Ghana hold England to scoreless draw for World Cup Group L game

Published
Read am in 10 mins

One brilliant save for di final minutes for di game by Ghana goalkeeper Benjamin Asare earn one crucial point for di Black Stars against di Three Lions of England.

Afta 96 minutes both teams no find di goal wey go secure all three points.

But Ghana go see dis as important point wey England go see am as two points dem drop.

Ghana bin set out to defend wit low-block for di second straight game for di World Cup wey dem keep two clean sheets.

Coach Carlos Queiroz bin tok ahead of di game say im go select team wey get African DNA to fight for di points.

Na so e happun for dis game wit England.

England get four shots on target for di game, wit two of di best chances to harry Kane and substitute Bukayo Saka.

For most of di game, Ghana defend well as one unit, wey dem block all di channels wia England fit operate.

For most of di game, England bin huff and puff to try and find spaces but for di end, na goalless draw.

Di Three Lions bin get 79% of di possession wit nine corner kicks and 22 throw-ins.

Dem also get seven crosses wit nine shots off target.

In di end Harry Kane, Saka, Rogers, O'reily, Eze and Rashford no fit break down di Ghana defence.

Ghana bin get only one shot on target wey dem get anoda chance when di team get quick counter attack but di ball neva trouble Jordan Pickford.

Ghana keeper Benjamin Asare make three saves - wey secure di point for di Black Stars.

Afta di game England coach Thomas Tuchel tok say di Three Lions neva find chance to break di Ghana low-block.

Wit dis result England get four points for di top of di table, Ghana also get four points wey dem dey second.

England go face Panama for di last group game wey Ghana go jam wit Croatia.

Tins don now set to see which team go finish di group stage as winners.

Highlights

FULLTIME!

Referee don blow whistle for di end of di game. What a defensive masterclass by di Ghana team wey reduce di danger of Engalnd for 96 minutes.

Freekick to Ghana.

90+5" Ghana don comot Prince ADu wey Baba Rahman don enta di game.

90+4" Anoda corner to England.

Goalkeeper Asare comot to punchj one ball wide to reduce di pressure.

90+3" Ghana clear di ball off di line. close chance for England

90+2" Corner to England again. More pressure for di Ghana defenders.

90+1" England still dey possess di ball wey dem wan create chances. Oppong wey just enta di game clear one cross out for corner.

Wit six minutes wey dem don add to dis game, Ghana fit hold on?

+6 mins

90" Freekick to Ghana. Rashford foul on Yirenkyi. Di fans for di stadium no gree wit di decision.

87" England dey increas di pressure on Ghana. Di game also dey open sake of di Black stars dey try to counter.

Ghana survive!

86" O'reily hit di post from anoda England pressure wey di ball fall to Kane - di Bayern striker balloon di ball ova di bar.

85" Chance! Ghana keeper Asare bin make one great save.

84" Freekick to Ghana - Fatawu try to releif di pressure and start di attack but Nico O'reily foul am.

Jonas Adjetey play on elong ball out from di defence, Semenyo and Kwabena Adu dey try to chase down di ball but Pickford comot im area to clear di ball.

83" England don comot Madueke for Rashford.

England take di freekick, Gideon Mensah bin clear am, wey Ghana win dia own freekick.

82" Freekick to England for di far corner. Chance for dem to put one dangerous ball inside di Ghana box.

81" Di game dey become tensious wit every passing minute.

79" Chance! Ghana get on echance wit Fatawu wey im pass to Prince Kwabena, di striker enta di ball wey im delay to shoot for England to recover.

Di game dey see many many small small fould hia and dia as time dey go.

77" Harry Kane foul Marvin Senaya for di back. Referee don belatedly award freekick.

76" Rice don play di corner wey fall for Maduelke. Caleb Yirenkyi and Issahaku block am wey di ball comot for goalkick.

75" Jerome Opoku block Rogers im cross for corner to England.

74" Ghana still dey defend dia territory. England dey put pressure to try and find di goal

72" More changes for England. Morgan Rodgers and Eberechi Eze enta to replace Bellingham and Elliot.

Di game don enta di final gear - for dis time any team wey fit score go get di momentum.

COOLING BREAK!

70" Saka head Madueke im cross ova di bar.

68" Chance for England! Partey bin lose di ball in front of di Ghana area wey e din fall for Kane, di Bayern Munich striker shoot di ball low wey goalkeepr Asare catch am.

66" Referee bin call foul against Ghana player Prince kwabena Adu when imm dey try to reach one pass bifor im clash wit goalkeeper Pickford outside im box.

65" Ghana bin dey change Inaki Williams and captain Jordan Ayew. Fatawu Issahaku and Prince Kwabena Adu don enta di game.

64" Nico O'reily and Saka bin ey enta to replace Anthony Gordon and Djed Spence.

Ghana bin dey make some changes. Na so England too bin dey make changes.

63" Ghana defend dia lines from di freekick wey dem close di space for Madueke wey im shot go ova.

62" Freekick to England in front of di Ghana area afta Partey foul Kane.

Anderson meet di corner again but dis time im header dey wide.

60" Elliot Anderson try to head di freekick towards goal but Ghana bin block am for corner.

59" Freekick to England. Gordon try to cross di ball but Inaki Williams block am illegally. Im chop yellow card.

58" Inaki Wiliams get one ball wey im drive for di England box bifor im pass for Yirenkyi but im no dey aware, England rush to clear di ball.

56" Chance for England. Dem finally enta di Ghana box, Madueke try to strike di ball but Ghana dfender block di shot wey goalkeeper Asare also bin catch Gordon im shot.

55" Ghana bin dey get small small balls for di England area but dem noi fit use di ball well.

54" Jude Bellingham dey call for penalty afta im clash wit Jerome Opoku. But ref say play on.

53" Di corner be too deep, las las Yirenkyi cause foul for di England keeper Pickford.

52" Corner kick to Ghana. Dem fit take dis one create any chance?

51" Madueke im pass through di Ghana backline be too hard, e comot for goalkick.

50" Freekick to England. Jordan press Guehi wey im foul am in di process in front of dia box.

49" Chance! Marvin Senaya meet one long ball inside di England area wit im chest bifor im try to cross to any yellow shirt but England don clear.

47" England pick up from wia dem end di first half. Semenyo get one ball wey im try to enta di England area bifor Bellingham track back to block di ball.

46" Freekick to England. Marvin Senaya foul Rice.

45" Di second half don start, Ghana try to enta di England area quick. Di English blakc di ball wey di pass to Declan Rice comot for throw-in

If you just dey join us, di second half for dis Group L game dey come start. Di scores be 0-0.

Make we see how dis second 45 minutes go end.

For Ghana, afta di first 45, dia coach go decide to carry one creative player enta di game to give di England players somtin to tink about.

Thomas Tuchel go make some changes so say im team fit break down di tough Ghanaian rearguard.

Between di two coaches, na Ghana coach Carlos Queiroz go dey happy sake of im defensive display shut out England and dia deadly attacks.

First Half

HALFTIME!

45+5" Freekick to Ghana afta Bellingham block Jerome opoku as im dey try to play one cross-field ball.

45+ 4" Madueke enta di box to try and create sometin, Ghana defenders steal di ball. For di counter attack, Ghana don lose di ball again.

Marvin Senaya don rise to head away di corner. Ghana dey hold on

45+3" Corner to England. Harry Kane get di ball wey im turn to try to shjoot. Ghana defenders block di ball.

45+2" Pressure don dey for di Ghana side - di Three Lions wan get late chance for dis game bifor di break but di ball comot for goalkick to Ghana.

Dem don add six minutes to dis first half. Ghana dey hold on for di next few minutes bifor halftime.

+6 mins

England attack for di oda end and get corner

44" Thomas Partey do one skill to turn di England midfielder wey im raise one fine ball ova di top for Jordan Ayew. Reece James pressure di Ghana captain wey di ball comot

42" First time Ghana enta di England box wit Semenyo but di Manchester City man delay im pass, but di chance fall to Jordan, im try to win throw-in for di far corner.

Yellow card! Declan Rice catch Jerome Opoku late, wey im collect dim first yellow for di game.

40" So far England dey get all di ball but dem no fit break down di Ghana defence.

39" Jordan Ayew win freekick i nside di Ghana area, once again di ball dey wit di England players.

37" Ghana win freekick for di middle of di park. Dem no fit keep di ball up to one minute. England don dey in control again.

Ghana play di ball straight back to England

36" Ova di top! Arsenal midfielder Rice meet one cross by Madueke for di backpost. But im no fit direct di header on target.

35" England try to attack again, di defenders clear dia lines bifor dem give di ball to Gideon Mensah but di left-back lose concentrationn wey di ball comot for throw-in to England.

33" Gideon Mensah now win freekick. But no threat, di ball go back straight to England

32" Madueke cross di ball into di box, nobody wit white short fit meet di ball, Ghana don clear am.

Freekick to England. Referee bin blow whistle for foul by Jerome Opoku.

31" Dis be di first time for about 30 minutes when Ghana try to play di balkl from dia area to attack England. Dem win freekick

Freekick to Ghana, Marvin Senaya win di ball wey im try to run out of di Ghana area bifor Anthony Gordon foul am.

29" Ghana try to press wit Semenyo, Sibo and Jordan.

28" Gordon no fit reach one pass when England try to attack immediately.

Di game don restart now.

WATER BREAK!

25" Di ball just dey for di Ghana area wey dem dey clear every cross and pass into di box.

Ghana try to enta di England area wit Yirenkyi. Guehi black am wey di ball comot for throw-in

Di game finally restart.

Dem bin dey bandage Jordan Ayew im head as di medics still dey try to see if Reece JAMES fit see beta.

Referee don blow whistle for medical team to enta di park to treat dem.

20" Injury! Clash of heads between Ghana captain Jordan Ayew and Reece JAMES

19" Goalkeeper Asare collect one cross from Reece James.

18"Di possession all bin dey wit England, Ghana dey defend deep.

17" Freekick to Ghana for dia defence - Ayew chest di ball wey im wan turn but dem hack am down.

16" Di corner neva trouble Ghana. Gideon Mensah clear di ball away.

All di pressure dey on top di Ghana team now as England dey pepper dia defence . Jonas Adjetey bin clear one dangerous cutback for corner.

15" Gideon Mensah bin clear one ball wit im lace, afat England try to create chance inside di Ghana box

14" Harry Kane dey for ground afta im clash head wit Ghana defender Jonas Adjetey. Freekick to England for di Ghana area

13" Ova di bar! Rice don smash di ball but di Ghana keeper Asare cover im area well.

12" Freekick to England afta Senaya foul Gordon from behind. Dangerous position for Reece James or Rice

11" Madueke don beat Gideon Mensah for di back wey im try to square di ball for gordon but Ghana manage to clear am.

10" England try to create first chance but di final pass for di edge of di box dey blocked by Ghana.

9" Madueke try to collect one long ball across di park, di ball comot for throw-in afta Gideon Mensah block am

8" Goalkick! Ghana try to enta di England area for di first time thru dia right back Marvin Senaya but im no fit cross di ball wey e comot for goalkick.

6" Ghana try to break for di counter attack wit Jordan Ayew, but di cpatain im pass to Semenyo be too hard, di attack don break down.

5" Freekick to England for di edge of di Ghana area, but dem don clear Rice im freekick

England fans dey boo every touch by black Stars midfielder Thomas Partey to put am under pressure

4" Ghana now begin to dey play some passes wey start wit Partey, to Gideon Mensah bifor di linesman catch Inaki Williams offside.

3" Bellingham im pass to Declan Rice be too hard, di ball comot for throw-in.

2" Di ball bin dey di midfield area as England continue to dey size di Ghana team, di Black Stars also just sit for back dey allow England to pass di ball.

Di Three Lions begin to dey pass di ball around

1" England pass di ball to start

Referee don blow whistle for di game to begin

Di countdown for di stadium begin from 10, 9, 8, 7, 6, 5, 4, 3, 2, 1

Wetin go be di result for dis one? Time go tell.

As we tok am, di last time dis two teams jam na 2011 wey end for 1-1 draw.

Di teams go sing dia national anthem, afta dat dem go shake hands for di game to start well well.

Fans don gather for di Boston stadium under wet conditions for dis game.

England dey wear dia traditional white jersey wey Ghana dey wear dia yellow jersey as both teams waka onto di pitch.

Once again, welcome to our live coverage for dis Ghana v England game