Fifa World Cup 2026: Fixtures, tables, results

Published
Read am in 2 mins

Di 2026 Fifa World Cup start on Thursday 11 June wit di opening match between Mexico and South Africa.

Host kontri Mexico beat South Africa 2-0 for di match wey record plenti drama as centre referee give three Red cards in one night.

South Africa collect two of di red cards while Mexico collect one.

For anoda Group A match between South Korea and Czech Republic, South Korea beat Czech Republic 2-1.

Czech Republic captain Ladislav Krejci score di opening goal in di 59th minute.

South Korea midfielder Hwang In-beom di equaliser for di home team but substitute Oh Hyeon-gyu score di winning goal for South Korea.

Di tournament wey dey hold for three kontris - USA, Canada and Mexico fo end of 19 July.

Dis na di 23rd edition of di tournament but na di first in history to get 48 teams and three host countries.

Bifor now na 32 kontris bin dey participate for di World Cup tournament. Dis expansion allow some kontris wey neva qualify for di tournament bifor to participate.

Dis 23rd edition promise to dey exciting as e dey fill wit a mixture of old, middle age and young players from different kontris.

As dey excitement dey come, e also carry sadness sake of say some ogbonge players for di tournament to use di World Cup end dia career for international football.

Di tournament also get new ball wey get microchip inside wey dey read 500 times faster and di ball dey rechargeable.