Head of IRGC Intelligence Organization Majid Khademi, Commander of Quds Force Special Operations Unit Asghar Bagheri die for US-Israeli strikes

Head of Iranian Revolutionary Guards Intelligence Organisation Majid Khademi on military uniform, wit iran flag beside am

Wia dis foto come from, Khamenei.ir

Read am in 5 mins

Dem don kill Majid Khademi, wey be di head of di Iranian Revolutionary Guards' Intelligence Organisation, according to informate from di state media.

Dis dey come few days afta di Revolutionary Guards confam di death of of dia commander, Alireza Tangsiri "sake of severe injuries."

According to Iranian media, di commander of di IRGC navy die for one Israeli attack on one building for Bandar Abbas.

Meanwhile, di announcement of di death of di IRGC Intelligence Organisation come on Monday, as di US-Israel war still dey go on.

IRGC issue statement, according to state media wia dem announce di killing of dia martyrdom Brigadier General Seyyed Majid Khademi, head of the IRGC Intelligence Organization.

Di military body no provide any further details about di location of wia Khademi bin die.

Oda top Iranian security pipo don kpai for di Israel-US airstrikes.

Na inside same war Israel tok say dem don kill Iran top security official, Ali Larijani, plus di head of di paramilitary Basij force, Gholamreza Soleimani. Dat one happun for March 2026.

More informate wey come out on di death of Iran intelligence chief be say Israel Defence Minister Israel Katz and di Israel Defense Forces (IDF) claim responsibility for di killing of Majid Khademi.

Di IDF write for Telegram say di killing na "anoda severe blow" to di Iranian Revolutionary Guard Corps (IRGC).

Israel confam killing of Asghar Bagheri

Israel Defense Forces (IDF) confam say dem don eliminate Asghar Bagheri, wey be di Commander of di Quds Force Special Operations Unit.

Di Quds Force na part of di Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC). Dis latest confamation enta list of Iran senior security official wey don die for di war.

According to IDF, dem claim say Bagheri dey move "numerous attacks against both Israel and worldwide".

"Bagheri bin personally command operations wey target IDF sojas on di Syrian-Israel border."

"E hold series of senior positions within di Quds Force, wey e advance numerous efforts and dey involved in attacks wey target Israeli and American individuals all ova di world."

Di Israeli also claim say di Quds commander bin dey involved for operations wey target IDF sojas for di Syrian-Israel border, and also attempt to "transfer weapons from Iran into di State of Israel in order to harm di civilians of Israel".

Who be Majid Khademi

Majid Khademi on Iran army outfit

Wia dis foto come from, Islamic Republic News Agency (IRNA)/X

Khademi bin replace Mohammad Kazemi, wey dem also kill for anoda Israeli attack for 15 June 2025 during di 12-day Iran-Israel war.

Meanwhile, Majid Khademi appear for media under two names- sometimes e dey introduced as Majid Khademi and sometimes as Majid Hosseini.

E previously head of di Intelligence Protection Organization of di Ministry of Defense and di head of di Intelligence Protection of di IRGC.

Wen Brigadier General Mohammad Kazemi, di former head of di IRGC intelligence protection, dey appointed as di successor to Hossein Taeb, di head of di IRGC intelligence organization, Khademi take im place for di intelligence protection.

Khademi na well known military figure sake of di different security positions wey e don hold for Iran.

Although dem transfer Majid Khademi from di Iran Ministry of Defense intelligence protection to di IRGC intelligence protection, e get long history of serving for di IRGC.

E serve as deputy director of di IRGC Intelligence Protection Organization for sometime bifor e later become director.

Dem appoint Majid Khademi as head of intelligence protection for di Ministry of Defense for May 2018.

Bifor im death, Majid Khademi serve as head of Iranian Revolutionary Guards Intelligence Organization.

How strong di IRGC be for Iran

Di IRGC na Iran main organisation for maintaining internal security, and now na major military, political and economic force for di kontri, wit more dan 150,000 personnel.

Wit dia own ground forces, navy and air force, na dem dey oversee Iran strategic weapons.

Dem get overseas arm wey dem dey call di Quds Force wey secretly dey provide money, weapons, technology and training to allies throughout di Middle East.

Na dem dey also control di Basij Resistance Force.

Trump threaten 'hell' if dem no make deal but Iran issue retaliation warning

US President Donald Trump don publish one post for social media wia e threaten to destroy Iran power plants and bridges if dem fail to meet im new Tuesday deadline to reopen di Strait of Hormuz.

"Tuesday go be Power Plant Day, and Bridge Day, all wrapped up in one, for Iran," e write. "Notin like dat no go dey!!!"

Initially, im deadline na Monday 6 April, afta e post am on Saturday 4 April say Iran get "48 hours" to make di deal.

But hours afta e post im latest threat to Iran on Truth Social wey reference "Tuesday", Trump follow up wit "Tuesday, 8:00 P.M. Eastern Time!" (01:00 BST on 8 April) - wey signify extension of di deadline.

Di US president don postpone deadlines for di reopening of di Strait of Hormuz several times.

Later on Monday evening, Trump also tell di Fox News say "good chance" dey to reach a deal on Monday, but e dey consida to "blow evritin up and take ova di oil" if dem no make one deal quickly.

Di president latest remarks dey come as e announce say di second crew member of US fighter jet wey Iran shoot down don dey successfully rescued for operation deep inside hostile territory.

Meanwhile, Iran don warn of "much more devastating" retaliation if di US and Israel strike civilian targets, state media report

"If attacks on civilian targets dey repeated, di next stages of our offensive and retaliatory operations go dey much more devastating and widespread," according to statement from tok-tok pesin for di Khatam al-Anbiya Central Headquarters - Iran highest operational military command unit.

Islamic Republic of Iran Broadcasting (IRIB) bin publish di statement.

Dat Iran warning threat na sake of US president threat to attack Iranian power plants and bridges if Iran fail to meet di Tuesday deadline to reopen di Strait of Hormuz.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 3