'No go close to di Strait of Hormuz' - Iran announce afta deal wit US and Israeli hit Lebanon

Wia dis foto come from, AMIRHOSSEIN KHORGOOEI / ISNA / AFP via Getty Images
Iran military say dem dey close di Strait of Hormuz sake of di Israeli strikes for Lebanon.
Dis dey come afta President Donald Trump sign di US-Iran deal wey go see to di ceasefire and opening of di oil route and oda agreements.
Iran accuse US and Israel say dem violate di ceasefire deal.
Iran Revolutionary Guard Corps Navy say di Strait of Hormuz dey closed to all vessels, sake of di US and Israel ceasefire violations.
Di Navy come issue strict warning to all vessels make dem no near di Strait of Hormuz.
"No approach di Strait of Hormuz; odawise, your security go dey in danger."
Iran blame di reclosing of di Strait of Hormuz, on "America blatant breach of promise" on di deal to bring about end to di war.
Dem reference di first paragraph of di 14-point deal, wey declare "immediate and permanent termination of military operations on all fronts, including for Lebanon".
But now, Iran say dem don close di Strait of Hormuz afta reports say about two dozen pipo killed by Israeli strikes for southern Lebanon.
Dat strike come less dan 24 hours afta dem announce di new ceasefire between Israel and Hezbollah.
Di US-Iran agreement bin intend to reopen di Strait of Hormuz, wey dem close since February.
Dem say di waterway go reopen following di signing of di deal on Friday, as full operations dey expected within 30 days as dem dey clear technical and security obstacles.
As Iran dey make dia announcement, di US Central Command (Centcom) also say commercial ship traffic for di Strait of Hormuz increase today and say 55 merchant ships pass through.
"Commercial ship traffic for di Strait of Hormuz increase on June 20 as US forces kontinue to dy operate for di general area to support freedom of navigation," na wetin di US command tok.
Na afta plenty weeks of tok-tok, US and Iran later sign di initial agreement wey go extend di ceasefire between di two kontris, and di agreement take effect.
For Wednesday, Senior US officials bin read out di 14-paragraph memorandum of understanding to tori pipo.
US President Trump and Iran President Masoud Pezeshkian sign di agreement ahead of schedule.
Na on Friday dem for formally sign di agreement for Switzerland.
Di deal suppose make way for dem to reach "final deal" within "maximum of 60 days, wey dem still fit extend wit mutual consent."
Trump formally sign di deal, wey including di reopening of di Strait of Hormuz.
For inside di 14-point agreement, wey dey known as Memorandum of Understanding, di commitments go begin wit lifting di US naval blockade, restore shipping through di Strait of Hormuz, and negotiate di lifting of "all types of sanctions" on Iran.
Di document also outline plans for one fund of at least $300bn (£224bn) for Iran reconstruction and economic development, plus one renewed pledge from Tehran say dem no go develop nuclear weapon.
But di closing of di Hormuz don rewake di war say e go kontinu.
Di Israeli military say dem strike "dozens" of Hezbollah targets afta di group fire more dan 50 projectiles for Israeli forces for di region.
Meanwhile, di Israel Defense Forces (IDF) and Hezbollah don accuse each oda today of repeated ceasefire violations.








