You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu confam early-stage prostate cancer and don get treatment
- Author, Amy Walker
- Read am in 3 mins
Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu say im dey "in excellent physical condition" afta di publication of im annual medical report reveal say e remove one malignant tumour.
For inside one post on X on Friday, Netanyahu tok say during routine medical monitoring afta successful surgery for enlarged benign prostate, doctors discova early-stage malignant tumour.
Treatment bin "remove di problem and no leave any trace of am", e add.
Netanyahu say im bin ask dem to delay publication of im health record so e no go dey released at di height of di US and Israel war wit Iran, to stop Tehran from spreading "even more false propaganda against Israel".
Di 76 year-old Israeli leader say im bin don do one initial surgery for enlarged benign prostate for 2024 and im dey under routine medical monitoring. "Dem discova one tiny spot of less dan one centimetre" during di most recent check up.
"I get minor medical issue wit my prostate wey dem don completely treat. Tank God, e don pass," e tok.
For di lengthy post, Netanyahu also say im bin choose to undergo treatment becos "wen dem give me information in time about a potential danger, I like to address am immediately".
E add say: "Dis na true on di national level and also on di personal level".
Di revelation dey come as Netanyahu dey expected to visit di White House for di coming weeks as di US dey try broker one long lasting peace deal for di war wit Iran.
Israel ceasefire agreement wit Lebanon, following fighting between Israel and Iran-backed Hezbollah, don also dey extended by three weeks.