carter Efe beat singer Portable for celebrity boxing bout wey happun on Friday 1 May.
Di bout happun for Federal Palace Hotel for Victoria Island area of Lagos, southwest Nigeria.
Celebrity boxing for Nigeria don dey gain ground for di kontri. Wetin be casual exhibition bouts between influencers don draw organised audiences, structured judging, and growing media attention.
Organisers title di Carter Efe vs Portable bout as "Chaos for di Ring 4".
Di bout no be just about bragging rights, e bin reflect how Nigerians don dey take dis contests serious.
Portable bin enta di ring with reputation wey e already build from previous wins.
E bin previously beat Charles Okocha and Speed Darlington.
But di Zazu Zeh crooner no fit replicate previous feats as Carter Efe defeat am.
How di fight bin go down
For opening round, Portable use in normal gra-gra fighting style to dey throw anyhow blow but bicos Carter Efe na di taller one for di match, e just chop di blow witout too much moves.
Efe bin respond to di move wit im own uppercuts and bodi punches wey really affect Portable as na im small pass for di match.
For round two, Portable still dey use im gra-gra style to continue for di fight but as for Carter Efe, e change tactics.
Di content wey turn streamer start to dey land more precise combinations as e start to dey reason di game sharp.
For di third round, Efe don alreadi master how to dey land im blow wella for Portable bodi bifor dem kon ring di final bell.
Carter Efe win dis fight wit unanimous decision of 27-30 from di three judges of di match to put di streamer as di winner of di bout.
Di match bin dey livestreamed for livestream subscription-based platforms.
Why celebrity boxing dey gain ground for Nigeria
Well di hype for celebrity boxing bin enta Nigeria aroud di time wen Detty December start to dey pop and Nigerians try to dey use di opportunity to drag di amount of tourists wey dey visit to different events.
Balmoral Promotions wey be one of di promoters for dis Portable vs Carter Efe match don dey run weekly fights for di yard.
Meanwhile Amir Khan wey also be one of di promoters also don dey run events of Lagos since 2025 October wen e host two American boxers.
Khan wey be Olympic medallist for boxing bin tell BBC Sports say im plan na to ginger boxing for Africa and di Middle East bifor e go kon enta di UK circuit.
E tok say "Why Africa? I tink say na untouched market."
Dis fight na one of di fights wey don draw attention for di "Chaos for di Ring" series. Tori be say di Nigerian Boxing Association bin approve di fight.
Also, di rise of celebrity boxing for Nigeria dey tied to di kontri digital and entertainment culture. Social media don create new class of public figures wey include musicians, comedians, and influencers wey already get loyal audiences.
To bring dis personalities inside di ring dey transform online rivalries and fan debates into real-world show.
Anoda key driver na accessibility. Unlike traditional boxing, wey require years of grassroots development, celebrity boxing dey thrive on familiarity. Fans no just dey watch athletes, dem dey watch pipo wey dem already know, argue about and follow daily. Dat emotional investment dey translate into ticket sales, livestream views, and viral moments.
Monetisation opportunities na anoda factor. Brands, promoters, and even di fighters demsefs see celebrity boxing as new revenue stream.
Na clout and relevance be anoda factor wey dey make celebrity boxing gain ground for Nigeria. For entertainers, to step into di ring na way to stay for public conversation. One fight fit revive careers, settle online gbas-gbos, or introduce personalities to entirely new audience.