Nigeria publish list of suspected sponsors of terrorism

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria govment don release one list wey contain di names of 48 pipo and 12 entities dem label alleged sponsors of terrorism for di kontri.
Di list wey dem publish on Friday, 10 April provide only small detail about di pipo dem mention dia names.
Di Nigeria Sanctions Committee (NSC) no specify dia nationalities, levels of involvement, or di groups dem belong to. Oda ogbonge informate like foto to identify dem plus dia gender no also dey.

Wia dis foto come from, Getty Images
Bifor now, Nigeria don issue sanctions lists through dia national sanctions committee, most times dey in line wit United Nations Security Council measures, wey include asset freezes and travel restrictions.
Di kontri bin establish one national sanctions body under dia 2022 terrorism law to enforce UN measures.
Di committee apply targeted financial sanctions wey dey aimed at cutting off funding to individuals and organisations wey dey linked to terrorism and weapons proliferation.
These measures dey binding on all individuals and institutions wey dey within Nigeria.
Dis publication dey come as authorities begin prosecute more dan 500 suspects dis week, inside one of di kontri largest terrorism trials.
So far, 386 pipo don dey convicted of terrorism for di proceedings. Dos wey dey on trial dey face charges wey relate to aiding and abetting militant activity, particularly for di north-east, wia one insurgency by Boko Haram bin start ova 10 years ago.
Since den, violence don spread beyond di region, as multiple armed groups dey carry out attacks and kidnap gangs wey dey known as bandits dey kidnap many for ransom across parts of di kontri.
Di govment bin recently label bandit groups as terrorist organisations and expand di scope of dia counter-terrorism strategy.
Despite di scale of violent attacks, prosecutions dey rare. Dem dey hold suspects for detention for long periods without trial, wey don raise concerns about accountability and due process.
Groups like Boko Haram, Islamic State West Africa Province (Iswap) and Jama'at Nusrat al-Islam wal-Muslimin (JNIM) wey dey operate across parts of di region, don further complicate efforts to restore stability.
In recent months, violence don spread beyond traditional hotspots as di kontri dey make effort to tackle growing unrest.
Di United States Department of State dis week bin warn dia citizens to reconsider travel to Nigeria, dem cite risks wey include terrorism, kidnapping and civil unrest.
Di Nigeria Sanctions Committee (NSC) for di list wey dem publish give little informate about di alleged suspects wey include who dem be and dia role for di terrorism.
One of di suspects na senior commander (Quaid) of di Islamic State of West Africa Province (ISWAP) Okene.
E be di suspected attacker of di St. Francis Catholic Church Owo, Ondo State on 5th June 2022 plus di Kuje Correctional Center, Abuja on 5th July 2022.
Anoda suspect na member of di terrorist group Ansarul Muslimina Fi Biladissudam (ANSARU), di group dey associated wit Al-Qaeda for di Islamic Maghreb (AQIM).
NSC say di suspect dey trained and e serve under Muktar Belmokhtar aka One Eyed. "E specialise for designing terrorist clandestine communication code and e also dey Improvised Explosive Device (IED) expert.
E also be gate keeper to ANSARU leader, Mohammed Usman aka Khalid Al-Bamawi. Also, e be courier and travel guide to AQIM Katibat for di desert of Algeria and Mali.
E also dey into carpentry. Subject escape from Kuje correctional center on di 5th July 2022. Currently, e dey at large".
Anoda suspect na top ISWAP member. E be part of di founders of ISWAP cell for Southwest Geopolitical zone. E dey source and coordinates dia finances through crypto currency, dating and tax/covid19 palliative scams for di USA.
One of di suspect wey dem mention na dey collect money from ISWAP and she dey use di money pay wives of ISWAP sojas.
Some of di suspects na members of Boko Haram Terrorist group, terrorism financing, received training and rendering support to di terrorist group.
For di list, members of di BRGIE local chapter from "Odumegu State Defactor" and Urhobo Isoko State Defacto" based in Anambra State and Delta State respectively, bin use di account number of some of di suspects to contribute to di group.








