African kontris wey don comot dia citizens from South Africa sake of xenophobic attacks as Nigeria welcome 268

Published
Read am in 6 mins

Nigeria don bicom di latest African kontri to comot some of dia citizens from South Africa sake of xenophobic attacks.

One flight wey carry 268 Nigerians bin land for Lagos afta e comot Johannesburg on Thursday morning.

Di passengers dey part of di about 1,000 pipo wey di Nigerian consulate for South Africa say don register to leave di southern kontri.

Five Africa kontris don begin repatriate dia citizens from South Africa as di xenophobic attack don intensify for di past three months.

Nigeria, Ghana, Malawi, Mozambique, and Zimbabwe don don bring back dia citizen from South Africa in different batches, ahead of one 30 June deadline wey some campaigners set for undocumented migrants to leave.

Di first batch of Nigerians wey comot for South Africa land for Murtala Mohammed International Airport for Lagos around 10:25 am on Thursday, 11 June.

Nigeria Minister of State for Foreign Affairs, Sola Enikanolaiye, dey among oda officials for di ministry wey bin welcome dem for airport.

As e dey follow di returnees tok, Enikanolaiye say Nigeria no go sidon dey look as dia citizens face attack and harassment anywia dem dey for di world, and add say dat na why dem take fast and necessary action to bring dem home.

Many pipo from oda parts of Africa bin move go South Africa around di time white-minority rule end for 1994, as dem dey hope for beta life.

But as South Africa dey face unemployment rate of more dan 30%, anti-migrant sentiments don rise, as anti-migrant protest marches dey hold for major cities and pipo dey face xenophobic attacks.

Malawi

Authorities for Malawi say dem repatriate di first group of 150 nationals wey dey displaced for South Africa sake of di growing worries about xenophobia.

Di Ministry of Foreign Affairs and International Cooperation for one statement on X say di citizens wey dem move under di Voluntary Repatriation Exercise by bus on Saturday go land Malawi on Monday, 8 June.

Di repatriation exercise dey come afta one kasala burst for South Africa Western Cape Province recently, wey lead to di death of two Mozambicans for Mossel Bay and afta reports of door-to-door intimidation.

"Di 150 Malawians dey "among a number of foreign nationals" wey "seek refuge in temporary camps" for Mossel Bay, according to a statement from Lilongwe.

Anoda 171 returnees, wey be di second batch land on Tuesday, di govment tok.

Ghana

For di end of May, Ghana bin organise one repatriation flight from Johannesburg for nearly 300 of dia citizens.

A group of about 680 more land for Ghana capital, Accra, on 6 and 7 June.

Dis one make am nearly 1000 Ghanaians wey di govment don evacuate comot from South Africa.

Officials say dem screen all di returnees and register dem as dem land for Accra airport as part of one coordinated govment process.

Ghana Foreign Ministry say na contingency budget allocations dey fund di evacuation.

Dem also call on local businesses to support reintegration efforts by offering employment opportunities to dose wey dey return.

Di ministry add say dem dey consider legal steps to seek compensation for citizens wey allegedly lose property or wey dia businesses dey destroyed during recent unrest for South Africa.

"We go ensure reintegration wit dignity, medical and psychosocial support, pursue compensation for dose wey leave dia properties and businesses behind, secure jobs for pipo wey fit work and ginger our efforts towards achieving Osagyefo Dr. Kwame Nkrumah Pan-African dream of genuine African integration," di kontri foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa tok.

However, on Saturday, South Africa Foreign Minister Ronald Lamola bin accuse im Ghanaian counterpart say e dey spread misinformation about xenophobia for South Africa.

For one post on X, wey e link to one interview wey Ghana Foreign Minister Samuel Okudzeto Ablakwa give one news station for Accra, Lamola describe wetin e hear as "deeply disappointing".

For di interview, Ablakwa bin tell Joy News say im dey proud of di solidarity wey Ghanaians don show in supporting dia fellow nationals.

E also tok about tori of foreigners wey die afta dem attack dem for South Africa and e repeat di calls wey e make earlier say make African Union (AU) investigate wetin dey happun.

In response, Lamola clear am say di two Nigerians and five Mozambicans bin die for separate acts of violence.

E also clear am say im govment "no get information" on Oga Ablakwa claim say some Ghanaians dey receive treatment for hospital for South Africa afta dem dey attacked.

Zimbabwe

Di govment of Zimbabwe say dia citizens leave South Africa on Saturday by road through di Beit Bridge border crossing.

Dem add say some families wit young children wey dey among dose wey dem evacuate tok say dem run comot di Western Cape for dia safety.

Dis dey come as South Africa President Cyril Ramaphosa announce new measures to tackle illegal migration for di kontri.

Mozambique

Mozambique govment don also begin repatriate dia nationals from South Africa.

Ova di weekend, one group of about hundred and forty (140) pipo, mostly from Malawi and Mozambique, bin return home by bus afta dem live for one community hall for nearly one week inside di town of Kleinmond for di Western Cape.

Mozambique say ova five hundred of dia citizens don alreadi return and more dey set to follow.

Di decision to remove dia nationals from South Africa bin come afta two Mozambique men aged 27 and 43 die for South Africa Mossel Bay afta one violence for di Western Cape, authorities tok.

For one earlier statement, di Mozambican govment say five of dia nationals don die "as direct consequence of xenophobic attacks". But di police for South Africa no give motive and say investigation dey go on.

Mozambique govment allege say 800 of dia citizens be "victims of xenophobic attacks" during one recent kasala wey burst for di kontri.

Dem add say 300 pipo don comot for South Africa and di remaining 500 go soon join. Two out of dem die for road accident.

Meanwhile, on Sunday, South Africa President Cyril Ramaphosa bin announce new measures to crackdown on illegal migration as tensions dey rise ova anti-foreigner marches and frustrations about high unemployment.

Dis steps include jailing employers wey hire undocumented workers, setting up dedicated courts to speed up deportations of undocumented migrants and to get register wit biometric data "for evribodi for di kontri" to stamp out identity theft.

But e also warn South Africans say make dem no take laws into dia own hands.

Ramaphosa address dey come as response to di series of attacks and protests against foreigners wey dey live for South Africa.

South African protesters don accuse illegal migrants say dem dey put pressure on public services, and say dem dey commit crime.

Di protesters don ask di govment to strengthen immigration enforcement, wey don lead to rising anti-foreigner sentiment.

Several African kontris wey include Kenya, Malawi, Lesotho and Zimbabwe don issue advisory and warn dia citizens to dey vigilant.

Xenophobia for long don bicom issue for South Africa, wey dey sometimes come wit outbursts of deadly attacks.