Attacks wey don happun for Nigeria afta Tinubu visit Plateau State

Wia dis foto come from, Presidency
- Author, Abubakar Maccido
- Read am in 3 mins
On Sunday 2 April, President Tinubu visit Plateau State afta one serious attack by gunmen wey kill many pipo.
For im visit, e assure say dis kain attack no go happun again, and President Bola Tinubu come direct all service chiefs make dem identify and bring to justice di killers wey dey behind di recent attacks for Plateau State.
E also promise say govment go install 5,000 cameras to improve security surveillance for Plateau State.
Days afta e make dat comment, several deadly attacks don happun across differen parts of di kontri.
Time line of attacks wey happun afta Tinubu visit Plateau State
On 5 April, gunmen wey dem say be members of new terrorist group wey dem call Mamudawa attack communities for Shanga Local Govment Area of Kebbi State, cause loss of lives and property.
Police tok tok pesin for Kebbi, SP Bashir Usman, confirm di attack.
Sunday 5 April, gunmen attack for Benue North Central Nigeria kill 17 pipo while many odas wunjure.
Amnesty International condemn di latest attack for Benue State wia 17 pipo kpai for Mbalom in Gwer East Local Govment Area. Gunmen invade di village on Sunday during Easter celebration, leave many pipo badly injured.
On 4 April, dem report say 11 pipo die on Friday, while more dan 50 houses burn for fresh attack by hoodlums for Nasarawa communities.
Di incident wey happun early morning involve hoodlums wey carry out suspected reprisal attack over alleged killing of two of dia pipo.
On 3 April, bandits kidnap more dan 150 residents from Kurfa Ɗanya and Kurfan Magaji villages for Bukkuyum Local Govment Area of Zamfara State.
Di lawmaker wey represent Gumi/Bukkuyum Federal Constituency for House of Representatives, Suleiman Abubakar, confirm di incident to BBC Hausa Service, say di attack happun late Thursday night.
On 3 April, suspected terrorist wey dem say come from Rankum (Mahanga) area launch attack for Jol community for Riyom Local Govment Area, kill 51-year-old Dalyop Betobeje.
Dis latest incident come afta anoda deadly attack for Heipang District for Bassa Local Govment Area.










