'We dey in pain and e dey unbearable' - Retired Major General Rabe Abubakar family beg govment to rescue im wife

Published
Read am in 6 mins

Di family of retired Major General Rabe Abubakar don call on di Nigerian govment to intensify efforts for di rescue of im wife wey still dey for kidnappers den.

Abubakar daughter wey follow BBC tok say di death of di retired military officer don put di family for unbearable pain.

She say make govment make effort for di quick release of dia mama wey di terrorists gbab alongside dia papa.

Ova di weekend, di Nigerian military confam di death of Abubakar wey die for di hands of terrorists wey abduct am.

"Di Defence Headquarters regret to announce di passing of Major General Rabe Abubakar (retired), wey tragically lost im life in captivity following im abduction," di statement tok.

Dem lay di late senior military officer to rest on Sunday around 6:00pm for Katsina GRA Mosque, im family and plenti mourners attend di funeral prayers.

Defence Headquarters pay condolence visit to family of late retired General Abubakar

Di Nigerian Army say di military and relevant security agencies no go spare any effort to ensure say dose wey dey responsible for late Major General Rabe Abubakar (rtd) death face justice.

One delegation from di Defence Headquarters (DHQ), wey di Chief of Administration (Army), Major General IM Abdullahi lead give dis assurance wen dem don pay condolence visits to di family of di late senior officer plus di Katsina State govment.

Abdullahi also reassure di family say di military go continue to show support during dis difficult period.

For di family house of di deceased for Katsina, Major General Abdullahi wey represent di Chief of Defence Staff describe late Abubakar as dedicated and patriotic senior officer wey serve di nation wit distinction for various capacities throughout im military career.

E say di deceased make ogbonge contributions to di growth and development of di Nigerian Army and di kontri security architecture.

"Major General Abubakar serve di Nigerian Army and di nation well-well for ova three decades. Im years of dedicated service and sacrifice no go dey forgotten, and im legacy go continue to inspire officers and sojas of di Armed Forces of Nigeria," Major General Abdullahi tok.

E later present National Flag give di family in honour of di deceased senior officer.

Terrorists bin kidnap Abubakar wey bin get high-profile job as military tok-tok pesin between 2015 and 2017, as e dey travel wit im wife for Katsina State last month.

Di daughter say di kidnappers no call di family for ransom, but dem follow di govment tok.

On how dem dey feel and how save dem be afta di death of dia father, di late Major General daughter say, "Di pain dey unbearable. Na only God go deliver us. We dey pray. Allah na only our safety. By God grace we go dey saved."

Meanwhile, Katsina State govment authorities wey also confam di death of Major General Abubakar say e die from complications wey relate to diabetes and hypertension.

For statement, Katsina State govment tok say im death na "dark moment", and say e show say make dem quick step up effort to fight di criminal groups wey dey disturb peace for communities across di region.

Plenti Nigerians don condemn di death of di late senior military officer for di hands of kidnappers.

Nigeria President Bola Tinubu wey 'express shock' ova di death send warning to kidnappers to begin dey surrender now.

E say im govment no go surrender to bandits as e go continue dey treat dem as enemies of di kontri.

President Tinubu say di terrorists don do dia worst, but "govment no go bow to dia demand to release dia members wey dey di hands of our security agencies".

"As I say for June 12: Bandits, kidnappers, and sponsors of terror gatz surrender now or face di full force of di Nigerian State."

Local media bin report say di retired officer bin dey go one wedding on 30 May wen armed men attack im vehicle, seize am, im wife plus dia driver.

Days bifor tori of im death come out, one video bin go viral on social media wey show Abubakar for captivity. E get injury for im left leg, e dey wit im wife plus oda hostages for di video.

Di abduction and death of Abubakar show di security challenges wey continue to face parts of north-west Nigeria, wia criminal gangs locally known as "bandits" dey frequently carry out kidnappings for ransom, dey tiff cattle and attack rural communities.

Katsina na one of di states wey di violence dey affect well-well.

Defence Headquarters launch 'Operation Clean Sweep III' for Katsina afta Abubakar death

Sojas of Joint Task Force North West Operation Fansan Yamma (JTF NW OPFY) say dem don begin one deliberate offensive operation, wey di code name na 'Operation CLEAN SWEEP III'.

Di operation dey target terrorist and bandit wey dey operate within Matazu Local Govment Area plus oda neighbouring communities for Katsina State.

According to one statement wey di Media Information Officer of JTF North West Operation Fansan Yamma, Lieutenant Colonel Aliyu Danja issue on Monday, dem launch di operation afta di incident wey lead to di death of retired Major General Rabe Abubakar.

E say di aim of di operation na to locate and kpai di pipo wey carry out di kidnapping, to dismantle criminal networks and restore security within di affected communities.

Di statement add say since di operation start on 14 June, sojas don carry out aggressive fighting patrols, intelligence-led raids, cordon-and-search operations and clearance missions across identified criminal hideouts and suspected terrorist enclaves within di Joint Operations Area (JOA).

"Sojas carry out clearance operations on identified terrorist hideouts for Adua, Nasarawa and Karaduwa areas, wia dem search several criminal hideouts. During di operations, dem discova and destroy di terrorists life-support structures and logistics bases dem see within di area," di statement tok.

Who be retired Major General Rabe Abubakar

Major Gen Rabe Abubakar na retired senior Nigerian military officer wey serve for di army and hold big positions.

Oga Rabe na former military tok-tok pesin between 2015 and 2017.

Nigeria Army say retired major Abubakar bin serve di nation wit distinction and hold many appointments including tok-tok pesin of various military formations.

E also serve as tok-tok for di Armed Forces of Nigeria wia e hold di post of Director, Defence Information.

Dem say e make good contributions to counter-insurgency operations, professional development of di military, among oda impacts.

Oga Abubakar bin come from Batsari Local Govment Area of Katsina State, north-west, Nigeria.

Dem commission am into di Nigeria Army as Second Lieutenant for 1989.

E become defence tok-tok pesin for August, 2015 afta e take ova from Major General Chris Olukolade.