Why UK lift threat level from 'substantial' to 'severe' for di first time in four years

Wia dis foto come from, EPA
UK threat level don move from "substantial" to "severe" on Thursday for di first time in more dan four years, security minister Dan Jarvis tok.
Dis dey come afta di stabbing of two Jewish men for Golders Green, north London, on Wednesday.
Oga Jarvis say di increase to di threat level no be only becos of di attack, but also sake of threats from di broader Islamist and extreme right-wing.
E say make kontri pipo dey "alert and vigilant" but make dem no "worry"
Di stabbings wey di Metropolitan Police don declare as terror, na di latest for di different incidents wey dey target UK Jewish community.
Wetin be dis 'severe' level of threat and wetin e mean for citizens
Di "severe" threat level mean say e dey sure say di terrorist attack fit occur again in di next six months.
Jarvis reassure di public say intelligence services, di police and govment dey "work round di clock to keep di public safe".
Home Secretary Shabana Mahmood explain say raising di threat level "go be source of concern to many, particularly amongst our Jewish community, wey don suffer too much".
End of Di one wey oda users dey read well well
But she insist say govment "go do evritin in our power to free di society of di evil of antisemitism
"As di threat level rises, I encourage everyone to dey vigilant, as dem go about dia daily lives, and report any concerns dem get to di police," Mahmood add.
Di head of Met counter-terrorism unit tell tori pipo afta authorities raise di threat level say UK don dey "experience gradual terrorist threat for some time".
Assistant Commissioner Laurence Taylor say: "Our casework dey increase across a number of ideologies, and within that, we dey see elevated threat to Jewish and Israeli individuals and institutions for UK.
"Also, we dey work against one unpredictable global situation wey get consequences closer to home, including physical threats by state linked actors."
Taylor say police go review "all events across di kontri".
Na security and intelligent experts from di Joint Terrorism Analysis Centre (JTAC) and independently of ministers, take di decision to raise di threat level to di second-highest threat level, di govment tok.
Di last time wey UK dey "severe" terrorism threat level na for November 2021, afta one bomb blast outside Liverpool Women Hospital and afta di murder of MP Sir David Amess for October 2021.
Govment lower am to "substantial" for February 2022.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Level of threats for di UK
Na five terror threat levels dey for UK:
- Critical: an attack is highly likely in di near future
- Severe: an attack is highly likely
- Substantial: an attack is likely
- Moderate: an attack is possible, but not likely
- Low: an attack is highly unlikely
Meanwhile, London Mayor Sir Sadiq Khan tok say extra police go dey for di streets of di capital - including armed officers.
"I wan reassure all Londoners and visitors say we dey do everything possible to protect our city and keep all of our communities safe," e tok.
Di raised level also dey come against a backdrop of "increased state-linked physical threats wey dey encourage acts of violence, including against di Jewish community", di govment add.
Some of di prior incidents don dey linked to groups wey get ties to foreign regimes. Police neva made dat kain links wit Wednesday attack.
Met Police Commissioner Sir Mark Rowley tok about rise in "racist and antisemitic hate crime" as e dey tok for di Golders Green on Wednesday.
E say police know say foreign organisations and hostile states dey encourage or pay some pipo to commit acts of violence - although, e no fit comment on any live investigations.
What to know about di stabbing

Wia dis foto come from, SWNS
45-year-old Essa Suleiman wey dey charged wit attempted murder afta two Jewish men dey stabbed for Golders Green, north London on Wednesday, 28 Aprol don appear for court.
Essa Suleiman dey accused of attacking 34-year-old Shloime Rand and Moshe Shine, 76.
Di two men suffer serious injuries ake of di stabbings and dem dey receive treatment for hospital.
Suleiman also chop accuse say e attempt to murder Ishmail Hussein for one knife attack for Hussein flat for Southwark, south London, di same day. Hussein na pesin wey Suleiman son sabi for for approximately 20 years.
E also dey face anoda charge say e hold knife for public place for Golders Green.
Suleiman bin appear for di dock on Friday, e wear one police-issued grey sweatshirt and trousers. E be like say e get bruising around im eyes.
E confam im name and date of birth, but no enta any pleas.
Prosecutor Emma Harraway tell di court say Suleiman get medical episode wen dem arrest am and dem later carry am go hospital. Dem treat and discharge am some hours later and send am to Hammersmith custody suite.
Di court also hear say one of di victims of Wednesday attack, Shloime Rand don dey discharged from hospital.
Suleiman na patient for di South London and Maudsley NHS Foundation Trust.
Dem born am for Somalia, but e enta UK lawfully wen e be small pikin for di early 1990s and now be British citizen, officials tok.
Officials say dem don send im case go di Old Bailey wia e go appear next on 15 May for preliminary hearing. E go remain in custody.














