2026 World Cup: Players wey get Nigerian roots wey dey play for oda kontris

Foto mix of foreign players wey get connection to Nigerian roots

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Foto mix of foreign players wey get connection to Nigerian roots
Published
Read am in 5 mins

Di 2026 Fifa World Cup go start on Thursday wit 48 teams wey go play 104 matches in over five weeks.

Despite say Fifa expand di competition to allow 10 African teams go di World Cup, Nigeria no still make am.

Though di Super Eagles miss out on di tournament wey go happun for US, Mexico and Canada – players wey get Nigerian roots full for di World Cup.

Di players connect to Nigeria weda na by birth, parentage, or ancestry – di koko be say dem go play for di Mundial.

Bukayo Saka (England)

Bukayo Saka wear England national team jersey

Wia dis foto come from, Mateusz Slodkowski/Getty Images)

Wetin we call dis foto, Bukayo Saka wear England national team jersey

Bukayo Saka na one of di players of Nigerian decent wey go totori pipo for di 2026 Fifa World Cup.

Dem born am on 5 September 2001 for Ealing, Greater London.

Im parents na Adenike and Yomi Saka.

Di Nigerian dey show im affection for im kontri of origin sake of say im dey always visit Nigeria during breaks to familiarise wit im roots.

Saka dey part of di Arsenal team wey win di Premier League dis season and im go represent England for di World Cup.

Eberechi Eze (England)

Eberechi Eze dey represent England

Wia dis foto come from, (Photo by Maddie Meyer - FIFA/FIFA via Getty Images)

Dis na anoda England player wey get links to Nigeria and im dey play for Arsenal FC for di Premier League.

Dem born am for Greenwich, England, to Nigerian parents. Im for fit play for any of di two kontris but im choose England.

Im get im first call-up for the Three Lions in May 2023 and im officially play im first game for June 2023.

Dem name am among di players ey go represent England for di World Cup.

Michael Olise (France)

Michael Olise of France

Wia dis foto come from, FRANCK FIFE / AFP via Getty Images)

Michael Olise na beta striker wey dem born for Hammersmith England on 12 December 2001.

Im papa from Nigeria and im mama na French-Algerian wey make Olise eligible to play for four four – England, Nigeria, Algeria and France.

Wit all di options wey dey available for am, Olise choose to play for France.

Olise begin im football career for very young age as a youth player and im don grow to becom one of di players pipo wan watch for di World Cup.

Folarin Balogun (United States)

Folarin Balogun wear US national jersey

Wia dis foto come from, Cory Knowlton/ISI Photos/ISI Photos via Getty Images)

Wetin we call dis foto, Folarin Balogun dey play for di United States

Dem born Balogun for Brooklyn, New York, United States to Nigerian parents on July 3, 2001

Im follow im parents go United Kingdom and im grow up for London, England.

Balogun bin represent di United States and England for di youth international level. On May 2023, im decide to play for di United States senior national team and play im first match on June 2023.

Noni Madueke

Noni Madueke

Wia dis foto come from, Kevin Hodgson/MI News/NurPhoto via Getty Images)

Noni Madueke dey represent England but im get Nigerian roots.

Both of im parents from Nigeria, and im dey always show in love for Nigeria.

Dem born am for Barnet and im also grow for dia.

Im start im youth career for Crystal Palace and Tottenham Hotspur.

Noni represent England throughout im youth levels and play im first match for di senior team for September 2024 against Finland.

Since den im don play seven times for di Three Lions of England.

Felix Nmecha

Felix Nmecha dey play for Germany

Wia dis foto come from, Photo by Alexander Hassenstein/Getty Images)

Wetin we call dis foto, Felix Nmecha dey play for Germany

Felix Nmecha dey represent Germany for di 2026 Fifa World Cup. Im get German mother and Nigerian father, Nmecha.

Im get one senior senior broda wey be Lukas.

Dem born dem for Hamburg but later move to England wit dia family for 2007. Dia football skills shine for Hamburg borough of Altona, dem later switch to Manchester wey make pipo begin notice dem for di Premier League team Manchester City. Two of dem later join the club academy.

Felix Nmecha na midfielder wey dey currently play for German side Borrusia Dortmund.

Jamal Musiala (Germany)

Jamal Musiala dey play for Germany

Wia dis foto come from, (Photo by Alexander Hassenstein/Getty Images)

Wetin we call dis foto, Jamal Musiala dey play for Germany

Reports from di German Bundesliga show say dem born Jamal Musiala for Stuttgart, Germany, to British-Nigerian father and a German mother. Im be 23 years old and na midfielder.

Im papa na Daniel Richard wey be former footballer for Nigeria and im play beta role to make im pikin play football too, espcially im contributions for im youth career.

Carolin Musiala, na im mama, dem born her for Germany too wit Polish roots.

She also prompted the Dem bin move go England wen Jamal bin dey seven years but im later return to Germany to join Bayern Munich.

David Alaba dey play for Austria

Wia dis foto come from, Marco Steinbrenner/DeFodi Images/DeFodi via Getty Images)

Wetin we call dis foto, David Alaba dey play for Austria

Dem born am for Vienna to a Nigerian father and a Filipino mother, im sabi speak four languages: English, German, Tagalog and Spanish.

According to im website, im papa na DJ and recording artist, and wen im bin small dem bin dey dress am wit African-American music style.

Im be captain for di Austrian national football team. Alaba played for Austria for under-17, under-19 and under-21 level.

For October 2009, dem call am to join di senior Austria national team for a match against France. Since dat time im don be part of di Austria senior team.

Other players still dey wey go represent oda kontris for di 2026 World Cup dem include:

Owen Goodman - Canada

Tani Oluwaseyi - Canada

Promise David - Canada

Zion Suzuki - Japan