Atiku beat Amaechi, Hayatu-Deen to emerge ADC presidential candidate for 2027 election

Published
Read am in 7 mins

Former Vice President Atiku Abubakar na di winner of di Action Democratic Congress (ADC) presidential candidate for di 2027 general elections.

According to di political party, Atiku get 1,846,370 votes as im beat im closest rival, wey be former Rivers State govnor Rotimi Amaechi, wey score 504,117 votes.

Businessman Mohammed Hayatu-Deen get a total of 177,120 votes for di presidential primary.

For dia official X handle, ADC give breakdown of di primary election results" for di final results from di presidential primary of di ADC Hayatudeen- 177,120, Amaechi- 504,117, Atiku 1,846,370.

Total Vote cast 2,527,977, Total Registered members 3,113,599"

For im acceptance speech, Atiku tank di party sake of say dem show say democracy dey alive for di ADC.

Im also chook mouth for di challenges wey opposition parties and leaders of di kontri dey face.

"We demonstrate say while di ruling party and dia operatives dey press democracy for neck, democracy dey alive and well for di African Democratic Congress," im tok.

National Chairman of di party, Senator David Mark, say di party allow free contest and allow members to make dia choice.

Im say even though di exercise no dey perfect chance still dey for dem to improve.

Mark tok say all di aspirants dey qualified to lead, but only one person fit fly di flag of di ADC.

Di direct presidential primaries start on Monday as Atiku Abubakar, Chibuike Amaechi, and Mohammed Hayatu-Deen face each oda for di election wey happun across di kontri.

Tori be say, voting happun for di 8,809 wards to Nigeria , as members openly stand behind di aspirants wey dem want.

As e dey sweet Atiku say im win, belle dey turn Chibuike Amaechi and Hayatu-Deen wey tok say di process no go well.

Some of di State results of ADC presidential primary election wey Atiku win

Di African Democratic Congress (ADC) don begin di collation and collection of results from dia presidential primaries wey go decide dia candidate for di 2027 general elections.

As plenti supporters dey wait for official announcement of di presidential primaries, we gada state by state results from local reports.

Yobe State

For Yobe state, Atiku gada 44,841 votes while Amaechi get 300 votes and Hayatu Deen gada 365 votes.

Abia State

Report also tok say Atiku win for Abia State, afta e pack 25,153 votes ahead of Amaechi, wey score 18,339 votes. Hayatu-Deen receive 3,264 votes.

Zamfara State

For Zamfara, report say Atiku get 60,500 votes to defeat Hayatu-Deen wey score 446 votes, and Amaechi get 191 votes.

Gombe State

For Gombe State, results wey di Returning Officer announce say Atiku gada 139,334 votes; Amaechi get 1,150 votes, while Hayatu-Deen get 464 votes.

Ebonyi State

For Ebonyi State, di result show say Atiku get 15,300 votes, while Amaechi get 2,200 votes and Hayatu-Deen get 200 votes.

Sokoto State

Atiku also win di presidential primaries for Sokoto State by a wide margin, acccording to reports.

Atiku gada 68,823 votes across di 23 local govment areas, Amaechi get 292 votes and Hayatu-Deen get 319 votes.

'I reject di results' - Amaechi

Meanwhile, former Rivers govnor and also ADC presidential aspirant, Rotimi Amaechi say e dey reject results from di primaries.

Amaechi allege say dem no allow some voters cast di votes and dat no make di priamry election dey transparent.

"Sake of reports of widespread voter disenfranchisement for most parts of di kontri during di African Democratic Congress (ADC) Presidential Primaries yesterday, I reject di concocted results wey dem dey announce.'

Amaechi say even though im promise to accept di outcome of di primaries bifor if e dey free and fair, e say im dey make u-turn.

E say di process no go well wit di values of di party wey promise to rescue Nigerians from bad management of di kontri.

"No way about eighty percent of members of di party no dey allowed to vote, and you expect me to accept such results."

Oga Mohammed Hayatu-Deen bin also tok say even though im go attend di announcement of di ADC presidential election results, "I dey concerned by reports from across di kontri of widespread vote rigging, some of which I myself observed, and go diafore take advice on my next steps," im tok for statement on Tuesday.

Atiku Abubakar

Ahead of di primaries, one of di presidential aspirant ex-Vice President, Atiku Abubakar, say di African Democratic Congress must present candidate wey dey competent and experienced, wey fit address Nigeria economic challenges and institutional decline.

For statement wey im Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu issue on Sunday, Atiku tok say di choice bifor di delegates of di ADC don pass politics, e describe am as historic responsibility.

"For time wen Nigeria dey bleed from evri area —crippled by economic hardship, insecurity, rising debt, institutional failure, and deepening hopelessness—di question bifor di ADC dey simple: who get di capacity not to only campaign, but to govern effectively from day one?

Di 80-year-old politician tok say Nigeria current challenges require tested leadership wit executive experience, economic understanding and national appeal.

"Nigeria today need president wey understand governance no be as theory, but as lived responsibility.

Di former vice president also say make ADC delegates prioritise competence ova sentiment as di party prepart for di 2027 general elections.

"At dis defining moment, ADC delegates must ask themselves a simple but profound question: we wan make statement, or we wan make President?

E add say while oda aspirants fit rely on rhetoric and slogans, im get di institutional memory and experience to lead effectively.

On experience, Oga Abubakar bin serve as di vice president of Nigeria from 1999 to 2007 during di presidency of Olusegun Obasanjo.

Atiku Abubakar don run unsuccessfully for President of Nigeria six times, for 1993, 2007, 2011, 2015, 2019, and 2023.

E bin run for di Social Democratic Party presidential primaries for 1993, but e lost to Moshood Abiola and Baba Gana Kingibe.

For 2007, e be di presidential candidate of di Action Congress for di 2007 Presidential election but e lose to People's Democratic Party candidate Umaru Yar'Adua.

E contest di presidential primaries of di People's Democratic Party during di 2011 presidential election but e lose to incumbent President Goodluck Jonathan.

For 2014, e join di All Progressives Congress ahead of di 2015 presidential election and contest for di presidential primaries, e lose to Muhammadu Buhari.

For 2017, e go back to di PDP and e be di party presidential candidate during di 2019 presidential election, again, e lose to incumbent President Muhammadu Buhari.

Di PDP choose am as di presidential candidate for 2022, for di 2023 general election, afta e defeat Nyesom Wike, di former govnor of Rivers State for di primaries. E lose di election to Bola Tinubu

For 2025, Abubakar comot di PDP to join di African Democratic Congress, wia e don express interest to run for presidency.

Rotimi Amaechi

Nigerians see former Rivers State govnor and Rotimi Amaechi as strong contender for today exercise, sake of im experience in politics.

Amaechi, bin serve as Minister of Transportation and bifor den don hold various political positions, wey include Speaker of di Rivers state house of assembly.

As minister of transport, e enta public eye wit im railway projects.

Amaechi na one of di founding members of di APC, and one of di influential figures during di Buhari administration.

For 2022, Amaechi bin express interest to contest for di 2023 presidential election. E lose to Bola Tinubu.

Now contesting under di ADC platform, 62-year-old Amaechi dey present imsef as credible alternative wey get di ability to restore public confidence in governance.

Afta im screening, Amaechi say make delegates vote for pesin wey fit beat di incumbent, pesin wey get experience, pesin wey fit deliver di vote

"Judge us by wetin we don do, if we don perform, whoever don do pass di oda, vote for di pesin."

E say im believe say im get most experience, im be di youngest plus di capacity to turn di kontri around in four years, sake of im achievements.

Mohammed Hayatu-Deen

Anoda aspirant wey don declare intention to run for presidency under di platform of di ADC and wey go show for di primaries na Mohammed Hayatu-Deen.

Hayatu-Deen na ogbonge economist, banker, investor, and corporate leader from Borno State wit ova 40 years experience in leadership across Nigeria public and private sectors.

For 2015, e bin head di Transition Committee on di Economy for President Buhari incoming administration.

For 2023, Hayatu-Deen bin buy di PDP presidential nomination forms but withdraw few days to di primary, as e allege say di process no pure. "Based on personal principles and wit great humility, I don decide afta wide consultations to withdraw from dis contest don dey heavily monetised," e bin announce at di time.

E bin dey complain about di process wey eventually produced Atiku as di party candidate.

ADC say Hayatu-Deen dey bring decades of experience in economic management, financial transformation, and national development.