Yamal, Ekitike, Guler and odas wey be doubt for 2026 World Cup afta dia injury

Read am in 5 mins

Pressure don dey build up to di 2026 World Cup for US, Canada and Mexico.

Kontris dey prepare to name dia squad wey odas don dey arrange logistics and oda tins.

Some also don fire dia coaches wey dem select new pipo to lead dem to di tournament wey go hapun between 11 June and 19 July.

For players, di World Cup na di 'holy grail' of football, wey dem dey try dia best to dey available for selection.

But sometimes, tins no dey work according to dia own plan.

Some players dey play between 40-60 competitive games every season wey dey affect dem sometimes, na so teams dey work to deal wit player fatigue and injuries.

As di major leagues for Europe don dey end, na so some players bin dey injure.

As tins dey now, some top players bin dey race against time to dey fit wey odas dey ruled out completely for di tournament.

Some key players wey fit miss di tournament

Hugo Ekitike - Liverpool striker Hugo Ekitike bin suffer Achilles tendon injury for dia game against Paris Saint Germain (PSG) for di Champions league.

Di club announce say im go miss di rest of di season and di World Cup proper.

Arne Slot for im update on 24 April tok say "di surgery don go well, but di recovery steps go take long time."

Di 23-year-old dey disappointed say im go miss di tournament.

"I dey out of hia, I go soon return," Ekitike write on top im social media afta di injury.

France coach Didier Deschamps tok say "dis injury na big blow for di player and also for di French team."

"Hugo go return to im best level, me and di staff dey wish am well."

Rodryggo - Real Madrid and Brazil star Rodryggo Goes, bin get serious knee injury wey go keep am out for almost one year.

Di attacker describe di injury as "one of di worst days for my life" afta dem diagnose am wit wetin dem describe as anterior cruciate ligament (ACL) injury.

Rodryggo injure for di game against Getafe when im enta di pitch from di bench.

"Maybe life bin dey difficult for me dis days wey I no dey deserve dis," di 25-year-old write on top im social media.

Di Brazil football association say dem wish am speedy recovery wit di hope say im go soon return to di pitch.

Serge Gnabry - Germany go dey without Bayern Munich star Serge Gnabry afta di attacker suffer "adductor muscle tear" for im right leg.

Bayern Munich confam say di 30-year-old "go dey absent for long period".

Gnabry write on top social media say, "as for di World Cup wit Germany, e dey ova for me. But I go join di rest of di kontri to support di boys from home."

Germany coach Julian Nagelsmann tok say im feel sorry for Serge.

"Dis na bitter news but I don tok am say di whole team bin dey support am to make sure say im recover quick and enta di pitch again."

Mohammed Kudus - Ghana and Tottenham attacker Mohammed Kudus dey at risk to miss di World Cup afta im suffer 'injury setback'.

Di player bin dey recover from one quad injury since January wey im dey expected to return in March bifor.

But Tottenham confam say Kudus suffer anoda injury.

"Kudus bin return to training but im gatz undergo potential surgery again," Spurs new coach Roberto De Zerbi tok.

Ghana media bin dey report say Kudus wey don score 13 goals in 46 games for di Black Stars go dey absent for anoda three months, wey mean say im no dey likely to dey fit for di World Cup.

Mohammed Salisu - AS Monaco confam say Ghana defender Mohammed Salisu don get anterior cruciate ligament (ACL) injury wey im go miss plenty games.

Ghana Black Stars team doctor oga Prince Pambo say di 26-year-old don undergo surgery wey im begin recovery process.

"Afta detailed assessment, Salisu go dey out for at least nine months, wey mean say im no go dey for di World Cup," Dr Pambo tok.

Dr Pambo also tok say anoda Ghana Black Stars midfielder Francis Abu wey im leg break for one friendly match wit Japan for November, also dey expected to recover within five to six months afta im surgery.

Lamin Yamal - Di 18-year-old go miss di rest of di season but dey expected to be 'fit' for World Cup

Barcelona and Spain star Lamin Yamal wey suffer injury for di club game v Celta Vigo, go miss di rest of di season.

Yamal bin score di winning goal for di club for di penalty spot bifor im comot di game wit hamstring injury.

Barcelona don confam say Yamal "go follow conservative treatment plan wey im go miss di rest of di season but dey "expected to return for di World Cup."

Dis be blow for Barcelona wey get five crucial games to di end of di season.

Yamal write on top im social media say, "dis injury dey leave me off di pitch at di time I wan dey for di pitch; e dey pain me well well."

"E dey pain me say I no fit dey dia to support my teammates, but I believe say dem go drop dia whole life for every game."

Arder Guler - Real Madrid and Turkey midfielder Arder Guler wey injure imsef for dia game against Deportivo Alaves go miss di rest of di season.

Di club confam say dem diagnose am wit muscle injury for di biceps femoris of im right leg.

Guler be one di key players for Alvaro Arbeloa dis season. Since im arrive for Madrid, di 21-year-old contribute 20 goal contributions (6 goals, 14 assists) for 50 games.

Im na one of di key players for Turkey wey di kontri go hope say im fit recovery in time for di tournament.

Eder Militao - Brazil and Real Madrid defender Eder Militao don suffer wetin di club confam as hamstring injury against Deportivo Alaves.

Di club say dem diagnose am wit muscle injury for di biceps femoris of im left leg.

Di defender bin struggle wit injuries all season afta im recover from major ACL injuries for di past.

Im go miss all five games wey remain for di league season for Spain.

Now im dey race against time to dey fit to join di Brazil train for di World Cup.

Estevao Willian - Chelsea and Brazil winger Estevao Willian im chances to play for di World Cup dey slim afta im suffer hamstring injury.

Di 18-year-old dey out for di rest of di season afta im comot am from dia game wit Manchester United for di first half.

Sources close to di player confam to BBC Sport say im go dey fit for di world cup, but e no dey clear whether Brazil coach Carlo Ancelotti go risk am, especially as im no fit prove im fitness in time for di group stage.