List of kontris wey don qualify for 2026 Fifa World Cup

World Cup trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di 2026 World Cup go take place for Canada, Mexico and di United States from 11 June to 19 July
Read am in 4 mins

DR Congo don qualify for di 2026 Fifa World Cup. Dem qualify on Tuesday afta dem beat Jamaica 1-0 for di 2026 World Cup intercontinental play-offs.

Di West African nation qualify for di World Cup for di first time since 1974 wen dem compete as Zaire.

Rememba say DR Congo bin beat Nigeria to extend dia bid to reach di 2026 Fifa World Cup afta for di African playoff final.

Jamaica beat New Caledonia for di semi-finals of di play-offs wey dem play for Thursday, 26 March 2026.

DR Congo qualification don complete di African slots for di 2026 World Cup.

Teams wey don already qualify for 2026 World Cup

Four Italy players wear dia all-white national jersey as dem express sadness over dia World Cup miss.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Italy suffer anoda World Cup play-off defeat

Bosnia-Herzegovina do four-time world champions Italy strong tin as dem knack dem apako for di play-offs.

Bosnia-Herzegovina hold Italy to 1-1 afta extra time, dem gatz play penalties were Bosnia-Herzegovina beat dem 4-1 to end di dreams of Italy to qualify for di 2026 World Cup.

Dis na di third time Italy dey fail to qualify for World Cup back to back.

No previous winner of di tournament don miss three of di tournaments back to back.

Italy no qualify for Russia 2018, dem miss Qatar 2022 and now dem go also miss di 2026 edition wey Mexico, Canada and US go host.

Pio Esposito - fire im penalty shot over di post - and Bryan Cristante - hit di underside of di crossbar for di shootout afta Gennaro Gattuso 10 men nearly kpai for di hands Bosnian hand.

Dis na just di second World Cup wey for dia history wey Bosnia-Herzegovina - and 40-year-old captain Edin Dzeko dey qualify for.

Gennaro Gattuso wey bItaly coach bin dey cry as e say "di future no dey important important" afta di head of di Italian Football Federation (FIGC) Gabriele Gravina told reporters say im don tell Gattuso to remain as dia coach.

Gattuso say: "E dey pain me well-well becos we need am for us, for all of Italy and for our movement. Dis blow dey difficult to digest.

"I for fit give up years of my life, money, for us to achieve our goal."

Oda suprises on Tuesday night na Iraq wey become di 48th and final team to qualify for the World Cup.

Dem beat Bolivia 2-1 for di intercontinental playoff for Mexico to seal dia first appearance at di finals in 40 years.

Iraq, wey no even prepare well sake of di war for di Middle East, go play for Group I against France, Senegal and Norway.

Czech Republic alos qualify for di World cup afta dem beat Denmark for di playoff.

Rasmus Hojlund, Anders Dreyer and Mathias Jensen miss dia penalty kicks for Denmark afta dem play 2-2 for extra time.

Sweden also qualify afta Arsenal man Viktor Gyokeres score for di 88th-minute winner as Sweden beat Poland 3-2 .

Di result give Sweden dia first World Cup appearance since 2018 afta dem fail to qualify four years ago.

Argentina team lift di World Cup

Wia dis foto come from, Julian Finney/Getty Images

Na 48 teams go compete for dis World Cup tournament wey go kick-off on Thursday 11 June 2026, Joint-hosts Canada, Mexico and di United States get automatic qualification.

Australia, Iran, Japan, Jordan, Qatar, Saudi Arabia, South Korea and Uzbekistan na di first kontris to qualify from Asia.

Oceania get one direct qualification spot and New Zealand take am.

Tunisia and Morocco na di first two African sides wey go through to di World Cup, and Algeria, Cape Verde, Egypt, Ghana, Ivory Coast, Senegal and South Africa join dem later

Brazil, Ecuador, Uruguay, Paraguay and Colombia na di oda South American nations wey guarantee dia place.

World Cup teams according to groups

Group A

Mexico

South Africa

Korea Republic

Czech Republic

Group B

Canada

Bosnia-Herzegovia

Qatar

Switzerland

Group C

Brazil

Morocco

Haiti

Scotland

Group D

United States

Paraguay

Australia

Turkey

Group E

Germany

Curacao

Ivory Coast

Ecuador

Group F

Netherlands

Japan

Sweden

Tunisia

Group G

Belgium

Egypt

Iran

New Zealand

Group H

Spain

Cape Verde

Saudi Arabia

Uruguay

Group I

France

Senegal

Iraq

Norway

Group J

Argentina

Algeria

Austria

Jordan

Group K

Portugal

DR Congo

Uzbekistan

Colombia

Group L

England

Croatia

Ghana

Panama