EFCC arraign Blessing CEO for fresh alleged 13m naira fraud afta previous arraignments - all cases against Nigerian influencer

Wia dis foto come from, @officialbblessingceo/Instagram
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don drag popular Nigerian social media influencer Blessing Okoro aka Blessing CEO go court again ontop accuse of 13 million naira ($9,551) fraud.
Dis latest accuse dey come a day afta di Nigeria anti-corruption police bin drag her go court on top alleged 69.1 million naira fraud and anoda alleged 36 million naira rental fraud.
EFCC on Wednesday, 10 June say dem don file fresh six-count charge against di self-proclaimed relationship expert.
Dis new charges border ontop accuse say she collect money by false pretence wey amount to 13 million naira.
According to di anti-corruption police, na di Nigeria Cancer Society and some individuals wey di commission no name file dis fresh petition against her.
Dem allege say she use wayo collect money from members of di public afta she bin claim say she get stage four cancer and need help for treatment.
"Di petitioners allegedly make donations to di defendant afta she post on her social media accounts say she dey battle stage 4 breast cancer and dey seek financial support for treatment. Dem later discova say, di documents wey she present give members of di public na fake," EFCC tok for statement.
Blessing CEO don react to dis multiple charges as she say she no dey guilty of all di charges.
Dis 13 million naira fraud accuse go be di third one wey EFCC go drag am go court for.
Dis fresh charges dey come a day afta Justice Dipeolu of di Federal High Court, Ikoyi, Lagos grant bail to di social media influencer to di tune of 10 million naira ($7,349) and two sureties.
For dis latest accuse, EFCC bin drag her bifor Justice Yelim Bogoro of di Federal High Court for Ikoyi and she dey remanded for Kirikiri correctional facility.
Blessing CEO alleged 69.1m naira fraud
Blessing CEO bin land for fresh trouble as EFCC drag her go court again ontop accuse of 69,150,000 naira ($50,858.30) magomago.
EFCC on dia official X account on Tuesday, 9 June say dem carry Blessing CEO go court again on two-count charge wey border on accuse say she obtain money by false pretence and stealing wey amount to 69,150,000 naira (sixty-nine million, one hundred and fifty thousand naira).
Di Nigerian corruption police announce di informate di same day one Federal High Court for Lagos grant di influencer bail ontop accuse of rental fraud wey reach 36 million naira ($26,000) wey EFCC bin earlier gbab her for.
Dem drag her for alleged fraud bifor Justice R.A. Oshodi of di Special Offences Court wey sit for Ikeja, Lagos State.
EFCC lawyer, C.C. Okezie bin ask di court to go ahead wit di arraignment, as dem argue say dem don duly serve di defendant wit di charge.
And for im ruling, Justice Oshodi rule say make di arraignment go ahead in accordance wit di law, so dem read di charges to her.
However, Blessing CEO plead "not guilty" to dis fresh charges.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di first count charge na say she lease one house for Lagos wey she allege say na her property give one company, and di property no be her own, but she claim say she be di owner.
Di first count read: "Say you, Okoro Blessing Nkiruka, on or about March 21, 2025, for Lagos, within di jurisdiction of dis Honourable Court, by false pretence plus wit intent to do wayo, persuade Hope Chiropractic Health Clinic Limited to transfer one benefit of 69,150,000 naira (sixty-nine million, one hundred and fifty thousand naira) give you under di representation say di property wey dey located at No. 1 Tunbosun Osobu Street, Lekki, belong to you and you lease am give di company for a period of five years, representation wey you know say na false, thereby commit offence wey dey contrary to Section 1(2) and punishable under Section 1(3) of di Advance Fee Fraud and Other Related Offences Act."
Di second count charge na say she use wayo collect money wey make am commit offence of stealing wey dey contrary to di law.
Count two read: "Say you, Okoro Blessing Nkiruka, on or about March 21, 2025, for Lagos, within di jurisdiction of dis Honourable Court, use wayo convert to your own use di sum of 69,150,000 naira (sixty-nine million, one hundred and fifty thousand naira), wey be di property of Hope Chiropractic Health Clinic Limited, thereby commit offence of stealing wey dey contrary to Section 280(2) and punishable under Section 287 of di Criminal Law of Lagos State, 2015."
Di defendant plead not guilty to di charges wen dem read to her.
EFCC lawyer bin ask for trial date and ask di court to keep Blessing CEO for EFCC custody pending her scheduled arraignment bifor di Federal High Court, Ikoyi, Lagos, on 10, June 2026, for anoda alleged fraud case.
For im ruling, Justice Oshodi say make di defendant remain for EFCC custody and e adjourn di mata till 16, July 2026 for di hearing of di bail application and wen trial go start.
Blessing CEO alleged 36 million naira fraud
For May, di Nigeria anti-corruption agency sama Blessing CEO wit two-count charge ova rental fraud wey reach 36 million naira ($26,000).
Dem allege say she collect money by false pretence and steal to di tune of 36 million naira.
Blessing CEO plead not guilty to both charges even as her lawyer, PI Nwafor tell di court say she don pay part of di money back to di woman and ask di court to comot di case wen dem don pay fully.
E say, "We get application to make. Di defendant go meet di nominal complainant and give am ₦24 million out of di ₦36 million and we dey ask for court adjournment so we go fit arrange di remaining money to pay back. Di nominal complainant tok say if we pay di money back, she go ask EFCC make dem drop di case against am."
Di two-count charge include:
"Say you, Okoro Blessing Nkiruka between July 14 and 17, 2024 for Lagos collect di sum of ₦36 million from Mrs Ifeyinwa Nonye Okoye wit false pretence say you dey rent one six-bedroom detached duplex for No. 1B, Tunbosun Osobu Street, Off Kuboye Road, Lekki, Lagos State give am wey you know say na lie. Like dat you commit offence against Section 1(3) of di Advance Fee Fraud and Other Fraud Related Offences Act, 2006."
"Say you, Okoro Blessing Nkiruka between July 14 and 17, 2024 for Lagos fraudulently turn Mrs Ifeyinwa Nonye Okote ₦36 million for your own use wey be offence against Section 383 and dey punishable under Section 390 of di Criminal Code Act, Cap C38, Laws of di Federation of Nigeria, 2004."
As di case appear for court, di judge rule say make di EFCC keep her for dia custody until wen di trial go start on 5 June.
On Tuesday, 9 June, di Federal High Court for Lagos bin grant bail to Blessing CEO to di tune of 10 million naira ($7,349) and two sureties.
Di conditions of di bail na say; One of di sureties gatz be family member and e dey required to provide proof of employment, Bank Verification Number (BVN), National Identification Number (NIN), plus valid phone number.
Di sureties gatz also submit one valid international passport, tax clearance certificates for di last two years, and six passport photographs.
13m naira fraud accuse
For April, plenti Nigerians bin ask EFCC say make dem prosecute di self-proclaimed relationship sabi pesin ontop accuse say she make false claim say she get stage 4 cancer and receive monetary donations from Nigerians.
According to di influencer, Nigerians bin donate 13 million naira for her afta she come out to solicit funds.
Wen di video of her stage 4 cancer claim go viral, some Nigerians no believe am and dem request say make she post her medical results on social media, while some express pity for her alleged condition.
For one viral interview wit internet personality Egungun of Lagos, Blessing CEO say na miscommunication happun wey make am believe say she get stage 4 cancer.
EFCC source wey bin no want make we mention im name bin tell BBC News Pidgin dat time say, "As an organisation, weneva mata like dis come up, we no dey work on social media agitation, frenzy and all of dat. We always want make pesin place petition bifor us wey we fit work on.
"Independently, we fit do our own intelligence, but certainly we no dey always go by social media frenzy, agitation and all of dat.
"If we arrest am, which information we go place bifor di court if we need to prosecute am? We be veri organised agency," di EFCC source tok.
Blessing CEO react to charges
For one post on her social media account, di influencer react to di three cases wey she get wit di EFCC.
Di first one wey be two-count charge ova rental fraud wey reach 36 million naira ($26,000), Blessing CEO say she don pay di money finish.
On di second case wey allege say she commit 69,150,000 naira ($50,858.30) magomago wey relate to property wahala, she say she no sell anybody house, say di disputed property na her office.
On di third case, Blessing CEO say wen she come out from Kirikiri Correctional Centre, she go explain give her fans evritin wey happun.
Who be Blessing CEO
Blessing Okoro, wey pipo sabi as Blessing CEO na influencer and self-proclaimed relationship expert. Dem born am for Onicha Local Govment Area of Ebonyi State.
Netizens sabi her for her bold and controversial advice on relationships, love, and sex on social media platforms.
Blessing na 37 years old woman and she marry her first husband at di age of 18 for 2010 and dem born two children.
But she later divorce her husband at di age of 21.
She tok say she endure three years of serious domestic violence for her marriage.
For April 2019, Blessing CEO bin post fotos say she don build mansion for Enugu as single mama but di real owner, businessman Onye Eze, expose di lie and arrest her.
She later make video to apologise publicly say no be she get di property.
Blessing CEO also dey entangled in di relationship controversy between Ikechukwu Darlington Ogbonna popularly known as IVD and im wife.
Afta IVD wife Bimbo die for October 2022, e no too tey wey Blessing and IVD begin date. E later propose to am.









