South Africa dey consider to reduce fuel price sake of Iran war, official tok

Wia dis foto come from, Per-Anders Pettersson/Getty Images
South Africa Finance Minister Enoch Godongwana dey consider to reduce di fuel price to lessen di impact of di Iran war on domestic fuel prices, one senior govment official tell Reuters.
Godongwana go announce im decision on Tuesday, di official tok, and ask say make dem no mention im name sake of di sensitivity of di mata.
South Africa dey adjust fuel prices monthly and dey use formula wey dey factor in movements in global crude oil prices, di exchange rate and local taxes such as di fuel levy.
Price changes dey take effect on di first Wednesday of evri month, but di govment neva announce di new prices wey go take effect on Wednesday, April 1.
Witout govment intervention, domestic prices dey expected to jump sake of di U.S.-Israeli war against Iran, wey don drive up global energy prices.
South African trade unions, business lobby groups and political parties don urge di govment to lower di fuel levy to shield households from big fuel price hikes.
We dey update dis tori







