You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
South Africa vs Canada World Cup Round of 32 match preview
Di knockout stages of di World Cup go start tonight wit di first round of 32 game as one of di co-hosts Canada go face South Africa.
Dis go be di first time for history wen both South Africa and Canada go reach knockout stage for di World Cup.
Ahead of di game wey go happun on Sunday, 28 June for di Los Angeles Stadium for (19:00 GMT), South Africa President Cyril Ramaphosa don wish Bafana Bafana luck, as e express hope say dem go put di whole kontri on global map again.
"I wan wish dem evri luck. Dem don make us proud, dem don play very well, and for di first time, di South African flag on di football stage dey fly very high.
"I know say our boys go make evri South African proud, dem go beat di Canadians and move to di knockout stage," Ramaphosa tok
South Africa qualify for dia historic progression to di last 32, afta dem beat South Korea 1-0.
South Africa coach Hugo Broos tok say di players ready and dem go try achieve di third round.
"You go see team wey get believe and wey go fight for 90 minutes, and more if dem have to. E go dey even more historic," e tok.
Canada defeat by Switzerland for dia final group outing mean say di tournament co-hosts lost home advantage, and one Cape Town-based sport journalist Mark Gleeson admit say na fantastic opportunity for South Africa to progress further.
"You gatz know say dis na game wey South Africa get di potential of winning," e tok.
Wit Broos likely to retire from management aft a di finals, South Africa players certainly get added motivation to perform for coach wey be di mastermind of dia return to di international game biggest stage.