'Employ mostly South African citizens or permanent residents' - South Africa tell employers under new scheme

Wia dis foto come from, Per-Anders Pettersson/Getty Images
South Africa don tell companies, businesses and oda employers for di kontri to consider mostly dia citizens and permanent wen dem dey employ.
Dis na as di Department of Home Affairs gazette launch of dia Trusted Employer Scheme (TES), di scheme wey dem say go help dem modernise South Africa immigration system, attract investment and support economic growth and job creation.
South Africa say di launch of di scheme go make life beta for South Africans and reduce di rate of unemployement for di kontri.
According to South Africa, dis employer scheme wey be di second phase go involve companies wey dey involved in infrastructure projects, businesses wey dey establish regional and global headquarters for dia kontri.
Di purpose of di employer scheme system na to allow South Africans to easily attract skills and manage immigration especially wen dem dey process applications for senior executives, technical personnel, corporate employees and investors.
In di last few months, protest don rock South Africa ova claims say illegal migrants dey take dia jobs.
Di protest don lead some kontris to comot dia citizens from South Africa to prevent further attacks.
South African President Cyril Ramaphosa wey address di kontri ontop immigration issue saySouth Africa no go gree for illegal migration and dem go adopt measures to handle illegal migration.
According to dis scheme wey go address immigration wahala for South Africa, di Home Affairs say na only accredited employers go qualify to recruit.
"To qualify, companies gatz demonstrate meaningful investment for South Africa, employ mostly South African citizens or permanent residents, invest in skills development and operate for priority sectors."
According to di official gazette, companies and business go first show interest to dey part of di scheme, and na di Home Affairs get di 'rights to grant or refuse membership status of any company.'
"Department of Home Affairs go make di final selection, and di applicants go dey advised of di outcome."
Companies wey Home Affairs approve for di scheme go come enta Memorandum of Agreement wit di department.
To get points to fit qualify to employ, di companies go make sure say "at least 60 per cent of di staff complement na South African citizens or Permanent Residents holders."
Di Department of Home Affairs for South Africa don invite corporate employers make dem begin show interest for di scheme.
For publication wey Home Affairs publish for dia website dem tok say dis program no be for pipo wey no dey employed or for pipo wey no get skill or for pipo wey dey do low wage labour.
According to di documen wey di Minister L.A. Schreiber sign, e say dem go expand di second phase of di (TES) wey go include infrastructural projects and companies wey dey maintain and manage Global Head Office or Regional Head Office for South Africa for dia operations.
"Di overarching objective of TES Phase II isuna to suport di govment efforts to
position South Africa as di ogbonge investment destination for Africa.
South Africa govment say sake of say di first phase succeed well-well, na why dem wan start di second phase.
How di employer scheme work?
To qualify for membership for di Trusted Employer Scheme, di employer, investor, or business needs to show say dem get financial strength.
Dem go also show say dem fit employ foreign national, and dem go also show say dem dey run training programmes for South African citizens.
Di pesin go also prove say im be good corporate citizen.
According to di document , di employer, investor oda businesses wey dey inside dis program go qualify for priority processing of dia visa applications sake of say dia requirements and supporting documents don reduce.
South Africa dey face unemployment challenges and di citizens dey blame foreigners say na dem dey collect dia jobs.
Dis challenge lead to mass protests for di kontri recently wia President Ramaphosa bin promise to find solution to dis major challenge and dis Trusted Employer Scheme fit be one of di ways.









